Josué 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 As sun dey shine di next morning, Joshua and Israel pipol komot from Shittim go Jordan River. Dem stay der before dem cross di river.
1 De manhã bem cedo Josué e todos os israelitas partiram de Sitim e foram para o Jordão, onde acamparam antes de atravessar o rio.
2 Afta three days, di leaders bigin waka round di kamp
2 Três dias depois, os oficiais percorreram o acampamento,
3 kon kommand di pipol sey: “Wen una si Levi priest karry una Oga God box wey di kovenant dey inside, una must follow dem for back.
3 e deram esta ordem ao povo: "Quando virem a arca da aliança do Senhor, o seu Deus, e os sacerdotes levitas carregando a arca, saiam das suas posições e sigam-na.
4 But una go give dem gap wey rish 3,000 fit. Make una dey wosh, so dat una nor go dey klose to di Kovenant Box. Na dem go show una road, bikos una neva travel pass der before.”
4 Mas mantenham a distância de cerca de novecentos metros entre vocês e a arca; não se aproximem! Desse modo saberão que caminho seguir, pois vocês nunca passaram por lá".
5 Joshua tell di pipol, “Make una go klean unasef, bikos for dis time tumoro, God go do strong mirakle among una.”
5 Josué ordenou ao povo: "Santifiquem-se, pois amanhã o Senhor fará maravilhas entre vocês".
6 Joshua tell di priest, “Make una karry di Kovenant Box dey go for di pipol front.” So dem karry di Kovenant Box kon dey go for di pipol front.
6 E disse aos sacerdotes: "Levantem a arca da aliança e passem à frente do povo". Eles a levantaram e foram na frente.
7 God tell Joshua, “From today go, I go start to honor yu among Israel pipol, so dat dem go know sey I dey with yu, just as I dey with Moses.
7 E o Senhor disse a Josué: "Hoje começarei a exaltá-lo à vista de todo o Israel, para que saibam que estarei com você como estive com Moisés.
8 Tell di priests sey make dem karry di Kovenant Box and wen dem don rish di wotaside for Jordan River, make dem waka enter di wota small.”
8 Portanto, você é quem dará a seguinte ordem aos sacerdotes que carregam a arca da aliança: ‘Quando chegarem às margens das águas do Jordão, parem junto ao rio’ ".
9 Joshua tell Israel pipol, “Make una listin to wetin di Oga una God dey tok!”
9 Então Josué disse aos israelitas: "Venham ouvir as palavras do Senhor, o seu Deus.
10 Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una.
10 Assim saberão que o Deus vivo está no meio de vocês e que certamente expulsará de diante de vocês os cananeus, os hititas, os heveus, os ferezeus, os girgaseus, os amorreus e os jebuseus.
11 Si! Di Kovenant Box wey bi di Oga God for di whole eart own, don dey ready to enter Jordan River before una.
11 Vejam, a arca da aliança do Soberano de toda a terra atravessará o Jordão à frente de vocês.
12 Naw, make una choose twelf men from di tribes for Israel, one pesin from each tribe.
12 Agora, escolham doze israelitas, um de cada tribo.
13 Di priests wey karry God wey dey rule di whole world Kovenant Box, as dia leg tosh di wota for Jordan River, dat place go divide for una.”
13 Quando os sacerdotes que carregam a arca do Senhor, o Soberano de toda a terra, puserem os pés no Jordão, a correnteza será represada e as águas formarão uma muralha".
14 So di pipol leave dia kamp kon waka dey go cross di river and di priests wey karry di Kovenant Box dey waka for dia front.
14 Quando, pois, o povo desmontou o acampamento para atravessar o Jordão, os sacerdotes que carregavam a arca da aliança foram adiante.
15 Wen doz wey karry di Kovenant Box rish di river kon enter di wota (Jordan River dey rush well-well, bikos na harvest time dem dey),
15 ( O Jordão transborda em ambas as margens na época da colheita. ) Assim que os sacerdotes que carregavam a arca da aliança chegaram ao Jordão e seus pés tocaram as águas,
16 di wota wey dey rush, just stop. E gada go up for one town wey dem dey koll Adam (Adam dey near Zaretan) and no wota rush kom from der again go rish Arabah Sea (Di Salt Sea). Di pipol cross di river wey face Jeriko.
16 a correnteza que descia parou de correr e formou uma muralha a grande distância, perto de uma cidade chamada Adã, nas proximidades de Zaretã; e as águas que desciam para o mar da Arabá, o mar Salgado, escoaram totalmente. E assim o povo atravessou o rio em frente de Jericó.
17 For Jordan River centre, di priests wey karry di Kovenant Box, stand well for dry groun. All di pipol for Israel cross pass for dry groun until evribody for di kountry cross finish.
17 Os sacerdotes que carregavam a arca da aliança do Senhor ficaram parados em terra seca no meio do Jordão, enquanto todo o Israel passava, até que toda a nação o atravessou também em terra seca.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.