Josué 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Adoni-Zedek wey bi Jerusalem king hear how Joshua take enter Ai town kon distroy am and en king, just as e do to Jeriko and en king. E still hear how Gibeon pipol make peace with Israel pipol kon dey stay togeda.
1 Sucedeu que Adoni-Zedeque, rei de Jerusalém, soube que Josué tinha conquistado Ai e a tinha destruído totalmente, fazendo com Ai e seu rei o que fizera com Jericó e seu rei, e que o povo de Gibeom tinha feito a paz com Israel e estava vivendo no meio deles.
2 Evribody for Jerusalem dey fear, bikos Gibeon na big town, like one of di kings town. E big pass Ai and all en men dem get pawa.
2 Ele e o seu povo ficaram com muito medo, pois Gibeom era tão importante como uma cidade governada por um rei; era maior do que Ai, e todos os seus homens eram bons guerreiros.
3 So king Adoni-Zedek for Jerusalem kon send message go meet King Hoham for Hebron, King Piram for Jarmut, King Jafia for Lakish and King Debir for Eglon:
3 Por isso Adoni-Zedeque, rei de Jerusalém, fez o seguinte apelo a Hoão, rei de Hebrom, a Piram, rei de Jarmute, a Jafia, rei de Láquis, e a Debir, rei de Eglom:
4 sey, “Make una kom help mi go fight Gibeon, bikos e don go make peace with Joshua and Israel pipol.”
4 "Venham para cá e ajudem-me a atacar Gibeom, pois ela fez a paz com Josué e com os israelitas".
5 So di five kings wey kom from Jerusalem, Hebron, Jarmut, Lakish and Eglon, with all dia sojas kon gada go fight Gibeon pipol.
5 Então os cinco reis dos amorreus, os reis de Jerusalém, de Hebrom, de Jarmute, de Láquis e de Eglom reuniram-se e vieram com todos os seus exércitos. Cercaram Gibeom e a atacaram.
6 Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”
6 Os gibeonitas enviaram esta mensagem a Josué, ao acampamento de Gilgal: "Não abandone os seus servos. Venha depressa! Salve-nos! Ajude-nos, pois todos os reis amorreus que vivem nas montanhas se uniram contra nós! "
7 So Joshua, en sojas and di ones wey get heart well-well kon from Gilgal mash go Gibeon.
7 Josué partiu de Gilgal com todo o seu exército, inclusive com os seus melhores guerreiros.
8 God tell Joshua, “Make una nor fear, bikos I dey give dem to una. Non of dem go fit stop una.”
8 E disse o Senhor a Josué: "Não tenha medo desses reis; eu os entreguei nas suas mãos. Nenhum deles conseguirá resistir a você".
9 Joshua attack dem by sopraiz afta dem use one full nite mash kom from Gilgal.
9 Depois de uma noite inteira de marcha desde Gilgal, Josué os apanhou de surpresa.
10 God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.
10 O Senhor os lançou em confusão diante de Israel, que lhes impôs grande derrota em Gibeom. Os israelitas os perseguiram na subida para Bete-Horom e os mataram por todo o caminho, até Azeca e Maquedá.
11 As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.
11 Enquanto fugiam de Israel na descida de Bete-Horom para Azeca, do céu o Senhor lançou sobre eles grandes pedras de granizo, que mataram mais gente do que as espadas dos israelitas.
12 Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey:
12 No dia em que o Senhor entregou os amorreus aos israelitas, Josué exclamou ao Senhor, na presença de Israel: "Sol, pare sobre Gibeom! E você, ó lua, sobre o vale de Aijalom! "
13 Di sun and di moon stand for one place
13 O sol parou, e a lua se deteve, até a nação vingar-se dos seus inimigos, como está escrito no Livro de Jasar. O sol parou no meio do céu e por quase um dia inteiro não se pôs.
14 Dat kind tin neva happen before and e nor happen again. God listin to one man, bikos E fight for en pipol, Israel!
14 Nunca antes nem depois houve um dia como aquele, quando o Senhor atendeu a um homem. Sem dúvida o Senhor lutava por Israel!
