Jeremias 33

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Wen I still dey prison for di kourtyard, God tok to mi again.
1 Pela segunda vez, enquanto Jeremias ainda estava detido no átrio da prisão, foi-lhe dirigida a palavra do Senhor nestes termos:
2 Na mi, God do dis tins! Na mi God, make di eart kon put am for where e dey so. Dem know mi as Oga God; naw I dey tell yu,
2 Eis o que diz o Senhor que criou {a terra}, que a modelou e consolidou e cujo nome é Javé:
3 “Koll mi wen yu dey pray and I go ansa yu; I go tell yu great and wonderful tins wey yu nor know about.
3 invoca-me, e te responderei, revelando-te grandes coisas misteriosas que ignoras.
4 Mi, di Oga wey bi Israel God sey, war and wahala go skata all di house for Jerusalem and di royal palis for Judah.
4 Portanto, eis o que diz o Senhor, Deus de Israel, a propósito das casas da cidade e dos palácios dos reis de Judá que foram demolidos para dar lugar às fortificações e às armas dos caldeus,
5 Una won go fight Babilon pipol, but una sojas nor betta pass doz wey don die, bikos as I dey vex, I don make up my mind to distroy dem. I don turn from dem, bikos of dia wikedness.
5 vindos para combater, e para enchê-las de cadáveres dos homens que firo em minha cólera, e por cuja malícia desviei minha face dessa cidade.
6 But I go heal di town and en pipol kon make dem well again. I go give dem peace forever and dem go dey save.
6 Vou pensar-lhes as feridas e curá-las, e proporcionar-lhes abundância de felicidade e segurança.
7 I go make Israel and Judah pipol prosper and I go build dem as dem bi before.
7 Transformarei a sorte de Judá e de Israel, e fá-los-ei voltar ao que eram outrora.
8 I go forgive dem dia sin. Yes! I go forgive dem all di sin wey make dem go against my kommand.
8 Purificá-los-ei de todos os pecados que contra mim cometeram, e lhes perdoarei todas as iniqüidades de que se tornaram culpados, revoltando-se contra mim.
9 Jerusalem go bring joy, honor and pride for mi and all di nashons for di world go fear wen dem hear about di good tins wey I go do for Jerusalem pipol and how I go make dia town prosper.”
9 Será para mim motivo de alegria, felicidade e glória diante de todas as nações da terra, o saberem todo o bem com que agraciei meu povo. Ficarão tomadas de receio e temor por causa desse bem e da prosperidade de que vou cumulá-lo.
10 God sey, “Una dey sey, ‘Dis place bi like desert, bikos pipol or animals nor dey stay inside again.’ Una korrect; bikos Judah town and all di street for Jerusalem go dey empty; pipol or animal nor go stay der, but una go hear pipol dey shaut dey happy for dis place again.
10 Eis o que diz o Senhor: neste lugar, do qual dizeis que não passa de um deserto sem homens nem animais; nas cidades de Judá e nas ruas de Jerusalém devastadas, onde homem algum habita, nem um animal se encontra, ouvir-se-ão novamente
11 Una go hear am kon shaut with happiness, with joy and belle go sweet una wen una dey do marriage. Una go hear pipol dey sing as dem dey kom tank mi with dia ofrin. Dem go sey, ‘Make wi tank God wey dey mighty, bikos E good well-well and en love dey forever.’ I go make dis land prosper as e bi before.
11 gritos de alegria, cânticos de júbilo, a voz do esposo e da esposa, aclamações daqueles que cantarão: louvai o Senhor dos exércitos, pois que ele é bom e eterna a sua misericórdia, ao apresentarem no templo seus sacrifícios de ação de graças, pois que restituirei a terra tal qual era outrora - oráculo do Senhor.
12 God wey mighty sey, “Dis land wey bi like desert where pipol or animals nor dey stay, I go turn am to where fresh green leaf go dey and shepad go take dia sheep go chop for der.
12 Eis o que diz o Senhor dos exércitos: Neste lugar que é deserto, sem homens nem animais, e em todas as suas cidades, haverá novamente abrigos para os pastores que apascentarão seus rebanhos.
