Jeremias 35
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Wen Josaya pikin Jehoiakim bi king for Judah, God kon tell mi,
1 Quando Jeoaquim, filho de Josias, era rei de Judá, o Senhor Deus me disse:
2 “Make yu go Rekab town go tok to di pipol, den make yu bring dem kom one of di room for di temple kon give dem wine drink.”
2 — Jeremias, vá procurar a família dos recabitas e fale com eles. Depois, leve-os a uma das salas do Templo e lhes ofereça vinho.
3 So I go meet Jaazanaya (anoda Jeremaya pikin and Habazzinah grand-pikin) and en brodas with en shidren, plus evribody wey dey Rekab town kon take dem
3 — ausente —
4 enter di temple. I take dem enter di room where Igdalaya pikin, Profet Hanan disciples dey stay. Di room dey near where di offisa for di temple dey stay and Maaseaya wey Shallum born, wey dey guide di temple, dey stay for di room wey dey up, inside di temple.
4 — ausente —
5 Den I put cup and basin wey wine full for Rekab pipol front kon tell dem, “Make una take wine drink.”
5 Depois, coloquei diante dos recabitas jarras cheias de vinho e copos e disse: — Tomem um pouco de vinho.
6 But dem ansa, “Wi nor dey drink wine, bikos awa grand-grand papa Jehonadab wey Rekab born tell us sey, make wi nor ever drink wine.”
6 Mas eles responderam: — Nós não bebemos vinho, pois o nosso antepassado Jonadabe, filho de Recabe, deu a seguinte ordem: “Nunca bebam vinho, nem vocês nem os seus descendentes.
7 E still tell us sey, make wi nor build house, plant anytin or buy any vineyard for awasef. E kommand us sey make wi dey stay for tent, so dat wi go fit stay for dis land wey wi dey stay like strenjas.
7 Não construam casas, nem cultivem a terra. Não façam, nem comprem plantações de uva. Não tenham lugar certo para morar. Morem em barracas a vida toda para que assim vivam muito tempo nesta terra.”
8 “So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine;
8 E nós temos obedecido a todas as ordens do nosso antepassado Jonadabe, filho de Recabe. Nunca bebemos vinho, nem nós, nem nossas esposas, nem nossos filhos e filhas. Não construímos casas para morar: moramos em barracas. Não temos plantações de uva, nem terras, nem sementes. Temos obedecido a tudo o que o nosso antepassado Jonadabe ordenou.
9 build house for awasef; get vineyard or plant.
9 — ausente —
10 Na tent wi dey stay and wi dey obey evritin wey Jehonadab awa grand-grand papa, kommand us.
10 — ausente —
11 But wen King Nebukadnezzar for Babilon skata di land, wi sey make wi kom Jerusalem, so dat wi go fit eskape from Babilon and Siria sojas. Na dis make wi dey stay for Jerusalem naw.”
11 Mas, quando o rei Nabucodonosor, da Babilônia, invadiu o país, resolvemos vir a Jerusalém para fugir dos exércitos babilônios e sírios. É por isso que estamos vivendo aqui. — Eu, o
12 Den Israel God wey dey mighty
12 — ausente —
13 sey make I go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “Mi wey bi God, dey ask una wetin make una nor gri listin to mi kon obey evritin wey I kommand.
13 — ausente —
14 But Jehonadab shidren-shidren obey wetin e kommand, wen e sey make dem nor drink wine. And until naw, dem neva drink wine. Even doh I dey always tok to una, una nor gri obey mi.
14 Os descendentes de Jonadabe têm obedecido à sua ordem de não beber vinho. E até hoje nenhum deles bebe, pois todos obedecem ao mandamento que ele deu. Mas eu sempre tenho falado a vocês, e vocês não têm obedecido.
15 I send my savant, di profets kom meet una sey make una stop di bad tins wey una dey do kon do di korrect tin. Dem warn una sey make una nor woship and serve oda gods, so dat una go kontinue to stay for dis land wey I give una and una grand-grand papa, but una nor gri listin or hear dem.
15 Tenho sempre mandado todos os meus servos , os profetas, e eles têm ordenado que vocês abandonem os seus maus caminhos e façam o que é certo. Eles avisaram que vocês não deviam adorar, nem servir outros deuses para que assim pudessem continuar a viver na terra que dei a vocês e aos seus antepassados. Mas vocês não quiseram me ouvir, nem obedecer.
16 Yes, Jehonadab shidren-shidren obey wetin e kommand dem, but una nor gri obey mi.
16 Os descendentes de Jonadabe têm obedecido ao mandamento que o seu antepassado lhes deu; no entanto, vocês, o meu povo, não me têm obedecido.
17 So, mi wey bi Israel God dey sey, ‘I go distroy Judah and Jerusalem pipol, even don I bin don promise dem good tins. I go do am, bikos una nor dey gri listin to anytin wey I tok and wen I koll una, una nor dey ansa.’ ”
17 Por isso, eu, o Senhor Todo-Poderoso, o Deus de Israel, mandarei sobre vocês, povo de Judá e de Jerusalém, toda a destruição que prometi. Farei isso porque não quiseram me obedecer quando lhes falei e não quiseram responder quando os chamei.
18 Den I tell Rekab pipol: “Israel God wey dey mighty sey, ‘Una don obey evritin wey una grand-grand papa Jehonadab tell una; dey follow evritin wey e tish una and una don do evritin wey e kommand una.’ ”
18 Então eu disse à família dos recabitas que o Senhor Todo-Poderoso, o Deus de Israel, tinha dito o seguinte: — Vocês têm obedecido ao mandamento do seu antepassado Jonadabe, têm respeitado todas as suas ordens e feito tudo o que ele mandou.
19 So mi, wey bi Israel God promise sey, “Jehonadab wey bi Rekab pikin, go always get one of en sons wey go serve mi.”
19 Por isso, eu, o Senhor Todo-Poderoso, o Deus de Israel, prometo que Jonadabe, filho de Recabe, terá sempre um descendente homem para me servir.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 35, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.