Josué 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Naw, dem lock and dey guide Jeriko gate, so dat Israel pipol don go fit attack am. Dem nor gri make anybody enter inside or go outside.
1 Ora Jericó estava rigorosamente fechada por causa dos filhos de Israel; ninguém saía nem entrava.
2 God kon tell Joshua, “Si, I won distroy Jeriko for una, plus di king and en sojas.
2 Então disse o Senhor a Josué: Olha, tenho dado na tua mão a Jericó, ao seu rei e aos seus homens valorosos.
3 Make una sojas mash round di town ones and make una do like dat for six days.
3 Vós, pois, todos os homens de guerra, rodeareis a cidade, cercando-a uma vez; assim fareis por seis dias.
4 Make yu tell seven priests make dem karry seven ram horn for di box front, den for di sevent day, make una mash round di town seven times, while di priests go dey blow di trumpet.
4 E sete sacerdotes levarão sete buzinas de chifres de carneiros adiante da arca, e no sétimo dia rodeareis a cidade sete vezes, e os sacerdotes tocarão as buzinas.
5 Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shaut for war and di town wall go fall rish groun, den una go attack am.”
5 E será que, tocando-se prolongadamente a buzina de carneiro, ouvindo vós o seu sonido, todo o povo gritará com grande brado; e o muro da cidade cairá abaixo, e o povo subirá por ele, cada um em frente.
6 So Joshua wey bi Nun pikin kon koll and tell di priests, “Make una karry di Kovenant Box and seven priests must karry seven ram horn for di Kovenant Box front.”
6 Então Josué, filho de Num, chamou aos sacerdotes e disse-lhes: Levai a arca da aliança; e sete sacerdotes levem sete buzinas de chifres de carneiros, adiante da arca do Senhor.
7 So e tell di sojas, “Make una waka for front kon mash round di town, while many sojas go dey waka for di Kovenant Box front.”
7 E disse ao povo: Passai e rodeai a cidade; e quem estiver armado, passe adiante da arca do Senhor.
8 Wen Joshua orda en sojas, di seven priests karry di ram horn for God present for front kon bigin blow di horn as God Kovenant Box dey follow dem for back.
8 E assim foi que, como Josué dissera ao povo, os sete sacerdotes, levando as sete buzinas de carneiros diante do Senhor, passaram e tocaram as buzinas; e a arca da aliança do Senhor os seguia.
9 Many sojas dey mash for front of di priests wey dey blow di horn, while di oda guards dey mash follow di box for back dey blow ram horn too.
9 E os homens armados iam adiante dos sacerdotes, que tocavam as buzinas; e a retaguarda seguia após a arca; andando e tocando as buzinas iam os sacerdotes.
10 Naw, Joshua tell di sojas, “Make una nor shaut or make nois; make una nor tok anytin until di day wey I go tell una sey make una shaut or make nois!”
10 Porém ao povo Josué tinha dado ordem, dizendo: Não gritareis, nem fareis ouvir a vossa voz, nem sairá palavra alguma da vossa boca até ao dia que eu vos diga: Gritai. Então gritareis.
11 So Joshua make sure sey dem karry di Kovenant Box round di town only ones a day. Den dem go back go sleep for dia kamp.
11 E fez a arca do Senhor rodear a cidade, contornando-a uma vez; e entraram no arraial, e ali passaram a noite.
12 For early morning di next day, Joshua and di priests karry di Kovenant Box.
12 Depois Josué se levantou de madrugada, e os sacerdotes levaram a arca do Senhor.
13 Di seven priests wey karry di seven ram horn for di Kovenant Box front, mash dey blow di horn round di town. Many sojas dey mash for dia front, while di oda guide dey follow for back and dem dey blow dia horn too.
13 E os sete sacerdotes, que levavam as sete buzinas de chifres de carneiros, adiante da arca do Senhor, iam andando, e tocavam as buzinas, e os homens armados iam adiante deles e a retaguarda seguia atrás da arca do Senhor; os sacerdotes iam andando e tocando as buzinas.
