Jeremias 36
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 For di fourt year wey Josaya pikin, Jehoiakim bi king for Judah, God kon tell mi:
1 No quarto ano do reinado de Jeoaquim, filho de Josias, rei de Judá, o S enhor deu esta mensagem a Jeremias:
2 “Evritin wey I don tell yu about Israel, Judah and all di nashon, make yu go rite dem put for one book. Yu go rite evritin wey I tell yu from di first time wey I tok to yu, afta Josaya just bi king kon rish naw.
2 “Pegue um rolo e escreva nele todas as minhas mensagens contra Israel, Judá e as outras nações. Comece com a primeira mensagem, do tempo de Josias, e escreva todas, até hoje.
3 May bi, if Judah pipol hear di way I won take distroy dem, dem go shange from all di bad-bad tins wey dem dey do, den I go forgive all dia sin and wikedness.”
3 Talvez o povo de Judá se arrependa ao ouvir novamente todas as coisas terríveis que planejei para eles. Então perdoarei sua maldade e seus pecados”.
4 So, I koll Baruk wey bi Neraya pikin kon tell am evritin wey God tell mi and Baruk rite evritin put for one book.
4 Jeremias mandou chamar Baruque, filho de Nerias, e enquanto Jeremias ditava para ele todas as profecias que o S enhor lhe tinha dado, Baruque as escrevia no rolo.
5 Den I tell Baruk, “Dem sey make I nor enter di temple again.
5 Depois, Jeremias disse a Baruque: “Estou preso aqui e não posso ir ao templo.
6 So I wont make yu go der wen di pipol dey fast again, den read wetin I tell yu sey God tok, wey yu rite for dis book, so dat all of dem go hear am.
6 Portanto, vá você ao templo no próximo dia de jejum e leia as mensagens do S enhor que ditei para que as escrevesse no rolo. Leia as mensagens para o povo de todas as cidades de Judá que estiver no templo.
7 May bi, den dem go pray give God kon shange from di bad tins wey dem dey do, bikos God don treaten dem with en vexnashon and fire.”
7 Quem sabe eles abandonem seus maus caminhos e peçam perdão ao S enhor antes que seja tarde demais, pois o S enhor os ameaçou com sua ira ardente”.
8 So Baruk read God word for di temple, just as I tell am sey make e do.
8 Baruque, filho de Nerias, fez tudo conforme Jeremias lhe ordenou e leu as mensagens do S enhor para o povo que estava no templo.
9 For di ninet mont for di fift year wey Jehoiakim bi king for Judah, all di pipol wey dey Jerusalem and di pipol wey kom Jerusalem from Judah, kom fast for God temple.
9 Fez isso num dia de jejum sagrado, no final do outono, no quinto ano do reinado de Jeoaquim, filho de Josias. Gente de todas as cidades de Judá tinha ido a Jerusalém para participar da adoração no templo naquele dia.
10 For dat time, Baruk enter di temple kon stand for di gate wey bi Shafan pikin, Gemaraya di royal seketry room. Di room dey di Uppa Kourt near di New Gate. Den e read from di book, evritin wey I tok, so dat dem go hear am.
10 Baruque leu para todo o povo as palavras de Jeremias escritas no rolo. Estava diante da sala de Gemarias, filho do secretário Safã. A sala ficava no pátio superior do templo, perto do portão Novo.
11 Mikaya wey Shafan pikin Gemaraya born, hear wen Baruk dey read wetin God tok.
11 Quando Micaías, filho de Gemarias e neto de Safã, ouviu as mensagens do S enhor escritas no rolo,
12 So e go di kourt seketry room for di royal palis where all di ofisas dey. Elishama, di kourt seketry, Delaaya, wey bi Shemaya pikin, Elnatan wey bi Akbor pikin, Gemaraya wey Shafan born, Zedekaya wey Hananaya born and all di oda ofisas sidan for der.
12 desceu à sala do secretário no palácio onde estavam reunidos os oficiais administrativos. Lá estavam o secretário Elisama, Delaías, filho de Semaías, Elnatã, filho de Acbor, Gemarias, filho de Safã, Zedequias, filho de Hananias, e todos os outros oficiais.
13 Den Mikaya tell dem evritin wey e hear Baruk dey read give di pipol.
13 Quando Micaías lhes falou das mensagens que Baruque estava lendo para o povo,
14 So di ofisas kon send Jehudi wey Shelemaya pikin Netanaya born and na Kushi born Shelemaya. Dem sey make e go tell Baruk make e bring di book wey e from read give di pipol. So Baruk karry di book go meet dem.
14 os oficiais enviaram Jeudi, filho de Netanias, neto de Selemias e bisneto de Cusi, para dizer a Baruque: “Venha e leia as mensagens para nós também”. Então Baruque, filho de Nerias, pegou o rolo e foi até eles.
15 Dem tell am, “Make yu sidan and read wetin dey di book for us.” So Baruk read am give dem.
15 “Sente-se e leia o rolo para nós”, disseram os oficiais, e Baruque fez o que pediram.