15 Den Joshua and Israel sojas kon go back to di kamp for Gilgal.
15 Então Josué voltou com todo o Israel ao acampamento de Gilgal.
16 Di five king run go hide for one hole for Makkedah.
16 Os cinco reis fugiram e se esconderam na caverna de Maquedá.
17 So dem tell Joshua, “Wi don si di five kings for di whole where dem hide put for Makkedah.”
17 Avisaram a Josué que eles tinham sido achados numa caverna em Maquedá.
18 Joshua ansa, “Make una use big stone kover di hole mout kon put pipol wey go guide am for der.
18 Disse ele: "Rolem grandes pedras até a entrada da caverna, e deixem ali alguns homens de guarda.
19 But make una nor stay tey! Make una porshu and katch una enemies! Nor let dem rish dia kountry, bikos di Oga una God go give dem to una.”
19 Mas não se detenham! Persigam os inimigos. Ataquem-nos pela retaguarda e não os deixem chegar às suas cidades, pois o Senhor, o seu Deus, os entregou em suas mãos".
20 Joshua and Israel pipol almost kill dem finish, but some still eskape go di main town.
20 Assim Josué e os israelitas os derrotaram por completo, quase exterminando-os. Mas alguns conseguiram escapar e refugiaram-se em suas cidades fortificadas.
21 Den Israel sojas kom back well kom meet Joshua for di kamp for Makkedah. Nobody even fit tok against Israel pipol for di full land.
21 O exército inteiro voltou então em segurança a Josué, ao acampamento de Maquedá, e depois disso, ninguém mais ousou abrir a boca para provocar os israelitas.
22 Joshua sey, “Make una open di hole, den bring di five kings kom meet mi.”
22 Então disse Josué: "Abram a entrada da caverna e tragam-me aqueles cinco reis".
23 Dem do as Joshua tell dem kon take di five kings go meet am and na Jerusalem, Hebron, Jarmut, Lakish and Eglon king.
23 Os cinco reis foram tirados da caverna. Eram os reis de Jerusalém, de Hebrom, de Jarmute, de Láquis e de Eglom.
24 Wen dem bring di kings kom meet Joshua, e koll Israel men kon tell di sojas oga wey dey with am sey, “Make una kom here kon mash dis kings for dia neck.” So dem kom put dia legs for di kings neck.
24 Quando os levaram a Josué, ele convocou todos os homens de Israel e disse aos comandantes do exército que o tinham acompanhado: "Venham aqui e ponham o pé no pescoço destes reis". E eles obedeceram.
25 Den Joshua tell dem, “Make una nor fear or shake. Make una get heart and dey strong, bikos God go do di same tin to all una enemies wey una dey fight against.”
25 Disse-lhes Josué: "Não tenham medo! Não se desanimem! Sejam fortes e corajosos! É isso que o Senhor fará com todos os inimigos que vocês tiverem que combater".
26 Den Joshua kill di kings kon hang dem on-top tree. Dem dey di tree till evening.
26 Depois Josué matou os reis e mandou pendurá-los em cinco árvores, onde ficaram até à tarde.
27 Wen sun don go down, Joshua kon sey make en men bring di kings body kom down from di tree kon trow dia body inside di hole wey dem hide put before, den pak big-big stones take kover di hole. (Dem still dey der till today.)
27 Ao pôr-do-sol, sob as ordens de Josué, eles foram tirados das árvores e jogados na caverna onde haviam se escondido. Na entrada da caverna colocaram grandes pedras, que lá estão até hoje.
28 Dat day, Joshua enter Makkedah town kon kill evribody wey dey stay der plus di king. E do di king wetin e do to Jeriko king.
28 Naquele dia Josué tomou Maquedá. Atacou a cidade e matou o seu rei à espada e exterminou todos os que nela viviam, sem deixar sobreviventes. E fez com o rei de Maquedá o que tinha feito com o rei de Jericó.
