Jeremias 44

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 God tell mi about Israel pipol wey dey stay for Migdol, Tahpanhes, Memfis and all di oda towns wey dey Egypt sout.
1 Palavra que veio a Jeremias, acerca de todos os judeus moradores da terra do Egito, em Migdol, em Tafnes, em Mênfis e na terra de Patros, dizendo:
2 Israel God wey dey mighty sey, “Yu yorsef don si di way I take distroy Jerusalem and all di oda towns wey dey Judah. Dia town still skata and dem nor get hope again,
2 Assim diz o Senhor dos Exércitos, Deus de Israel: Vistes todo o mal que fiz cair sobre Jerusalém e sobre todas as cidades de Judá; e eis que hoje são elas uma desolação, e ninguém habita nelas,
3 bikos dem sin kon make mi vex. Dem offa sakrifice kon dey serve oda gods wey dem or yu or dia grand-grand papa nor ever woship.
3 por causa da maldade que fizeram, para me irarem, indo queimar incenso e servir a outros deuses que eles nunca conheceram, eles, vós e vossos pais.
4 I dey send my savants and di profets kom meet dem, so dat dem go stop all dis wiked tins wey I hate,
4 Todavia, começando eu de madrugada, lhes enviei os meus servos, os profetas, para lhes dizer: Não façais esta coisa abominável que aborreço.
5 but dem nor gri listin or hear mi. Dem still dey offa sakrifice give oda gods.
5 Mas eles não obedeceram, nem inclinaram os ouvidos para se converterem da sua maldade, para não queimarem incenso a outros deuses.
6 Na dis make mi pour my fire and vexnashon for Judah towns and all di street for Jerusalem. As e bi naw, dia life don skata and pipol wey si dem, dey fear.
6 Derramou-se, pois, a minha indignação e a minha ira, acenderam-se nas cidades de Judá e nas ruas de Jerusalém, que se tornaram em deserto e em assolação, como hoje se vê.
7 “So, mi wey bi Israel God dey ask, ‘Wetin make una dey distroy unasef? Nobody among una wey kom here from Judah go survive: weda na man or woman, pikin or di shidren wey dem just born. Dem go distroy all of una finish.
7 Agora, pois, assim diz o Senhor , Deus dos Exércitos, o Deus de Israel: Por que fazeis vós tão grande mal contra vós mesmos, eliminando homens e mulheres, crianças e aqueles que mamam do meio de Judá, a fim de que não vos fique resto algum?
8 Why una dey woship juju and sakrifice give Egypt gods? Na bikos una dey stay der? Abi una nor know sey una dey make mi vex? Una dey distroy unasef and na dis make all di nashons for di eart dey trit una anyhow kon use una name as curse!
8 Por que me irritais com as obras de vossas mãos, queimando incenso a outros deuses na terra do Egito, aonde viestes para morar, para que a vós mesmos vos elimineis e para que vos torneis objeto de desprezo e de opróbrio entre todas as nações da terra?
9 Una don forget all di wiked tins wey una grand-grand papa, Judah kings, dia wife, una and una wife do for Judah town and Jerusalem strits?
9 Esquecestes já as maldades de vossos pais, as maldades dos reis de Judá, as maldades das suas mulheres, as vossas maldades e as maldades das vossas mulheres, maldades cometidas na terra de Judá e nas ruas de Jerusalém?
10 But till naw, una neva gri honbol unasef. Una neva honor mi or live una life as I kommand una and una grand-grand papa.
10 Não se humilharam até ao dia de hoje, não temeram, não andaram na minha lei nem nos meus estatutos, que pus diante de vós e diante de vossos pais.
11 “ ‘Bikos of dis, mi wey bi Israel God, go turn against una kon distroy Judah.
11 Portanto, assim diz o Senhor dos Exércitos, o Deus de Israel: Eis que voltarei o rosto contra vós outros para mal e para eliminar a todo o Judá.
12 Den, Judah pipol wey remain, wey don make up dia mind sey dem won go Egypt, I go make sure sey, dem distroy dem finish. Both big and small go die for Egypt; weda na for war or honga. Pipol go si dem dey fear and dem go trit dem anyhow kon use dia name as curse.
12 Tomarei o resto de Judá que se obstinou em entrar na terra do Egito para morar, onde será ele de todo consumido; cairá à espada e à fome; desde o menor até ao maior perecerão; morrerão à espada e à fome; e serão objeto de maldição, espanto, desprezo e opróbrio.
13 I go ponish all di pipol wey dey Egypt, just as I take war, honga and diziz take ponish Jerusalem pipol.
13 Porque castigarei os que habitam na terra do Egito, como o fiz a Jerusalém, com a espada, a fome e a peste,
14 Judah pipol wey kom stay Egypt, nobody among dem go eskape or survive. Nobody among dem go-go back to Judah, wey dem like to go stay again. Nobody go-go back, escept some slave.’ ”
14 de maneira que, dos restantes de Judá que vieram à terra do Egito para morar, não haverá quem escape e sobreviva para tornar à terra de Judá, à qual desejam voltar para morar; mas não tornarão senão alguns fugitivos.
15 Den all di men wey know sey dia wife dey offa sakrifice give oda gods and di wimen wey stand der with Israel pipol wey dey stay for Egypt sout, all of dem kon gada kom tell mi sey,
15 Então, responderam a Jeremias todos os homens que sabiam que suas mulheres queimavam incenso a outros deuses e todas as mulheres que se achavam ali em pé, grande multidão, como também todo o povo que habitava na terra do Egito, em Patros, dizendo:
16 “Wi nor go listin to wetin yu tell us sey na God tell yu.
