Josué 22
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Den Joshua koll Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe
1 Josué convocou as tribos de Rúben, de Gade e a metade da tribo de Manassés
2 kon tell dem: “Una don do evritin wey God savant Moses tell una kon obey evritin wey I tell una.
2 e lhes disse: "Vocês fizeram tudo o que Moisés, servo do Senhor, ordenou.
3 All dis time, una neva leave una pipol and una always dey obey di Oga wey bi una God.
3 Durante muito tempo, e até hoje, vocês não abandonaram os seus irmãos, mas cumpriram a missão que o Senhor, o seu Deus, lhes entregou.
4 Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.
4 Agora que o Senhor, o seu Deus, já concedeu descanso aos seus irmãos israelitas, como tinha prometido, voltem para casa, para a terra que Moisés, servo do Senhor, lhes deu no outro lado do Jordão.
5 But make una dey obey God kommand and laws wey en savant Moses tell una with kare; make una dey loyal to am kon serve am with all una heart and body!”
5 Mas guardem fielmente o mandamento e a lei que Moisés, servo do Senhor, lhes deu de amar o Senhor, o seu Deus, andar em todos os seus caminhos, obedecer aos seus mandamentos, apegar-se a ele e servi-lo de todo o coração e de toda a alma".
6 Joshua give dem gift kon tell dem make dem go back to dia house.
6 Então Josué os abençoou e os despediu, e eles foram para casa.
7 (Naw, Moses give Bashan land to half of Manasseh tribe and Joshua kon give Jordan River west to di oda half for Manasseh tribe and Israel pipol wey dey with dem.) Wen Joshua sey make dem dey go house, e give dem gift
7 ( À metade da tribo de Manassés Moisés dera terras em Basã, e à outra metade da tribo Josué dera terras no lado oeste do Jordão, junto com outros israelitas. ) Ao mandá-los para casa, Josué os abençoou,
8 kon sey, “Make una take dis tin dey go and dem bi plenty money, many-many animals, silva, gold, bronze, iron and many klot. Di tins wey wi karry from awa enemies, make una divide am among unasef.”
8 dizendo: "Voltem para casa com as riquezas que juntaram: grandes rebanhos, prata, ouro, bronze e ferro, e muitas roupas. Dividam com os seus irmãos os despojos de seus inimigos".
9 So Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon leave Israel pipol for Shiloh wey dey Kanaan, den dem go dia own house for Gilead wey God give dem thru Moses.
9 Assim as tribos de Rúben, de Gade e a metade da tribo de Manassés deixaram os outros israelitas em Siló, na terra de Canaã, para voltarem para Gileade, sua própria terra, da qual se apossaram de acordo com a ordem do Senhor, dada por meio de Moisés.
10 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe rish Gelilot near Jordan River for Kanaan land kon build one fine altar for der.
10 Quando chegaram a Gelilote, perto do Jordão, em Canaã, as tribos de Rúben, de Gade e a metade da tribo de Manassés construíram um imponente altar ali, junto ao Jordão.
11 Israel pipol hear wetin happen sey: “Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe don build one altar for di town door-mot for Gelilot wey dey Kanaan near Jordan River for di oda side wey Israel pipol dey.”
11 E, quando os outros israelitas souberam que eles tinham construído o altar na fronteira de Canaã, em Gelilote, perto do Jordão, no lado israelita,
12 Wen Israel pipol hear wetin happen, dem kon gada for one place for Shiloh to go fight dem.
12 toda a comunidade de Israel reuniu-se em Siló para guerrear contra eles.
13 Israel pipol send Finehas, wey bi Eleazar di priest son go Gilead go meet Reuben and Gad pipol plus half of Manasseh tribe.
13 Então os israelitas enviaram Finéias, filho do sacerdote Eleazar, à terra de Gileade, às tribos de Rúben e Gade e à metade da tribo de Manassés.
14 Ten leaders follow am go, one from each tribe, dem bi leaders for Israel family.
14 Com ele enviaram dez líderes, um de cada tribo de Israel, sendo cada um deles chefe de suas respectivas famílias dentre os clãs israelitas.
15 Dem kon go Gilead land go meet Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon tell dem:
15 Quando chegaram a Gileade, às tribos de Rúben e de Gade e à metade da tribo de Manassés, disseram-lhes:
16 “Evribody for Israel wey bi God own sey make wi ask una, ‘Wetin make una disobey Israel God as una don turn from am.
16 "Assim diz toda a comunidade do Senhor: ‘Como foi que vocês cometeram essa infidelidade para com o Deus de Israel? Como foi que se afastaram do Senhor, construindo um altar para vocês, rebelando-se assim contra ele?
17 Di sin wey wi sin for Peor nor bad rish? Till today wi neva fit klean awasef finish; e even bring wahala kom meet us wey bi God pipol.
17 Já não nos bastou o pecado de Peor? Até hoje não nos purificamos daquele pecado, muito embora uma praga tenha caído sobre a comunidade do Senhor!
18 Naw, today, una don turn una back to di Oga una God!
18 E agora vocês estão abandonando o Senhor! " ‘Se hoje vocês se rebelarem contra o Senhor, amanhã a sua ira cairá sobre toda a comunidade de Israel.
19 But if una land nor dey okay bikos of sin, una fit cross kom meet us for di land where God dey. But make una nor build altar for unasef wey nor bi awa Oga God altar, bikos dat go show sey una dey fight against God and wi.
19 Se a terra que vocês receberam como propriedade está contaminada, passem então para a terra que pertence ao Senhor, onde está o tabernáculo do Senhor, e se apossem de um território entre nós. Mas não se rebelem contra o Senhor nem contra nós, construindo para vocês um altar que não seja o altar do Senhor, do nosso Deus.
