Josué 24

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Joshua gada Israel pipol for Shekem. E koll Israel leaders, rulers, judge and all of dem kom God present.
1 Depois Josué reuniu todas as tribos de Israel em Siquém e chamou os anciãos de Israel, os seus chefes, os seus juízes e os seus oficiais, e eles se apresentaram diante de Deus.
2 Joshua tell di pipol, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok: ‘Before-before, una grand-grand papa dey stay afta Eufrates River, plus Terah wey bi Abraham and Nahor papa. Dem woship anoda god,
2 Então Josué disse a todo o povo: — Assim diz o
3 but I take una papa Abraham cross di river kon bring am kom Kanaan land. I make en shidren-shidren many and dem nor fit kount dem; I gi-am Isaak
3 Eu, porém, trouxe Abraão, o pai de vocês, do outro lado do rio e o fiz percorrer toda a terra de Canaã. Também multipliquei a descendência dele e lhe dei Isaque.
4 and Isaak born Jakob and Esau. I give Esau, Mount Seir, while Jakob and en boys shidren go Egypt.
4 A Isaque dei Jacó e Esaú. A Esaú dei como propriedade as montanhas de Seir, mas Jacó e seus filhos desceram para o Egito.
5 “ ‘I send Moses and Aaron go Egypt kon skata Egypt rish groun wen I enter di land. Den I bring una kom out from Egypt.
5 Então enviei Moisés e Arão e castiguei o Egito com o que fiz ali; e, depois, tirei vocês de lá.
6 Afta, I take una papa dem kom out from Egypt and wen dem waka rish di Red Sea, Egypt soja porshu dem with shariot.
6 Quando tirei os seus pais do Egito, vocês chegaram até o mar. Os egípcios perseguiram os pais de vocês, com carros de guerra e cavaleiros, até o mar Vermelho.
7 Una papa kry to God make E help dem; den di aria between una papa and Egypt sojas, God make am dark kon kill all Egypt sojas inside di sea. Wetin E do for Egypt, una si am with una own eye. Una stay tey for di desert.
7 Os pais de vocês clamaram e o Senhor pôs escuridão entre vocês e os egípcios, e trouxe o mar sobre eles, e o mar os cobriu. Vocês viram com os seus próprios olhos o que eu fiz no Egito. Depois vocês viveram no deserto por muito tempo.
8 “ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front.
8 — Daí eu os trouxe à terra dos amorreus, que moravam do outro lado do Jordão. Eles lutaram contra vocês, mas eu os entreguei nas mãos de vocês. Vocês tomaram posse da terra deles, e eu os destruí diante de vocês.
9 King Balak wey Zippor born for Moab kon attack Israel. E koll Balaam, Beor son sey make e curse una.
9 Então o rei de Moabe, Balaque, filho de Zipor, se levantou e lutou contra Israel. Mandou chamar Balaão, filho de Beor, para que os amaldiçoasse.
10 I nor gri listin to Balaam; instead e dey tok good tins about una and I save una from en pawa.
10 Porém eu não quis ouvir Balaão, e ele teve de abençoar vocês. E assim eu os livrei das mãos de Balaque.
11 “ ‘Una cross Jordan River kon rish Jeriko. Di leaders for Jeriko, plus Amor, Periz, Kanaan, Hit, Girgash, Hiv and Jebus pipol kon fight una, but I make una win all of dem.
11 — Vocês atravessaram o Jordão e chegaram a Jericó. Os moradores de Jericó lutaram contra vocês e o mesmo fizeram também os amorreus, os ferezeus, os cananeus, os heteus, os girgaseus, os heveus e os jebuseus. Porém eu os entreguei nas mãos de vocês.
12 I send fear go for una front go drive di two king for Amor. I give una viktory, even wen una nor use swod, bow or arrow.
12 Enviei vespões adiante de vocês, que os expulsaram de diante de vocês, bem como os dois reis dos amorreus. E não foram as espadas nem os arcos de vocês que fizeram isso.
13 I give una land wey una nor work hard to get; una dey big-big towns where una nor build house put and una dey chop fruits wey dem produce for vineyard and olive wey una nor plant.’
13 Eu lhes dei uma terra em que vocês não trabalharam e cidades que vocês não haviam construído. Vocês estão vivendo nessas cidades, e comem das vinhas e dos olivais que não plantaram.”
14 “Naw, make una obey God kon dey loyal as una dey woship am with betta mind. Make una forget di gods wey una grand-grand papa dey serve before-before for di oda side for di river and for Egypt and make una kom woship God.
14 — Agora, pois, temam o Senhor e o sirvam com integridade e com fidelidade. Joguem fora os deuses que os pais de vocês serviram do outro lado do Eufrates e no Egito e sirvam o Senhor .