14 Dem mash round di town ones for di sekond day, den dem go back to dia kamp. Dem do like dis for six days.
14 Assim rodearam outra vez a cidade no segundo dia e voltaram para o arraial; e assim fizeram seis dias.
15 For di sevent day, dem wake-up for early morning kon mash round di town as before, but dis time, dem mash round am seven times.
15 E sucedeu que, ao sétimo dia, madrugaram ao subir da alva, e da mesma maneira rodearam a cidade sete vezes; naquele dia somente rodearam a cidade sete vezes.
16 Wen di sevent time rish, di priests kon blow di ram horn and Joshua kon tell di sojas, “Make una shaut for war, bikos God go give dis town to una!
16 E sucedeu que, tocando os sacerdotes pela sétima vez as buzinas, disse Josué ao povo: Gritai, porque o Senhor vos tem dado a cidade.
17 Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town.
17 Porém a cidade será anátema ao Senhor, ela e tudo quanto houver nela; somente a prostituta Raabe viverá; ela e todos os que com ela estiverem em casa; porquanto escondeu os mensageiros que enviamos.
18 But make una take kare wen una dey keep di tins wey bi God own. If una take any of dem, una go kause wahala for awa kamp and awa pipol.
18 Tão-somente guardai-vos do anátema, para que não toqueis nem tomeis alguma coisa dele, e assim façais maldito o arraial de Israel, e o perturbeis.
19 All di gold and silva, plus di bronze and all di iron tins, na God get dem. All of dem must go God store house.”
19 Porém toda a prata, e o ouro, e os vasos de metal, e de ferro são consagrados ao Senhor; irão ao tesouro do Senhor.
20 Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shaut well-well for war. Di town wall fall rish groun and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipol.
20 Gritou, pois, o povo, tocando os sacerdotes as buzinas; e sucedeu que, ouvindo o povo o sonido da buzina, gritou o povo com grande brado; e o muro caiu abaixo, e o povo subiu à cidade, cada um em frente de si, e tomaram a cidade.
21 Dem use dia swod take kill evritin wey dey breath for di town, both man and woman, small pikin and old pipol, plus all di animals.
21 E tudo quanto havia na cidade destruíram totalmente ao fio da espada, desde o homem até à mulher, desde o menino até ao velho, e até ao boi e gado miúdo, e ao jumento.
22 Joshua kon tell di two men wey kon spy di land before sey, “Make una go di ashawo house den bring en and evribody wey dey di house kom out, just as una promise am.”
22 Josué, porém, disse aos dois homens que tinham espiado a terra: Entrai na casa da mulher prostituta, e tirai-a de lá com tudo quanto tiver, como lhe tendes jurado.
23 So di men go bring Rahab, en papa, mama, brodas and evribody wey dey en house. Dem bring all en family kom out kon take dem go one place wey dey outside Israel pipol kamp.
23 Então entraram os jovens espias, e tiraram a Raabe e a seu pai, e a sua mãe, e a seus irmãos, e a tudo quanto tinha; tiraram também a toda a sua parentela, e os puseram fora do arraial de Israel.
24 But dem burn di town and evritin wey dey inside, esept di gold, silva, bronze and di iron tins wey dem karry go God store house.
24 Porém a cidade e tudo quanto havia nela queimaram a fogo; tão-somente a prata, e o ouro, e os vasos de metal e de ferro, deram para o tesouro da casa do Senhor.
25 But Joshua nor kill Rahab wey bi ashawo, en family and evritin wey bilong to am. Rahab kon stay for Israel, bikos e hide di pipol wey Joshua send go spy Jeriko.
25 Assim deu Josué vida à prostituta Raabe e à família de seu pai, e a tudo quanto tinha; e habitou no meio de Israel até ao dia de hoje; porquanto escondera os mensageiros que Josué tinha enviado a espiar a Jericó.
26 For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am.
26 E naquele tempo Josué os esconjurou, dizendo: Maldito diante do Senhor seja o homem que se levantar e reedificar esta cidade de Jericó; sobre seu primogênito a fundará, e sobre o seu filho mais novo lhe porá as portas.
27 God dey with Joshua and pipol kon know am for evriwhere.
27 Assim era o Senhor com Josué; e corria a sua fama por toda a terra.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.