29 Joshua and Israel pipol kon mash from Makkedah go Libnah go fight dem.
29 Então Josué, e todo o Israel com ele, avançou de Maquedá para Libna e a atacou.
30 God give Libnah to Joshua and en sojas and dem kill evribody wey dey stay der; evribody die finish. Dem kon do en king as dem do to Jeriko king.
30 O Senhor entregou também aquela cidade e seu rei nas mãos dos israelitas. Josué atacou a cidade e matou à espada todos os que nela viviam, sem deixar nenhum sobrevivente ali. E fez com o seu rei o que fizera com o rei de Jericó.
31 Joshua and en sojas kon mash from Libnah go Lakish. En and en sojas kon fight against Lakish
31 Depois Josué, e todo o Israel com ele, avançou de Libna para Láquis, cercou-a e a atacou.
32 and God make dem win and dem enter di whole town for di sekond day. Dem kill evribody wey dey stay der, just as dem do for Libnah.
32 O Senhor entregou Láquis nas mãos dos israelitas, e Josué tomou-a no dia seguinte. Atacou a cidade e matou à espada todos os que nela viviam, como tinha feito com Libna.
33 Den, Horam wey bi king for Geza kon kom help Lakish, but Joshua kill en and all en sojas finish.
33 Nesse meio tempo Horão, rei de Gezer, fora socorrer Láquis, mas Josué o derrotou, a ele e ao seu exército, sem deixar sobrevivente algum.
34 Joshua and all Israel pipol mash from Lakish go Eglon. En and all en sojas kon fight dem.
34 Josué, e todo o Israel com ele, avançou de Láquis para Eglom, cercou-a e a atacou.
35 Dat day, dem enter di town kon kill evribody wey dey stay der, den distroy am, just as dem do to Lakish.
35 Eles a conquistaram naquele mesmo dia, feriram-na à espada e exterminaram os que nela viviam, como tinham feito com Láquis.
36 Joshua and all en sojas mash from Eglon go Hebron go fight.
36 Então Josué, e todo o Israel com ele, foi de Eglom para Hebrom e a atacou.
37 Dem enter di town kon kill di king, evribody wey dey stay der and di towns wey dey near der and dem nor leave anybody. Dem kill evribody, just as dem do for Eglon.
37 Tomaram a cidade e a feriram à espada, como também o seu rei, os seus povoados e todos os que nela viviam, sem deixar sobrevivente algum. Destruíram totalmente a cidade e todos os que nela viviam, como tinham feito com Eglom.
38 Joshua and en sojas kon go fight against Debir.
38 Depois Josué, e todo o Israel com ele, voltou e atacou Debir.
39 Dem enter di town, katch di king and all di towns wey dey near am, den dem kill evribody wey dey stay der; nobody survive. Dem kill evribody, just as dem do for Hebron, Libnah and to dia kings.
39 Tomaram a cidade, seu rei e seus povoados, e os mataram à espada. Exterminaram os que nela viviam, sem deixar sobrevivente algum. Fizeram com Debir e seu rei o que tinham feito com Libna e seu rei e com Hebrom.
40 Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok.
40 Assim Josué conquistou a região toda, incluindo a serra central, o Neguebe, as encostas e as vertentes, e derrotou todos os seus reis, sem deixar sobrevivente algum. Exterminou tudo o que respirava, conforme o Senhor, o Deus de Israel, tinha ordenado.
41 Joshua win di aria wey dey between Kadesh Barnea and Gaza, plus evriwhere for Goshen go rish Gibeon.
41 Josué os derrotou desde Cades-Barnéia até Gaza, e toda a região de Gósen, e de lá até Gibeom.
42 Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.
42 Também subjugou todos esses reis e conquistou suas terras numa única campanha, pois o Senhor, o Deus de Israel, lutou por Israel.
43 Den Joshua and all en sojas kon go back to dia kamp for Gilgal.
43 Então Josué retornou com todo o Israel ao acampamento de Gilgal.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.