Jeremias 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 God tell Jeremaya:
1 A palavra que da parte do Senhor veio a Jeremias, dizendo:
2 “Make yu stand for di temple gate kon shaut tok dis message: ‘Judah pipol wey dey pass thru dis gates kom woship God, make una listin! Make una hear wetin God won tok.
2 Põe-te à porta da casa do Senhor, e proclama ali esta palavra, e dize: Ouvi a palavra do Senhor, todos de Judá, os que entrais por estas portas, para adorardes ao Senhor.
3 Oga wey bi Israel God wey dey rule all of us sey, Make una shange from di kind life wey una dey live kon do di rite tin. If una shange, I go allow una stay for dis land.’
3 Assim diz o Senhor dos exércitos, o Deus de Israel: Emendai os vossos caminhos e as vossas obras, e vos farei habitar neste lugar.
4 Make una nor bilive di lie wey make una dey sey, ‘Wi dey save, bikos God temple dey here! Yes! God temple dey here!’
4 Não vos fieis em palavras falsas, dizendo: Templo do Senhor, templo do Senhor, templo do Senhor são estes.
5 Make una shange from di kind life wey una dey live kon dey do di rite tin. Make una respet each oda too.
5 Mas, se deveras emendardes os vossos caminhos e as vossas obras; se deveras executardes a justiça entre um homem e o seu próximo;
6 Make una stop to opress di strenjas among una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die. Make una stop to kill innocent pipol and woship oda gods, bikos e go distroy una.
6 se não oprimirdes o estrangeiro, e o órfão, e a viúva, nem derramardes sangue inocente neste lugar, nem andardes após outros deuses para vosso próprio mal,
7 If una stop to do all dis tins, I go allow una stay for dis land wey I give una grand-grand papa as dia propaty.
7 então eu vos farei habitar neste lugar, na terra que dei a vossos pais desde os tempos antigos e para sempre.
8 “But make una si una life! Una dey bilive lie-lie words wey nor go save una.
8 Eis que vós confiais em palavras falsas, que para nada são proveitosas.
9 Una dey tif; kill; dey sleep with who una nor marry; dey lie; dey swear; dey offa sakrifice give juju and dey woship gods wey una nor know before.
9 Furtareis vós, e matareis, e cometereis adultério, e jurareis falsamente, e queimareis incenso a Baal, e andareis após outros deuses que não conhecestes,
10 Wen una don do all dis tins wey I hate finish, una go kom stand for my present inside my temple kon dey sey, ‘Wi dey save!’ Una tink sey una really dey save wen una dey do all di tins wey I hate?
10 e então vireis, e vos apresentareis diante de mim nesta casa, que se chama pelo meu nome, e direis: Somos livres para praticardes ainda todas essas abominações?
11 God sey, Una tink sey my temple na where tif dey hide put? Make una know sey I don si wetin una dey do.
11 Tornou-se, pois, esta casa, que se chama pelo meu nome, uma caverna de salteadores aos vossos olhos? Eis que eu, eu mesmo, vi isso, diz o Senhor.
12 Make una go Shiloh, di place wey I first choose sey dem go for dey woship mi. Make una si wetin I do for der bikos of di wiked tins wey my pipol Israel, do.
12 Mas ide agora ao meu lugar, que estava em Siló, onde, ao princípio, fiz habitar o meu nome, e vede o que lhe fiz, por causa da maldade do meu povo Israel.
13 Una don do all dis tins and even as I tok to una rish, una nor gri listin or ansa wen I koll una make una turn kom meet mi.
13 Agora, pois, porquanto fizestes todas estas obras, diz o Senhor, e quando eu vos falei insistentemente, vós não ouvistes, e quando vos chamei, não respondestes,
14 So, just as I distroy Shiloh, na so too I go distroy dis my temple wey una trust sey go protet una, even doh I bin gi-am to una and una grand-grand papa.
14 farei também a esta casa, que se chama pelo meu nome, na qual confiais, e a este lugar, que vos dei a vós e a vossos pais, como fiz a Siló.
15 Just as I porshu Israel pipol wey bi una relashon, na so too, I go porshu una komot from my front.
15 E eu vos lançarei da minha presença, como lancei todos os vossos irmãos, toda a linhagem de Efraim.
16 Den God tell mi, “Jeremaya! Make yu nor pray for dis pipol. Make yu nor kry or pray give mi bikos of dem! Nor beg make I save dem, bikos I nor go listin to yu.
16 Tu, pois, não ores por este povo, nem levantes por ele clamor ou oração, nem me importunes; pois eu não te ouvirei.
17 Abi yu nor dey si all wetin dem dey do for Judah and for evry street for Jerusalem?
17 Não vês tu o que eles andam fazendo nas cidades de Judá, e nas ruas de Jerusalém?
18 Dia shidren dey gada firewood; men dey make di fire and di wimen dey mix flower wey dem go take bake kake for dat juju wey dem dey koll, ‘Heaven Kween.’ Dem still dey pour wine give oda gods as ofrin and dis tin dey make mi vex.
18 Os filhos apanham a lenha, e os pais acendem o fogo, e as mulheres amassam a farinha para fazerem bolos à rainha do céu, e oferecem libações a outros deuses, a fim de me provocarem à ira.
