Jeremias 38
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Shefataya wey bi Mattan pikin; Gedalaya wey Pashhur born; Jehucal wey bi Shelemaya pikin and Pashhur wey Malkijah born kon hear wen I dey tell di pipol sey,
1 Certa vez, Sefatias, filho de Matã, e Gedalias, filho de Pasur, e Jucal, filho de Selemias, e Pasur, filho de Malquias, ouviram o que eu estava dizendo ao povo. Eu dizia que
2 “God sey, ‘Anybody wey stay for di town go die for war or honga or diziz go kill-am. But di pipol wey go-go surenda give Babilon pipol, nor go die; dem go eskape with dia life.’ ”
2 o Senhor Deus tinha dito o seguinte: — Quem ficar na cidade morrerá em combate, ou de fome, ou de doença. Mas aquele que sair e se entregar aos babilônios não será morto; pelo menos, escapará com vida e continuará a viver.
3 Dem still hear wen I sey, “God sey, ‘I go give Babilon sojas dis town and dem go seize am.’ ”
3 Eu estava dizendo que o Senhor também tinha dito isto: — Certamente entregarei esta cidade ao exército do rei da Babilônia, e ele a conquistará.
4 Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”
4 Então as autoridades disseram ao rei: — Este homem tem de morrer. Falando desse jeito, ele está tirando a coragem dos soldados que estão na cidade e desanimando todo o povo. Este homem não está procurando ajudar; o que ele quer é a desgraça de todos.
5 King Zedekaya ansa, “No wahala, make una do am anytin wey una like and I nor go stop una.”
5 O rei Zedequias disse: — Muito bem! Façam o que quiserem com Jeremias. Eu não posso segurar vocês.
6 So dem tie mi with rope kon drop mi small-small for inside Prince Malkijah well wey dey di palis. Di well dry bikos wota nor dey inside.
6 Então eles me pegaram e me puseram dentro do poço que havia no pátio da guarda e que era do príncipe Malquias. Eles me desceram com cordas. Não havia água no poço; só lama; e eu me atolei na lama.
7 Ebed Melek, one Ethiopia man wey dey work for di palis, hear sey dem put mi for di well. And by dat time, di king get kase wey e won judge for Benjamin Gate.
7 — ausente —
8 So Ebed Melek go der go tell di king,
8 — ausente —
9 “My oga, wetin dis men do so, nor good o-o. Dem don put Jeremaya inside well, where dem know sey honga go kill-am, bikos food nor dey di town.”
9 — Ó rei, meu senhor, o que aqueles homens fizeram está errado. Jogaram Jeremias no poço, e ele na certa vai morrer de fome, pois não há mais comida na cidade.
10 Den di king sey make Ebed Melek take thirty men follow body, so dat dem go-go bring mi kom out from di well before I go die for der.
10 Aí o rei deu ordem para Ebede-Meleque levar trinta homens dali e me tirar do poço antes que eu morresse.
11 So Ebed Melek and di men kon go di store where dem dey keep tins for di palis kon kollect old klot, tie am join rope kon trow am give mi.
11 Então Ebede-Meleque levou os homens ao depósito do palácio. Pegou alguns trapos e roupas usadas e os desceu por meio de cordas para dentro do poço onde eu estava.
12 E sey make I put di klot for under my armpit, so dat di rope nor go wound mi. So I do as e tok,
12 E disse: — Jeremias, ponha esses trapos debaixo dos braços para que as cordas não machuquem você. Eu fiz o que ele mandou.
13 den dem drag mi kom out kon take mi go di kourtyard.
13 Então me puxaram com as cordas e me tiraram do poço. Depois disso, fiquei no pátio da guarda.
14 One day, King Zedekaya sey make dem bring mi kom meet am for di third gate wey dem dey pass enter di temple, den e sey, “I won ask yu kweshon and I wont make yu tell mi di whole trut.”
14 O rei Zedequias mandou que me levassem até a terceira entrada do Templo, onde ele estava. Então disse: — Jeremias, vou lhe fazer uma pergunta e não quero que você esconda nada de mim.
