Jeremias 52

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule Judah and e rule Jerusalem for eleven years. En mama name na Hamutal and na Jeremaya wey dey stay Libnah town, born am.
1 Tinha Sedecias vinte e um anos ao começar seu reinado. Seu reino durou onze anos em Jerusalém. Chamava-se sua mãe Amital, filha de Jeremias, e era natural de Lobna.
2 King Zedekaya sin against God, just as King Jehoiakim do.
2 Como Joaquim, ele também praticou o mal aos olhos do Senhor.
3 Bikos God dey vex for Jerusalem and Judah pipol, E kon porshu dem komot for en present go Babilon town. So Zedekaya kon plan against Babilon king
3 Assim aconteceu em Jerusalém e Judá, por querer o Senhor, em sua cólera, repeli-los para longe de sua presença.
4 and for di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar lead en sojas go fight against Jerusalem. Dem surround di town kon build dia tent near di wall.
4 No nono ano de seu reinado, no décimo dia do décimo mês, foi Nabucodonosor, com todo o seu exército, contra Jerusalém, armando e construindo fortificações em torno dela.
5 Dem stay round Jerusalem until di elevent year wey King Zedekaya dey rule.
5 Até o décimo primeiro ano do reinado de Sedecias perdurou o sítio da cidade.
6 For di ninet day for di fourt mont for dat same year wey Zedekaya don dey rule, di honga for di town kon sirious bikos di food wey remain, don finish.
6 No nono dia do quarto mês, como a fome invadisse a cidade e não tivesse a população o que comer,
7 Den dem break one part for di town wall rish groun and all di sojas kon run. Since Babilon pipol surround di town, Zedekaya and en men kon wait make nite rish, before dem pass di gate between di two walls wey dey back of di king gardin kon run dey go Jordan River side.
7 uma brecha foi feita na muralha da cidade e, à noite, fugiram os guerreiros pelo caminho da porta entre os dois muros, perto do jardim do rei, enquanto os caldeus cercavam a cidade. Tomaram esses homens o caminho da planície do Jordão.
8 But Babilon sojas porshu King Zedekaya kon katch am for Jeriko road, but en men run leave am.
8 Mas o exército dos caldeus perseguiu o rei e o alcançou nas planícies de Jericó. Então as tropas de Sedecias o abandonaram, dispersando-se em fuga.
9 Dem take am go meet Babilon king for Riblah for Hamat land. Den Babilon king judge am for der.
9 Foi então o rei aprisionado e conduzido a Rebla, na presença do rei de Babilônia que contra ele pronunciou sua sentença.
10 E make Zedekaya dey look as dem dey kill en shidren and all en oda ofisas for Judah.
10 E, diante de seus olhos, foram degolados em Rebla seus filhos, assim como todos os chefes de Judá.
11 Den dem blind Zedekaya eye, tie am with shain kon karry am go Babilon. Zedekaya stay prison till e die.
11 Em seguida, foram-lhe arrancados os olhos e, ligado com cadeias de bronze, levaram-no para Babilônia, onde, até o dia de sua morte, permaneceu encarcerado.
12 For di tent day for di fift mont for di nineteent year wey King Nebukadnezzar don dey rule, Nebuzaradan wey bi di king advise and dey kommand di sojas, enter Jerusalem.
12 No sétimo dia do quinto mês, décimo nono ano do reinado de Nabucodonosor, rei de Babilônia, Nabuzardã, chefe da guarda e servidor do rei de Babilônia, penetrou em Jerusalém,
13 E burn God temple, di royal palis and all di house for Jerusalem. E distroy all di betta-betta house for di town
13 pôs fogo no templo do Senhor, no palácio real, e em todas as casas da cidade, e entregou às chamas as casas dos maiorais.
14 and en sojas kon skata di town wall.
14 Em seguida, as tropas dos caldeus, que acompanhavam o chefe da guarda, demoliram as muralhas que cercavam Jerusalém.
15 Den Nebuzaradan karry di pipol wey remain for di town go Babilon as slave. Di pipol wey remain for di town, na di kraftmen and doz wey ready to serve Babilon king.
15 E Nabuzardã, chefe da guarda, deportou para Babilônia uma parte dos pobres da terra e o que restara da população da cidade, bem como os que já se haviam rendido ao rei de Babilônia e o restante dos artífices.
16 But e leave some poor pipol for Judah make dem kare for di vineyards and farms.
16 O chefe da guarda deixou ali alguns homens pobres, como vinhateiros e lavradores.
17 Babilon pipol break di two bronze pilas wey dey God temple front; di bronze wota pot and di big bronze basin, wey dem still dey koll, “Di Sea.” So dem karry all di bronze go Babilon.
17 Quebraram também os caldeus as colunas de bronze do templo do Senhor, juntamente com os pedestais e o mar de bronze que estava no templo, levando todo esse metal para Babilônia.
18 Dem still karry ash buckets, shovels, lamp, basins, plates and oda bronze tins wey dem dey use take make sakrifice for di temple.