19 Na mi, dem tink sey dem dey do? ‘No!’ Na demsef dem dey bring wahala and shame kom meet.”
19 Acaso é a mim que eles provocam à ira? diz o Senhor; não se provocam a si mesmos, para a sua própria confusão?
20 So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”
20 Portanto assim diz o Senhor Deus: Eis que a minha ira e o meu furor se derramarão sobre este lugar, sobre os homens e sobre os animais, sobre as árvores do campo e sobre os frutos da terra; sim, acender-se-á, e não se apagará.
21 God still tell Judah pipol, “Una fit still go put una burnt ofrin join di oda sakrifice kon chop all of dem!
21 Assim diz o Senhor dos exércitos, o Deus de Israel: Ajuntai os vossos holocaustos aos vossos sacrifícios, e comei a carne.
22 Si, wen I bring una grand-grand papa dem kom out from Egypt kon tok to dem, I nor only kommand dem for wetin dem go do koncerning di burnt ofrin and sakrifice.
22 Pois não falei a vossos pais no dia em que os tirei da terra do Egito, nem lhes ordenei coisa alguma acerca de holocaustos ou sacrifícios.
23 But I kommand dem sey, ‘Make una obey mi and if una obey mi, I go bi una God and una go bi my pipol. Make una live una life as I tell una and evritin go betta for una.’
23 Mas isto lhes ordenei: Dai ouvidos à minha voz, e eu serei o vosso Deus, e vós sereis o meu povo; andai em todo o caminho que eu vos mandar, para que vos vá bem.
24 But dem nor gri listin or hear mi. Dem dey do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do. Instead make dem dey betta, dem kon worse pass as dem bi before.
24 Mas não ouviram, nem inclinaram os seus ouvidos; porém andaram nos seus próprios conselhos, no propósito do seu coração malvado; e andaram para trás, e não para diante.
25 Since una grand-grand papa kom out from Egypt kon rish naw, I dey always send my savants, di profets kom meet una.
25 Desde o dia em que vossos pais saíram da terra do Egito, até hoje, tenho-vos enviado insistentemente todos os meus servos, os profetas, dia após dia;
26 But nobody among una dey listin or hear dem. Instead, una sturbon and wiked pass una grand-grand papa.”
26 contudo não me deram ouvidos, nem inclinaram os seus ouvidos, mas endureceram a sua cerviz. Fizeram pior do que seus pais.
27 Den God tell mi, “Even wen yu don tell dem all dis tins finish, dem nor go still listin to yu; yu go koll dem, but dem nor go ansa yu.”
27 Dir-lhes-ás pois todas estas palavras, mas não te darão ouvidos; chamá-los-ás, mas não te responderão.
28 So tell dem sey: “Dis na nashon wey nor gri obey di Oga dia God or learn from dia wahala. Nobody for der dey good and di pipol nor dey even tok about good tins again.
28 E lhes dirás: Esta é a nação que não obedeceu a voz do Senhor seu Deus e não aceitou a correção; já pereceu a verdade, e está exterminada da sua boca.
29 So, Jerusalem pipol! Make una mourn and kut una hair. Make una sing burial song on-top evry hill, bikos God sey, ‘I go rijet and forget dis pipol, bikos dem don make mi vex.’ ”
29 Corta os teus cabelos, Jerusalém, e lança-os fora, e levanta um pranto sobre os altos escalvados; porque o Senhor já rejeitou e desamparou esta geração, objeto do seu furor.
30 God sey, “I don rijet Judah pipol, bikos of di wiked tins wey dem do. Dia juju wey I hate, dem put am for my temple kon make di temple dirty.
30 Porque os filhos de Judá fizeram o que era mau aos meus olhos, diz o Senhor; puseram as suas abominações na casa que se chama pelo meu nome, para a contaminarem.
31 And dem even build where dem go for dey woship for Tofet wey dey Ben-Hinnom Valley, so dat dem go fit sakrifice dia shidren give juju for der. Dis na wetin I sey make dem nor do! True-true, dat kind tin neva even enter my mind to tell dem.
31 E edificaram os altos de Tofete, que está no Vale do filho de Hinom, para queimarem no fogo a seus filhos e a suas filhas, o que nunca ordenei, nem me veio à mente.
32 So, di time dey kom wen dem nor go koll dat place, ‘Tofet or Hinnom Valley again’, but dem go koll am, ‘Valley where dem for dey kill pipol.’ Dem go beri pipol for der, bikos know oda place go dey to beri pipol put.
32 Portanto, eis que vêm os dias, diz o Senhor, em que não se chamará mais Tofete, nem Vale do filho de Hinom, mas o Vale da Matança; pois enterrarão em Tofete, por não haver mais outro lugar.
33 Den dis wiked pipol dead body go dey for groun and birds with wild animals go chop am. Nobody go remain for der to porshu di animals.
33 E os cadáveres deste povo servirão de pasto às aves do céu e aos animais da terra; e ninguém os enxotará.
34 For Judah town and Jerusalem street, I go make sure sey nobody dey shaut or happy with joy sey pesin dey marry. Dis na bikos di whole land dey empty and dirty don full der.”
34 E farei cessar nas cidades de Judá, e nas ruas de Jerusalém, a voz de gozo e a voz de alegria, a voz de noivo e a voz de noiva; porque a terra se tornará em desolação.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.