16 Afta e read finish, dem look demsef kon dey sopraiz, so dem tell Baruk, “Wi must go tell di king about all dis tins.”
16 Quando ouviram as mensagens, olharam uns para os outros assustados. “Precisamos relatar ao rei o que ouvimos”, disseram a Baruque.
17 Den dem ask am, “Tell us, how yu take rite dis tins, na Jeremaya tell yu?”
17 “Mas, primeiro, diga-nos como você recebeu essas mensagens. Vieram diretamente de Jeremias?”
18 Baruk ansa, “Na Jeremaya tell mi evritin wey I rite with ink for dis book.”
18 Baruque explicou: “Jeremias as ditou e eu as escrevi com tinta neste rolo, palavra por palavra”.
19 Den dem tell am, “Yu and Jeremaya must go hide and make una nor let anybody know where una dey.”
19 “Você e Jeremias devem se esconder!”, os oficiais disseram a Baruque. “Não digam a ninguém onde estão.”
20 Di ofisas put di book for Elishama, di kourt seketry room, den kon go tell di king evritin wey Baruk tok.
20 Então os oficiais deixaram o rolo guardado na sala do secretário Elisama e foram contar ao rei o que tinham ouvido.
21 Den di king tell Jehudi, “Make yu bring di book kom.” So, Jehudi go bring di book kom from Elishama room kon read am give di king and en ofisas wey stand round am.
21 O rei mandou Jeudi buscar o rolo. Jeudi o levou da sala do secretário Elisama e o leu para o rei e para todos os oficiais presentes.
22 Dat time, na rainin sizin, so di king sidan for front of fire for en palis.
22 Era final do outono, e o rei estava numa parte do palácio usada durante o inverno, sentado diante de um braseiro para se aquecer.
23 As Jehudi read three or four line finish, di king vex, kut dat part for di book komot with knife kon trow am for di fire. Na so e do until e burn di whole book finish.
23 Cada vez que Jeudi terminava de ler três ou quatro colunas, o rei pegava uma faca, cortava aquela parte do rolo e a jogava no fogo. Assim, pedaço por pedaço, o rolo inteiro foi queimado.
24 But even as di king and all en ofisas hear evritin, dem nor still fear or turn from sin kom meet God.
24 Nem o rei nem seus servos mostraram qualquer sinal de medo ou remorso diante do que tinham ouvido.
25 Even doh Elnatan, Delaaya and Gemaraya beg di king sey make e nor burn di book, e nor listin to dem.
25 Mesmo quando Elnatã, Delaías e Gemarias imploraram ao rei que não queimasse o rolo, ele não lhes deu atenção.
26 Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.
26 Em seguida, o rei ordenou a seu filho Jerameel, a Seraías, filho de Azriel, e a Selemias, filho de Abdeel, que prendessem o profeta Jeremias e seu secretário, Baruque. O S enhor , porém, os tinha escondido.
27 Afta King Jehoiakim don burn di book wey I tell Baruk make e rite, God kon tell mi
27 Depois que o rei havia queimado o rolo no qual Baruque tinha escrito as palavras de Jeremias, o S enhor deu esta mensagem a Jeremias:
28 sey make I take anoda book, rite evritin wey dey di first one wey King Jehoiakim burn.
28 “Pegue outro rolo e escreva novamente tudo que estava no primeiro rolo, que o rei Jeoaquim queimou.
29 God sey make I tell di king: “Yu don burn di book kon dey ask Jeremaya, ‘Why yu sey Babilon king go kom distroy dis land, kill evribody and all di animal?’
29 Depois, diga ao rei: ‘Assim diz o S enhor : Você queimou o rolo porque ele dizia que o rei da Babilônia destruiria esta terra e acabaria com as pessoas e os animais.
30 But naw, mi wey bi God dey tell yu, King Jehoiakim sey, ‘Yor shidren and shidren-shidren nor go ever rule for David throne. Dem go trow yor dead body for under sun and kold go make am block for nite.
30 Agora, assim diz o S enhor a respeito de Jeoaquim, rei de Judá: Ele não terá herdeiros para se sentarem no trono de Davi. Seu corpo será lançado fora e não será enterrado; ficará exposto ao calor do dia e à geada da noite.
31 I go ponish yu, yor shidren-shidren and all yor ofisas, bikos of di sin wey all of una kommit. Yu or Jerusalem and Judah pipol nor gri listin to my warnin. So I go bring di wahala wey I bin tell una about, kom.’ ”
31 Castigarei o rei, sua família e seus servos por seus pecados. Derramarei sobre eles e sobre todos os habitantes de Jerusalém e de Judá todas as calamidades que prometi, pois não quiseram dar ouvidos às minhas advertências’”.
32 So, I take anoda book kon gi-am to my seketry, Baruk and e rite evritin wey I tell am. E rite evritin wey dey di first won kon add some oda ones wey I sey make e rite, join am.
32 Então Jeremias pegou outro rolo e ditou novamente a seu secretário, Baruque, filho de Nerias. Escreveu tudo que estava no rolo que o rei Jeoaquim havia queimado. Dessa vez, porém, acrescentou muitas outras coisas.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 36, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.