18 Carregaram também cinzeiros, pás, facas, vasos e demais objetos de bronze que serviam ao culto.
19 Dem take evritin wey dem make with gold and silva: di small basin; di shako pans; di sakrifice blood basin; di ash kontaina, di lampstand, di burnt incense basin and di wine basin.
19 Carregou ainda o chefe dos guardas as bacias, os braseiros, vasos, potes, candelabros, taças, copos e colheres, e o que havia em ouro e prata.
20 Di two pilas, di Sea with di twelf bronze melu image wey dey under am and di wota pot and wetin dem karry, many well-well. Dem make and put dis tins for God temple wen King Solomon dey rule.
20 Quanto às duas colunas, ao mar, aos doze bois de bronze que as sustentavam, e aos pedestais que Salomão mandara fabricar para o templo do Senhor, difícil seria calcular o valor do bronze de todos esses objetos.
21 “Each of di pila high rish twenty-seven fit kon wide rish eight fit. Dem tick rish three inches and dem get holes.
21 A altura de uma dessas colunas era de dezoito côvados e um cordão de doze côvados cingia-lhe a volta, sendo a espessura de quatro dedos, e oco o seu interior.
22 Di bronze on-top each pila high rish seven and half fit and dem dekorate am with pomegranate kon put ornament.
22 Encimava-as um capitel de bronze de cinco côvados; uma grade de romãs, também em bronze, cercavam o alto do capitel. Era semelhante a esta a segunda coluna, com romãs em torno,
23 Na ninty-six pomegranate fruit dey for each side; di total for evritin na, one hundred pomegranate with di ornament wey dey around di top.”
23 em número de noventa e seis, e o total das romãs, em volta da grade, era de cem.
24 Nebuzaradan wey bi di ofisas oga, take Seraya wey bi di High Priest, Zefanaya wey bi di sekond priest with three shief wey dey keep di gate kon karry dem go as prisonas.
24 O chefe da guarda aprisionou o primeiro sacerdote, Saraías, e Sofonias, o segundo e os três guardas do vestíbulo.
25 From among di pipol wey dey for di town, e take one offisa wey bin dey kare for Jew sojas; seven of di king pesinal advise, di soja kommander, shief seketry and sixty oda pipol.
25 Tomou da cidade um eunuco, que era encarregado do comando dos homens de guerra, sete homens do séquito do rei que foram encontrados na cidade, o intendente do exército, encarregado do recrutamento na terra, assim como mais sessenta homens da terra que se encontravam na cidade.
26 Nebuzaradan, take all of dem go meet Babilon king for Riblah.
26 Nabuzardã, chefe da guarda, aprisionou-os e mandou-os conduzir a Rebla, ante o rei de Babilônia.
27 So Babilon king kill all of dem for Riblah wey dey Hamat land.
27 E este mandou executá-los em Rebla, na região de Emat. E assim Judá foi deportado para longe de sua terra.
28 Di pipol wey Nebukadnezzar karry as prisonas for di sevent year wey e bi king for Babilon, na 3,000 and twenty three.
28 Eis o número dos homens que Nabucodonosor levou ao cativeiro: no sétimo ano, 3.032 homens de Judá;
29 Den for en eighteent year for di throne, e karry eight hundred and thirty-two pipol from Jerusalem.
29 no décimo oitavo ano de Nabucodonosor, 832 pessoas foram deportadas de Jerusalém;
30 And wen e don rule for twenty-three years, e send Nebuzaradan go karry seven hundred and forty-five pipol kom. So all di pipol wey dem karry as prisonas na, 4,600.
30 no vigésimo terceiro ano de Nabucodonosor, Nabuzardã, chefe dos guardas, deportou de Judá 745 pessoas. Ao todo, 4.600 pessoas.
31 For di year wey dem make Evil-Merodak king for Babilon, e sorry for King Jehoiashin for Judah kon release am from prison. Dis tin happen for di twenty-five day for di twelft mont for di thirty-seven year afta dem take Jehoiashin go Babilon as prisona.
31 No trigésimo sétimo ano do cativeiro de Joaquin, rei de Judá, no vigésimo quinto dia do décimo segundo mês, Evilmerodac, rei de Babilônia, no ano de sua elevação ao trono, perdoou Joaquin, rei de Judá, e mandou libertá-lo da prisão.
32 King Evil-Merodak follow Jehoiashin tok well kon gi-am pozishon wey pass di oda kings wey dem karry kom Babilon as prisonas.
32 Falando-lhe com benevolência, designou-lhe um trono mais elevado que o dos reis que estavam com ele em Babilônia.
33 So e allow Jehoiashin shange en prison klot, den Jehoiashin kon always dey chop from di king tabol until di day wen e die.
33 Mandou que lhe mudassem as vestes de prisioneiro e, até o fim de sua vida, Joaquin comeu à mesa do rei da Babilônia.
34 Babilon king dey gi-am evritin wey e wont until di day wen e die.
34 Durante toda a sua vida, até o dia de sua morte, sua manutenção foi garantida pelos cuidados do rei de Babilônia.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 52, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.