13 Shepad go kount dia sheep again for all di towns wey dey di hill kountry; di valley; Judah sout; Benjamin land; di village wey round Jerusalem and all di town for Judah.
13 Nas cidades das montanhas, nas da planície e nas do Negeb, na terra de Benjamim, nos arredores de Jerusalém e nas cidades de Judá hão de passar ainda rebanhos pela mão do que os conta - oráculo do Senhor.
14 God sey, “Di time dey kom wen I go do wetin I promise Israel and Judah pipol.
14 Eis que outros dias virão.
15 For dat time, I go choose king wey dey raitious from David shidren-shidren.
15 E nesses dias e nesses tempos farei nascer de Davi um rebento justo que exercerá o direito e a eqüidade na terra.
16 As e dey rule, Judah pipol go dey save, while Jerusalem pipol go stay for peace. For dat time, dem go koll Jerusalem town, ‘God Don Save Us.’
16 Naqueles dias e naqueles tempos viverá Jerusalém em segurança e será chamada Javé-nossa-justiça.
17 Mi wey bi God, promise sey na only David shidren-shidren go always bi king for Israel
17 Porque diz o Senhor: Não faltará jamais a Davi um sucessor para ocupar o trono da Casa de Israel.
18 and na from only Levi tribe priest go for always kom and serve, offa burnt ofrin, korn ofrin and sakrifice for mi.”
18 E, diante de mim, não faltarão jamais descendentes aos sacerdotes e aos levitas para oferecer os holocaustos, queimar as oferendas e celebrar o sacrifício cotidiano.
19 God tell mi,
19 Nestes termos foi a palavra do Senhor dirigida a Jeremias:
20 “If yu fit break di kovenant wey I make with nite and day, so dat dem nor go kom out again for di korrect time,
20 Eis o que disse o Senhor: se puderdes romper o meu pacto com o dia e a noite, de sorte que dia e noite não surjam no devido tempo,
21 den yu go still fit break di kovenant wey I make with my savant David and Levi tribe wey sey, ‘Kings go always kom from David family and na Levi family go always bi priests.’
21 então poderá ser rompido o pacto que fiz com Davi, meu servo, e não terá ele filho que lhe ocupe o trono, e com os sacerdotes e levitas, meus ministros.
22 I go make my savant, David shidren-shidren and all di priest from Levi tribe plenty, so dat dem nor go fit kount dem, just as dem nor fit kount star for sky or san-san for wotaside.”
22 À semelhança do exército celestial, que se não pode enumerar, e como a areia do mar, que se não pode medir, assim multiplicarei a posteridade de Davi, meu servo, e os levitas, meus ministros.
23 God still tell mi sey,
23 Foi a palavra do Senhor dirigida a Jeremias nestes termos:
24 “Yu si as pipol dey sey I don rijet Israel and Judah pipol; di two family wey I choose? Na dis make dem nor dey respet my pipol at-all, bikos dem nor si dem as strong nashon again.
24 Não reparaste nas palavras que proferem esses homens? As duas famílias, dizem eles, que pelo Senhor haviam sido eleitas, foram por ele repelidas! É assim que desprezam meu povo, a ponto de, a seus olhos, não constituir mais uma nação.
25 But mi wey bi God don make kovenant with di nite and day and I don make di law wey dey kontrol di heaven and eart.
25 Eis o que diz o Senhor: se não firmei pacto com o dia e a noite, nem regulei as leis do céu e da terra,
26 Since I don do dis tin, I go keep my kovenant with my savant Jakob and David shidren-shidren. I go choose one of David shidren-shidren make e rule ova Abraham, Isaak and Jakob shidren-shidren. I go sorry for my pipol kon make dem prosper again.”
26 então poderei rejeitar a raça de Jacó e de Davi, meu servo, e abster-me de escolher da sua descendência os chefes para a raça de Abraão, de Isaac e de Jacó! Pois hei de lhes melhorar a sorte, e deles me apiedarei.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 33, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.