Josué 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.
1 Então Josué, filho de Num, enviou secretamente de Sitim dois espiões e lhes disse: "Vão examinar a terra, especialmente Jericó". Eles foram e entraram na casa de uma prostituta chamada Raabe, e ali passaram a noite.
2 Jeriko king hear sey some pipol from Israel don kom spy di town,
2 Todavia o rei de Jericó foi avisado: "Alguns israelitas vieram aqui esta noite para espionar a terra".
3 so e send pipol go tell Rahab sey: “Di pipol wey dey yor house won spy dis town! So make yu bring dem kom out!”
3 Diante disso, o rei de Jericó enviou esta mensagem a Raabe: "Mande embora os homens que entraram em sua casa, pois vieram espionar a terra toda".
4 But di woman hide di two men kon ansa, “Yes, dis men really kom my house, but I nor know where dem from kom.
4 Mas a mulher que tinha escondido os dois homens respondeu: "É verdade que os homens vieram a mim, mas eu não sabia de onde tinham vindo.
5 Wen time rish to klose di town gate for nite, di men kon go. I nor even know where dem dey go. Make una kwik-kwik porshu dem and una go katch dem!”
5 Ao anoitecer, na hora de fechar a porta da cidade, eles partiram. Não sei por onde foram. Corram atrás deles. Talvez os alcancem".
6 (Naw, di woman don hide dem for di roof kon put dem under di tins wey dey der.)
6 Ela, porém, os tinha levado para o terraço e os tinha escondido sob os talos de linho que havia arrumado lá.
7 Di king men kon find di men go di road where dem dey pass go Jordan River. As dem just kom out bigin porshu di men, di gateman kon lock di town gate.
7 Os perseguidores partiram atrás deles pelo caminho que vai para o lugar de passagem do Jordão. E logo que saíram, a porta foi trancada.
8 So before di two spy go sleep, Rahab klimb go meet dem for di roof
8 Antes dos espiões se deitarem, Raabe subiu ao terraço
9 kon tell dem, “I know sey God go give una dis town. Wi dey fear una well-well and evribody wey dey stay di town dey shake bikos of una.
9 e lhes disse: "Sei que o Senhor lhes deu esta terra. Vocês nos causaram um medo terrível, e todos os habitantes desta terra estão apavorados por causa de vocês.
10 Bikos wi hear as God dry di Red Sea for una wen una komot from Egypt and how una handle di two Amor kings wey bi Sihon and Og, for di oda side for Jordan River.
10 Pois temos ouvido como o Senhor secou as águas do mar Vermelho perante vocês quando saíram do Egito, e o que vocês fizeram a leste do Jordão com Seom e Ogue, os dois reis amorreus que aniquilaram.
11 Wen wi hear di news, fear katch us and wi kon dey tink sey wi go die wons wi si una. Bikos di Oga wey bi una God, na God for heaven, eart and evritin wey dey under di eart!
11 Quando soubemos disso, o povo desanimou-se completamente, e por causa de vocês todos perderam a coragem, pois o Senhor, o seu Deus, é Deus em cima nos céus e embaixo na terra.
12 So make una promise and swear with God name sey, bikos I dey good to una, una go dey good to mi and my family. Make una promise sey
12 Jurem-me pelo Senhor que, assim como eu fui bondosa com vocês, vocês também serão bondosos com a minha família. Dêem-me um sinal seguro
13 una nor go kill my papa, mama, brodas, sistas and evritin wey bi my own.”
13 de que pouparão a vida de meu pai e de minha mãe, de meus irmãos e minhas irmãs, e de tudo o que lhes pertence. Livrem-nos da morte".
14 Di men kon tell am, “Wi swear with awa life sey, nor-tin go happen to yu! If yu nor tell anybody wetin wi kon do for here and God give us dis town, wi go sorry for yu and evritin wey bi yor own.”
14 "As nossas vidas pelas de vocês! ", os homens lhe garantiram. "Se você não contar o que estamos fazendo, nós a trataremos com bondade e fidelidade quando o Senhor nos der a terra".
15 Den Rahab use rope take drop dem thru window. (Dem build Rahab house join di wall for di town and na der e dey stay.)
15 Então Raabe os ajudou a descer pela janela com uma corda, pois a casa em que morava fazia parte do muro da cidade,
16 Rahab tell dem, “Make una run go di kountry for di hill, so dat who dey porshu una nor go si una and make una stay der for three days. By dat time, pipol wey dey porshu una go don kom back, den una fit go una own.”
16 e lhes disse: "Vão para aquela montanha, para que os perseguidores não os encontrem. Escondam-se lá por três dias, até que eles voltem; depois poderão seguir o seu caminho".
17 Di men kon tell am, “Di promise wey wi promise nor go do us anytin unless sey yu do as wi sey make yu do:
17 Os homens lhe disseram: "Estaremos livres do juramento que você nos levou a fazer
18 Wen wi attack dis land, make yu tie dis red rope for di window wey yu for allow us kom down, den go pak all yor family enter yor house and evribody where dey stay yor papa house.
18 se, quando entrarmos na terra, você não tiver amarrado este cordão vermelho na janela pela qual nos ajudou a descer, e se não tiver trazido para a sua casa o seu pai e a sua mãe, os seus irmãos e toda a sua família.
19 Anybody wey kom out from yor house, na-im kill ensef bi dat, so dat one nor go bi awa fault! But if anytin happen to anybody inside yor house, den make yu blame us.
19 Qualquer pessoa que sair da casa será responsável por sua própria morte; nós seremos inocentes. Mas, seremos responsáveis pela morte de quem estiver na casa com você, caso alguém toque nessa pessoa.
20 But if yu tok wetin wi kom do for here, di swear wey wi swear, don skata bi dat.”
20 E se você contar o que estamos fazendo, estaremos livres do juramento que você nos levou a fazer".
21 Rahab kon sey, “I gri with evritin wey una tok.” E tell dem where dem go pass kon tie di red rope for di window.
21 "Seja como vocês disseram", respondeu Raabe. Assim ela os despediu, e eles partiram. Depois ela amarrou o cordão vermelho na janela.
22 Dem go di kountry for di hill kon stay der for three days and all di pipol wey dey porshu dem, kon go back. Jeriko men look evriwhere, but dem nor si dem.
22 Quando partiram, foram para a montanha e ali ficaram três dias, até que os seus perseguidores regressassem. Estes os procuraram ao longo de todo o caminho e não os acharam.
23 Den di two men kom down from di hill, cross di river go meet Joshua wey bi Nun pikin kon tell am evritin wey dem don si and know.
23 Por fim os dois homens voltaram; desceram a montanha, atravessaram o rio e chegaram a Josué, filho de Num, e lhe contaram tudo o que lhes havia acontecido.
24 Dem tell Joshua, “True-true, God don really give us di land, bikos evribody wey dey stay di land dey fear us well-well!”
24 E disseram a Josué: "Sem dúvida o Senhor entregou a terra toda em nossas mãos; todos estão apavorados por nossa causa".
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.