Jeremias 42
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Den all di sojas oga with Johanan wey bi Kareah pikin and Jezanaya wey Hoshaaya born kom with oda pipol
1 Então todos os chefes do exército e Joanã, filho de Careá, e Azarias , filho de Hosaías, e pessoas de todas as classes
2 kon tell mi: “Abeg, make yu do wetin wi won tell yu so! Make yu help us wey dey alive pray to di Oga awa God. Wi many before, but naw, yusef dey si sey wi nor many again.
2 vieram falar comigo. Disseram o seguinte: — Por favor, Jeremias, atenda o nosso pedido: ore ao
3 Make yu pray make di Oga awa God show us where wi go-go and wetin wi go do.”
3 Ore ao Senhor , seu Deus, para que mostre o caminho que devemos seguir e o que devemos fazer.
4 So, I ansa, “No wahala! I go pray to di Oga awa God just as una tok, den I go tell una anytin wey E tok! I nor go hide anytin from una!”
4 Eu respondi: — Está bem! Vou orar ao
5 Den dem tell mi, “Make God wey dey tok true and dey faithful, bi awa witness if wi nor do wetin E sey make yu tell us.
5 Então eles disseram: — Que o
6 Weda wi like wetin God tok or not, wi go obey di Oga awa God wey wi sey make yu help us pray to. Bikos wi know sey, if wi obey am, evritin go dey well for us.”
6 Gostemos ou não dessas ordens, nós obedeceremos ao Senhor , nosso Deus, com quem você vai falar em nosso favor. Se obedecermos ao Senhor , tudo correrá bem para nós.
7 Afta ten days, God tok to mi,
7 Dez dias depois, o Senhor Deus falou comigo.
8 so I kon koll Johanan, di sojas offisa, doz wey dey with am and di oda pipol.
8 Aí chamei Joanã, filho de Careá, e todos os chefes do exército que estavam com ele, e todo o povo — pessoas de todas as classes —
9 I tell dem, “Di Oga wey bi Israel God wey una sey make I pray give, dis na wetin E tok:
9 e disse: — O
10 ‘If una ready to stay for dis land, I go build una up and una nor go skata again; I go plant una and nor-tin go fit rut una again. Na pains and sorrow full my heart, bikos of di wahala wey I kause for una.
10 “Se vocês quiserem continuar a viver nesta terra, eu edificarei a nação e não a destruirei; plantarei e não arrancarei. A destruição que fiz cair sobre vocês me deixou muito triste.
11 Make una nor fear Babilon king; I dey with una and I go save una from en pawa.
11 Não tenham mais medo do rei da Babilônia, pois estou com vocês. Eu os salvarei e os livrarei do poder dele. Sou eu, o Senhor , quem está falando.
12 I go show una mesi. So, I go make am sorry for una kon allow una go back to una own land.
12 Terei pena de vocês e farei com que ele também tenha e deixe que vivam nesta terra.”
13 “But if una sey, ‘Wi nor won stay for dis land!’ Den una dey disobey di Oga una God.
13 — ausente —
14 Make una nor sey, ‘No! E betta make wi go Egypt instead of us to stay dis land, bikos for der, wi go dey free from war and food plenty for der wey wi go chop.’
14 — ausente —
15 If una wey remain for Judah do like dat, den make una hear wetin Israel God dey tok, ‘If una don gri sey una won go stay for Egypt,
15 — ausente —
16 den di war wey una dey fear, go happen and honga go kill una for der.
16 então vão ter de enfrentar a guerra, de que vocês têm medo. A fome que vocês temem vai segui-los, e vocês morrerão no Egito.
17 Na war, honga and diziz go kill all di pipol wey gri sey dem won go stay Egypt. No one among dem go survive or eskape di wahala wey I go bring for dem.’
17 Todos os que estiverem resolvidos a viver no Egito morrerão na guerra, ou de fome, ou de doença. Não sobrará ninguém; ninguém escapará da desgraça que farei cair sobre vocês.”
18 Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’
18 — O Senhor Todo-Poderoso, o Deus de Israel, diz: “Se vocês forem para o Egito, a minha ira e o meu furor cairão sobre vocês como caíram sobre o povo de Jerusalém. Vocês vão se tornar uma coisa horrível e espantosa. Os outros zombarão de vocês e usarão o seu nome para rogar pragas. E vocês nunca mais verão este lugar.”
19 “I still tell dem, ‘God don tell una wey remain for Judah sey make una nor go Egypt.’ So I dey warn una,
19 E eu disse ainda: — O
20 make una nor make big mistake. Na una sey make I pray give di Oga awa God and una promise sey una go do evritin wey E kommand.
20 Vocês estão cometendo um erro que pode lhes custar a vida. Vocês me mandaram falar com o Senhor , nosso Deus, e me disseram: “Ore ao Senhor por nós. Depois, conte-nos tudo o que ele disser que devemos fazer, e nós faremos.”
21 And naw, I don tell una, but una nor one gri do evritin wey God sey make I tell una.
21 Agora, eu lhes contei tudo, mas vocês não estão obedecendo ao Senhor , nosso Deus, em nada do que ele me mandou dizer.
22 So make una remember sey; una go die for war and honga and diziz go kill una for di land wey una dey run go stay.”
22 Portanto, lembrem disto: vocês vão morrer na guerra, ou de fome, ou de doença na terra para onde querem ir e onde querem viver.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 42, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.