Josué 23

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.
1 Muito tempo havia se passado desde que o Senhor tinha dado a Israel repouso de todos os seus inimigos ao redor. Josué agora já era bem idoso.
2 So Joshua gada all di pipol, plus di eldas, rulers, judge and leaders kon tell dem sey: “I don old well-well.
2 Ele chamou todo o Israel, os seus anciãos, os seus chefes, os seus juízes e os seus oficiais e lhes disse: — Já estou bem velho,
3 Una si evritin wey di Oga una God do to di oda nashons and as E take fight for una.
3 e vocês já viram tudo o que o Senhor , seu Deus, fez com todas essas nações por causa de vocês, porque o Senhor , seu Deus, é o que lutou por vocês.
4 Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win.
4 Vejam bem: por sorteio eu reparti entre as tribos de vocês estas nações que restam, juntamente com todas as nações que tenho eliminado, desde o Jordão até o mar Grande, na direção do pôr do sol.
5 Di Oga una God go drive dem komot for una, so dat una go fit stay dia land just as di Oga una God promise una.
5 O Senhor , seu Deus, as afastará e as expulsará da presença de vocês; e vocês tomarão posse das terras dessas nações, como o Senhor , seu Deus, prometeu.
6 “Make una dey strong! Make una dey obey evritin wey dem rite for Moses book with kare, so dat una nor go fall go left or rite,
6 — Portanto, esforcem-se muito para guardar e cumprir tudo o que está escrito no Livro da Lei de Moisés, para que dela não se afastem, nem para a direita nem para a esquerda,
7 or kon make friend with di remainin nashons. Una must nor use dia god name take make mout or tok about am! Una must nor woship or bow to dem!
7 e para que não se misturem com essas nações que restaram entre vocês. Não façam menção dos nomes de seus deuses, nem jurem por eles. Não sirvam, nem adorem esses deuses.
8 But una must dey loyal to di Oga una God, as una don dey loyal till today.
8 Pelo contrário, apeguem-se ao Senhor , seu Deus, como vocês têm feito até o dia de hoje.
9 “For una front, God porshu nashons wey get pawa well-well; nobody fit beat una kon rish today.
9 Porque o Senhor expulsou de diante de vocês grandes e fortes nações; e, até o dia de hoje, ninguém conseguiu resistir a vocês.
10 Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise.
10 Um só de vocês perseguirá mil, pois o Senhor , seu Deus, é quem luta por vocês, como ele prometeu.
11 Make una dey very kareful! Make una love di Oga wey bi una God!
11 — Portanto, empenhem-se em amar o Senhor , seu Deus.
12 “If una turn from God kon go enter agriment with di remainin towns wey dey near una, den marry some of dem and bi friend with some,
12 Porque, se vocês se desviarem dele e se apegarem ao que resta dessas nações que ainda se encontram entre vocês, e se unirem com elas por meio de casamento, e se misturarem com elas, e elas com vocês,
13 den make una know sey di Oga awa God nor go porshu dis nashons again. Dem go trap and turn una to slave; dem go bi kane wey go dey tear una body kon blind una eyes until una vanish komot from dis good land, wey di Oga una God give una.
13 saibam com certeza que o Senhor , seu Deus, não expulsará mais essas nações de diante de vocês. Pelo contrário, elas serão um laço e uma rede para vocês, e açoite nas costas e espinhos nos olhos, até que vocês desapareçam desta boa terra que o Senhor , seu Deus, lhes deu.
14 “Make una listin, I go soon die. Una know with all una heart and body sey evritin wey God promise sey E go do, E don do am for us!
14 — Eis que hoje sigo pelo caminho de todos os mortais, e vocês sabem de todo o coração e de toda a alma que nem uma só promessa falhou de todas as boas palavras que o Senhor , seu Deus, lhes falou; todas se cumpriram, nem uma delas falhou.
15 And na so, E don do evritin wey E promise una sey E go do for una, but if una disobey, God go bring all di judgement for una head, until E distroy una from dis good land wey di Oga una God give una.
15 E assim como se cumpriram todas estas boas coisas que o Senhor , seu Deus, lhes prometeu, assim o Senhor também cumprirá contra vocês todas as ameaças, até que os destrua de sobre a boa terra que o Senhor , seu Deus, lhes deu.
16 If una go against di Oga una God kovenant wey E kommand make una keep kon follow, woship and dey bow to oda gods, God go vex for una well-well and una go kwik-kwik vanish komot from dis good land wey E give una.”
16 Se violarem a aliança que o Senhor , seu Deus, lhes ordenou, e forem e servirem outros deuses, e os adorarem, a ira do Senhor se acenderá sobre vocês, e logo vocês desaparecerão da boa terra que ele lhes deu.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.