15 If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”
15 Mas, se vocês não quiserem servir o Senhor , escolham hoje a quem vão servir: se os deuses a quem os pais de vocês serviram do outro lado do Eufrates ou os deuses dos amorreus em cuja terra vocês estão morando. Eu e a minha casa serviremos o Senhor .
16 Di pipol ansa, “Make God ponish us, if wi go woship anoda god!
16 Então o povo respondeu: — Longe de nós abandonar o
17 Bikos na di Oga awa God take wi and awa papa dem komot from sofa for Egypt kon do all doz mirakles for awa front. E still protet us wen wi dey travel pass difren kountries.
17 Porque o Senhor é o nosso Deus. Ele é quem nos tirou, a nós e aos nossos pais, da terra do Egito, da casa da servidão. Ele é quem fez estes grandes sinais aos nossos olhos e nos guardou por todo o caminho em que andamos e entre todos os povos pelo meio dos quais passamos.
18 God porshu all doz nashons komot for us, plus Amor pipol wey dey stay di land. So wi go woship di Oga God, bikos na-im bi awa God!”
18 O Senhor expulsou de diante de nós todas estas gentes, até o amorreu, morador da terra. Portanto, nós também serviremos o Senhor , pois ele é o nosso Deus.
19 Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin.
19 Então Josué disse ao povo: — Vocês não poderão servir o
20 If una forget God kon go woship anoda god, E go turn against una; E go bring wahala kom meet and distroy una, even doh E trit una as pikin before.”
20 Se abandonarem o Senhor e servirem deuses estranhos, ele se voltará contra vocês, e lhes fará mal, e os destruirá, depois de lhes ter feito bem.
21 Di pipol ansa Joshua, “Lie-lie! Na God wi go serve till wi die!”
21 Então o povo disse a Josué: — Não! O que queremos é servir o
22 Joshua tell di pipol, “Na una bi una own witness sey una dey sey, ‘Una go serve God till una die.’ ”
22 Josué disse ao povo: — Vocês são testemunhas contra vocês mesmos de que escolheram o E eles disseram: — Sim, somos testemunhas.
23 Den Joshua sey, “So make una trowey all di oda gods wey una get kon respet only di Oga wey bi Israel pipol God.”
23 E Josué continuou: — Agora, pois, joguem fora os deuses estranhos que há no meio de vocês e inclinem o coração ao
24 Di pipol tell Joshua, “Wi go woship di Oga awa God and wi go obey am.”
24 O povo disse a Josué: — Ao
25 Dat day, Joshua agri with di pipol kon give dem kommand and as dem go take follow am for Shekem.
25 Assim, naquele dia, Josué fez aliança com o povo e lhes deu estatutos e juízos em Siquém.
26 Joshua rite dis words for God book. E arrange big-big stones kon put di book on-top dem, under di oak tree near God Temple.
26 Josué escreveu estas palavras no Livro da Lei de Deus. Pegou uma grande pedra e a erigiu ali debaixo do carvalho que estava junto ao santuário do Senhor .
27 Joshua tell di pipol, “Si, dis stones go bi witness against una, bikos e don hear evritin wey God tell una. E go bi witness against anybody wey deny awa God.”
27 Então Josué disse a todo o povo: — Eis que esta pedra nos será testemunha, pois ouviu todas as palavras que o
28 Den Joshua sey make evribody dey go and di pipol kon go back to di land wey dem divide give dem.
28 Então Josué despediu o povo, cada um para a sua herança.
29 Afta all dis tins don happen, Joshua wey bi Nun pikin and God savant kon die wen e bi one hundred and ten years.
29 Depois destas coisas, Josué, filho de Num, servo do Senhor , morreu com a idade de cento e dez anos.
30 Dem beri am for di land wey dem gi-am for Timnat-Serah for Mount Gaash nort wey dey Efraim hill kountry.
30 Foi sepultado na sua própria herança, em Timnate-Sera, que fica na região montanhosa de Efraim, para o norte do monte Gaás.
31 Thru-out di time wey Joshua dey alive with doz leaders wey dey with am (before all of dem die), Israel pipol woship God. Dis leaders don si evritin wey God do for Israel pipol.
31 Israel serviu o Senhor todos os dias de Josué e todos os dias dos anciãos que ainda sobreviveram por muito tempo depois de Josué e que sabiam de todas as obras que o Senhor tinha feito por Israel.
32 Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.
32 Os ossos de José, que os filhos de Israel trouxeram do Egito, foram sepultados em Siquém, naquela parte do campo que Jacó havia comprado dos filhos de Hamor, pai de Siquém, por cem peças de prata, e que veio a ser a herança dos filhos de José.
33 Eleazar wey bi Aaron pikin kon die too and dem beri am for Gibeah for di hill kountry for Efraim, where en pikin Finehas for get land.
33 Morreu também Eleazar, filho de Arão, e o sepultaram em Gibeá, cidade que pertencia a Fineias, seu filho, e que lhe tinha sido dada na região montanhosa de Efraim.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.