Josué 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen dem don cross finish, God kon tell Joshua,
1 Quando toda a nação terminou de atravessar o Jordão, o Senhor disse a Josué:
2 “Selet twelf men from di pipol, one from each tribe.
2 "Escolha doze homens dentre o povo, um de cada tribo,
3 Den yu go tell dem sey, ‘Make una pick twelf stones from Jordan River centre, di very place where di priests stand put.’ Den, dem go karry di stones follow yu and yu go put am for di place where una go stay dis nite.”
3 e mande que apanhem doze pedras do meio do Jordão, do lugar onde os sacerdotes ficaram parados. Levem-nas com vocês para o local onde forem passar a noite".
4 Joshua koll di twelf men wey e choose from each tribe
4 Josué convocou os doze homens que escolhera dentre os israelitas, um de cada tribo,
5 kon tell dem, “Make una go for di Oga una God box front wey dey Jordan River centre. Each of una go put one stone for shoulder akordin to di tribes for Israel.
5 e lhes disse: "Passem adiante da arca do Senhor, o seu Deus, até o meio do Jordão. Ponha cada um de vocês uma pedra nos ombros, conforme o número das tribos dos israelitas.
6 Di stones go make una dey remember dis tin wey happen and wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin make dis stones dey important to una?’
6 Elas servirão de sinal para vocês. No futuro, quando os seus filhos lhes perguntarem: ‘Que significam essas pedras? ’,
7 den make una tell dem how Jordan River take stop to rush, bikos of God Kovenant Box. Wen di box cross Jordan River, di wota stop to rush. Dis stones go make Israel pipol dey always remember wetin happen.”
7 respondam que as águas do Jordão foram interrompidas diante da arca da aliança do Senhor. Quando a arca atravessou o Jordão, as águas foram interrompidas. Essas pedras serão um memorial perpétuo para o povo de Israel".
8 So, Israel pipol do wetin Joshua tell dem. Dem pick twelf stones from di river centre, akordin to di tribes for Israel, just as God kommand Joshua. Dem karry dem go di kamp kon put am for der.
8 Os israelitas fizeram como Josué lhes havia ordenado. Apanharam doze pedras do meio do Jordão, conforme o número das tribos de Israel, como o Senhor tinha ordenado a Josué; e as levaram ao acampamento, onde as deixaram.
9 For di river centre where di priests wey karry di Kovenant Box stand put, Joshua kon put twelf stones for der. Di stones still dey der still today.
9 Josué ergueu também doze pedras no meio do Jordão, no local onde os sacerdotes que carregavam a arca da aliança tinham ficado. E elas estão lá até hoje.
10 Naw, di priests wey karry di Kovenant Box stand for Jordan River centre until di pipol do evritin wey God kommand, just as Moses tell Joshua. Di pipol cross kwik-kwik
10 Os sacerdotes que carregavam a arca permaneceram de pé no meio do Jordão até que o povo fez tudo o que o Senhor ordenara a Josué, por meio de Moisés. E o povo atravessou apressadamente.
11 and wen di pipol don cross finish, di Kovenant Box and di priest kon cross too.
11 Quando todos tinham acabado de atravessar, a arca do Senhor e os sacerdotes passaram para o outro lado, diante do povo.
12 Na Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe first cross, bikos na dem go first attack for war, just as Moses kommand.
12 Os homens das tribos de Rúben, de Gade e da metade da tribo de Manassés atravessaram preparados para lutar, à frente dos israelitas, como Moisés os tinha orientado.
13 E rish 40,000 strong sojas wey mash dey go fight for Jeriko field and God dey with dem.
13 Cerca de quarenta mil homens preparados para a guerra passaram perante o Senhor, rumo à planície de Jericó.
14 Dat day, God give Joshua honor for Israel pipol front. Dem respet am till e die, just as dem bin respet Moses.
14 Naquele dia o Senhor exaltou Josué à vista de todo o Israel; e eles o respeitaram enquanto viveu, como tinham respeitado Moisés.
15 God kon tell Joshua,
15 Então o Senhor disse a Josué:
16 “Make yu tell di priests wey karry di Kovenant Box make dem komot from Jordan River.”
16 "Ordene aos sacerdotes que carregam a arca da aliança que saiam do Jordão".
17 So Joshua tell di priests, “Make una kom out from Jordan!”
17 E Josué lhes ordenou que saíssem.
18 Di priests wey karry di Kovenant Box kon komot from di river centre and as dem just enter dry land, di wota for Jordan kon start to rush well-well again.
18 Quando os sacerdotes que carregavam a arca da aliança do Senhor saíram do Jordão, mal tinham posto os pés em terra seca, as águas do Jordão voltaram ao seu lugar, e cobriram como antes as suas margens.
19 Di pipol cross Jordan River for di tent day for di first mont kon stay for Gilgal wey dey di east side for Jeriko borda.
19 No décimo dia do primeiro mês o povo subiu do Jordão e acampou em Gilgal, na fronteira leste de Jericó.
20 Di twelf stones wey Joshua take from Jordan River, e arrange dem for one place for Gilgal.
20 E em Gilgal Josué ergueu as doze pedras tiradas do Jordão.
21 Joshua tell Israel pipol, “Wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin dis stones mean?’
21 Disse ele aos israelitas: "No futuro, quando os filhos perguntarem aos seus pais: ‘Que significam essas pedras? ’,
22 Make una tell dem, ‘Na wen Israel pipol cross Jordan River for dry groun.’
22 expliquem a eles: Aqui Israel atravessou o Jordão em terra seca.
23 Di Oga una God dry Jordan River for una and una waka pass, just as E dry di Red Sea make wi waka pass.
23 Pois o Senhor, o seu Deus, secou o Jordão perante vocês até que o tivessem atravessado. O Senhor, o seu Deus, fez com o Jordão como fizera com o mar Vermelho, quando o secou diante de nós até que o tivéssemos atravessado.
24 E do am make all di kountry for eart know sey na God get all di pawa, so una must always obey di Oga wey bi una God.”
24 Ele assim fez para que todos os povos da terra saibam que a mão do Senhor é poderosa e para que vocês sempre temam o Senhor, o seu Deus".

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.