20 Wen Zera pikin, Akan nor gri obey di kommand about di town tins, na di whole town sofa am, even doh na only one man sin. And nor bi only en die for di sin wey e kommit.’ ”
20 Quando Acã, filho de Zerá, foi infiel com relação às coisas consagradas, não caiu a ira sobre toda a comunidade de Israel? E ele não foi o único que morreu por causa do seu pecado’ ".
21 Den Reuben and Gad pipol and half of Manasseh tribe kon ansa Israel leaders sey:
21 Então as tribos de Rúben, de Gade e a metade da tribo de Manassés responderam aos chefes dos clãs de Israel:
22 “Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Na-im know di trut and Israel pipol must know di trut too. If wi don sin or disobey God, make una nor sorry for us today!
22 "O Poderoso, Deus, o Senhor! O Poderoso, Deus, o Senhor! Ele sabe! E que Israel o saiba! Se agimos com rebelião ou infidelidade para com o Senhor, não nos poupem hoje.
23 If wi build altar for awasef kon turn from God as wi dey make ofrin and sakrifice on-top am or dey offa ofrin of peace for awasef, make God ensef ponish us.
23 Se construímos nosso próprio altar para nos afastarmos do Senhor e para oferecermos holocaustos e ofertas de cereal, ou sacrifícios de comunhão sobre ele, que o próprio Senhor nos peça contas disso!
24 “Wi swear sey wetin make us do like dis na, bikos wi dey fear sey tumoro una shidren-shidren fit dey ask awa shidren-shidren sey, ‘Who give una di rite to woship di Oga wey bi Israel God?
24 "Ao contrário! Fizemos isso temendo que no futuro os seus descendentes dissessem aos nossos: ‘Que relação vocês têm com o Senhor, com o Deus de Israel?
25 Na God make Jordan River as boundary between wi and una (Reuben and Gad tribe). So una nor get rite to woship God.’ And if e happen like dat, una shidren-shidren fit make awa own stop to woship and obey God.
25 Homens de Rúben e de Gade! O Senhor fez do Jordão uma fronteira entre nós e vocês. Vocês não têm parte com o Senhor’. Assim os seus descendentes poderiam levar os nossos a deixarem de temer o Senhor.
26 “So wi kon agri sey make wi build dis altar, nor bi to burn ofrin or to sakrifice put,
26 "É por isso que resolvemos construir um altar, não para holocaustos ou sacrifícios,
27 but na to remind us and una and awa shidren-shidren sey, wi go woship God for en present with burn ofrin, sakrifice and peace ofrin. Den, tumoro una shidren-shidren nor go fit tell awa own sey, ‘Una nor get rite to woship God.’
27 mas, para que esse altar sirva de testemunho entre nós e vocês e as gerações futuras, de que cultuaremos o Senhor em seu santuário com nossos holocaustos, sacrifícios e ofertas de comunhão. Então, no futuro, os seus descendentes não poderão dizer aos nossos: ‘Vocês não têm parte com o Senhor’.
28 “Wi kon sey, ‘If dem tell us or awa shidren-shidren dis kind tin tumoro, wi go ansa dem sey, “Si di fine altar wey awa grand-grand papa build for God, nor bi for burn ofrin or sakrifice, but na to dey remind wi and una.” ’
28 "E dissemos: Se algum dia disserem isso a nós ou aos nossos descendentes, responderemos: Vejam a réplica do altar do Senhor que os nossos antepassados construíram, não para holocaustos ou sacrifícios, mas como testemunho entre nós e vocês.
29 “Wi nor go ever disobey God and wi nor go fit turn back from God kon build altar wey wi go dey burn ofrin or do sakrifice put, apart from di altar wey dey awa Oga God Temple!”
29 "Longe de nós nos rebelarmos contra o Senhor e nos afastarmos dele, construindo para holocaustos, ofertas de cereal e sacrifícios um altar que não seja o altar do Senhor, do nosso Deus, que está diante do seu tabernáculo! "
30 Wen Finehas wey bi priest, di kommunity and di family leaders wey kom with am hear wetin Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe tok, body kon sweet dem well-well.
30 Quando o sacerdote Finéias e os líderes da comunidade, os chefes dos clãs dos israelitas, ouviram o que os homens de Rúben, de Gade e de Manassés disseram, deram-se por satisfeitos.
31 Finehas wey bi Eleazar pikin and di priest kon tell Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe sey, “Today wi don know sey God dey among us, bikos una neva disobey God at-all. Naw, una don save all Israel pipol from God vexnashon.”
31 E Finéias, filho do sacerdote Eleazar, disse a Rúben, a Gade e a Manassés: "Hoje sabemos que o Senhor está conosco, pois vocês não foram infiéis para com o Senhor. E assim vocês livraram os israelitas da mão do Senhor".
32 Finehas wey bi Eleazar pikin, di priest and di leaders kon leave Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe for Gilead town kon go ripot give di whole Israel wey dey Shiloh for Kanaan land.
32 Então Finéias, filho do sacerdote Eleazar, e os líderes voltaram do encontro com os homens de Rúben e de Gade em Gileade, e foram para Canaã dar relatório aos outros israelitas.
33 Wen dem tell Israel pipol evritin, belle sweet dem and dem kon tank God. Dem nor ever tok again sey dem go distroy Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe.
33 Estes se alegraram com o relatório e louvaram a Deus. E não mais falaram em guerrear contra as tribos de Rúben e de Gade, nem em devastar a região onde eles viviam.
34 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon name di altar and sey, “Really e go dey remind us sey na di Oga bi God.”
34 Os homens de Rúben e de Gade deram ao altar este nome: Um Testemunho Entre Nós de que o Senhor é Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 22, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.