16 Quanto à palavra que nos anunciaste em nome do Senhor , não te obedeceremos a ti;
17 Instead, wi go do evritin wey won do. Wi go offa sakrifice give awa goddes wey bi Heaven Kween kon pour wine for am too, just as wi, awa grand-grand papa, awa king and leaders dey do for Judah towns and Jerusalem strits before. Dat time, wi get plenty food to chop; wi dey prosper and wi nor get wahala.
17 antes, certamente, toda a palavra que saiu da nossa boca, isto é, queimaremos incenso à Rainha dos Céus e lhe ofereceremos libações, como nós, nossos pais, nossos reis e nossos príncipes temos feito, nas cidades de Judá e nas ruas de Jerusalém; tínhamos fartura de pão, prosperávamos e não víamos mal algum.
18 But since wi stop to sakrifice and pour wine give Heaven Kween, wi nor get anytin again and war with honga don early kill awa pipol finish.”
18 Mas, desde que cessamos de queimar incenso à Rainha dos Céus e de lhe oferecer libações, tivemos falta de tudo e fomos consumidos pela espada e pela fome.
19 Di wimen still sey, “Before wi bake kake wey bi like Heaven Kween or offa sakrifice or gi-am wine, wi dey first tell awa husband and dem dey gri with evritin wey wi dey do.”
19 Quando queimávamos incenso à Rainha dos Céus e lhe oferecíamos libações, acaso, lhe fizemos bolos que a retratavam e lhe oferecemos libações, sem nossos maridos?
20 Den I tell all di men and wimen wey ansa mi like dis sey,
20 Então, disse Jeremias a todo o povo, aos homens e às mulheres, a todo o povo que lhe tinha dado esta resposta, dizendo:
21 “Una tink sey God nor know sey una and una grand-grand papa with una kings, ofisas and all di pipol dey burn incense give juju for Judah town and all di street for Jerusalem?
21 Quanto ao incenso que queimastes nas cidades de Judá e nas ruas de Jerusalém, vós e vossos pais, os vossos reis e os vossos príncipes e o povo da terra, acaso, não se lembrou disso o Senhor , nem lhe andou isso pela mente?
22 Bikos God nor fit bear all di yeye tins wey una dey do, na dis make am turn una land to where pipol dey curse. E don skata am and pipol nor dey stay der again.
22 O Senhor já não podia por mais tempo sofrer a maldade das vossas obras, as abominações que cometestes; pelo que a vossa terra se tornou deserta, um objeto de espanto e de desprezo e desabitada, como hoje se vê.
23 All dis tins happen to una, bikos una offa sakrifice give oda gods kon sin against God wen una nor gri obey wetin E kommand.”
23 Pois queimastes incenso e pecastes contra o Senhor , não obedecestes à voz do Senhor e na sua lei e nos seus testemunhos não andastes; por isso, vos sobreveio este mal, como hoje se vê.
24 Den I tell all di pipol, especially di wimen, “Wetin Israel God wey dey mighty tok about Judah pipol wey dey Egypt?
24 Disse mais Jeremias a todo o povo e a todas as mulheres: Ouvi a palavra do Senhor , vós, todo o Judá, que estais na terra do Egito:
25 Una and una wifes don promise Heaven Kween sey una go offa sakrifice kon gi-am wine and una don do as una tok. No problem at-all! Make una keep una word kon do wetin una promise!
25 Assim fala o Senhor dos Exércitos, o Deus de Israel, dizendo: Vós e vossas mulheres não somente fizestes por vossa boca, senão também que cumpristes por vossas mãos os vossos votos, a saber: Certamente cumpriremos os nossos votos, que fizemos, de queimar incenso à Rainha dos Céus e de lhe oferecer libações. Confirmai, pois, perfeitamente, os vossos votos, sim, cumpri-os.
26 But naw, make una listin to di promise wey mi, God make with my strong name and dis promise na for Israel pipol wey dey Egypt: ‘I nor go ever let una use my name take make promise again or sey, “I swear with God wey get pawa!”
26 Portanto, ouvi a palavra do Senhor , vós, todo o Judá, que habitais na terra do Egito: Eis que eu juro pelo meu grande nome, diz o Senhor , que nunca mais será pronunciado o meu nome por boca de qualquer homem de Judá em toda a terra do Egito, dizendo: Tão certo como vive o Senhor Deus.
27 I go make sure sey, una nor prosper and dem go distroy una finish. Diziz and war go kill una, until nobody go remain again.
27 Eis que velarei sobre eles para mal e não para bem; todos os homens de Judá que estão na terra do Egito serão consumidos à espada e à fome, até que se acabem de todo.
28 But some of una go eskape from Egypt kon go back to Judah. Den, doz wey survive go know wish pesin word happen. Weda na my own or dia own.
28 Os que escaparem da espada tornarão da terra do Egito à terra de Judá, poucos em número; e todos os restantes de Judá que vieram à terra do Egito para morar saberão se subsistirá a minha palavra ou a sua.
29 Mi wey bi God go show una sign sey I go ponish una for dis place and as I promise sey I go distroy dis place, na so e go bi.
29 Isto vos será sinal de que eu vos castigarei neste lugar, diz o Senhor , para que saibais que certamente subsistirão as minhas palavras contra vós outros para mal.
30 Just as I give Zedekaya for Judah to King Nebukadnezzar for Babilon, na so too I go give King Hofra for Egypt to en enemies.’ ”
30 Eis o sinal, diz o Senhor : Eu entregarei o Faraó-Hofra, rei do Egito, nas mãos de seus inimigos, nas mãos dos que procuram a sua morte, como entreguei Zedequias, rei de Judá, nas mãos de Nabucodonosor, rei da Babilônia, que era seu inimigo e procurava tirar-lhe a vida.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 44, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.