15 But I ansa, “If I tell yu di trut, yu go kill mi and if I advise yu, yu nor go listin.”
15 Eu respondi: — Se eu disser a verdade, o senhor me matará; e, se eu lhe der conselhos, o senhor não ouvirá.
16 So King Zedekaya promise mi for sekret sey, “I swear with God wey dey alive and wey give us life sey, I nor go kill or give yu to di men wey won kill yu.”
16 Aí o rei Zedequias me prometeu, em segredo, o seguinte: — Pelo
17 Den I tell Zedekaya, “Israel God sey, ‘Yu nor go die if yu surenda give Babilon king and dem nor go burn dis town rish groun; both yu and yor family go live.
17 Então eu disse a Zedequias que o Senhor Todo-Poderoso, o Deus de Israel, tinha dito o seguinte: — Rei Zedequias, se você se entregar aos oficiais do rei da Babilônia, você não será morto, e esta cidade não será queimada. Tanto você como a sua família ficarão vivos.
18 But if yu nor surenda, Babilon pipol go take dis land; dem go burn di town rish groun and yu nor go fit eskape from dem.’ ”
18 Porém, se você não se entregar, então esta cidade será entregue aos babilônios, e eles a queimarão. E você não escapará deles.
19 But di king ansa, “I dey fear awa own pipol wey don already surenda to Babilon king. Babilon king fit give mi to dem and dem go sofa mi.”
19 O rei Zedequias respondeu: — Mas eu tenho medo dos judeus que passaram para o lado dos babilônios. Pode acontecer que os babilônios me entreguem a esses judeus, e eles me torturem.
20 So I kon tell am, “E nor go give yu to dem. I dey beg yu make yu listin to God message, den evritin go-go well for yu and dem nor go kill yu.
20 Aí eu disse ao rei: — O senhor não será entregue a esses judeus. Por favor, obedeça à mensagem do
21 But if yu nor gri surenda, dis na wetin God show mi sey go happen:
21 Mas Deus me mostrou o que acontecerá se o senhor não quiser se entregar.
22 ‘For di vishon, I si sey, dem karry all di wimen wey remain for Judah royal palis go meet Babilon ofisas and dis na wetin dem dey tell di king:
22 Todas as mulheres que ficarem no palácio real de Judá serão levadas para os oficiais do rei da Babilônia. E elas irão dizendo assim: “O rei foi enganado e dominado pelos seus melhores amigos. E, agora que ele afundou os pés na lama, os seus amigos o abandonaram.”
23 Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”
23 Eu disse ainda: — Rei Zedequias, todas as suas mulheres e os seus filhos serão entregues aos babilônios, e o senhor também não escapará deles. O senhor será levado como prisioneiro pelo rei da Babilônia, e esta cidade será destruída pelo fogo.
24 Zedekaya kon sey, “Nor let anybody know wetin wi tok so, if not yu go die.
24 Aí Zedequias me recomendou: — Jeremias, não conte esta conversa a ninguém; se não, a sua vida correrá perigo.
25 If di ofisas hear sey I tok to yu, dem go kom ask yu wetin wi tok. Dem go promise yu sey dem nor go kill yu if yu tell dem evritin wey wi tok.
25 Se as autoridades souberem que eu estive falando com você, vão lhe perguntar o que foi que conversamos. E vão prometer que não o matarão se você lhes contar tudo.
26 But just tell dem sey yu dey beg mi make I nor send yu go back to prison, so dat yu nor go die for der.”
26 Se isso acontecer, diga que você veio me pedir que não o mandasse de volta à casa de Jônatas, pois ali você morreria.
27 So all di ofisas kom kweshon mi and I tell dem wetin di king sey make I tok. Nor-tin dem fit do, bikos anoda pesin nor hear wetin wi tok.
27 Então todos os oficiais vieram e me fizeram perguntas. E eu respondi como o rei havia ordenado. Eles me deixaram em paz porque não tinham ouvido nada da conversa.
28 So I dey di palis kourtyard, until di day wey dem attack and karry Jerusalem pipol go Babilon.
28 E eu fiquei ali no pátio da guarda até o dia em que Jerusalém foi tomada.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 38, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.