Jeremias 32
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 God tok to mi for di tent year wey Zedekaya bi king for Judah and dat na di eighteent year wey Nebukadnezzar dey rule Babilon.
1 No ano décimo do reinado de Zedequias em Judá, que era o ano décimo oitavo do reinado de Nabucodonosor na Babilônia, o Senhor Deus falou comigo.
2 For dat time, Babilon sojas attack Jerusalem and dem kon lock mi for di kourtyard wey dey di royal palis.
2 Nesse tempo, o exército do rei da Babilônia cercava Jerusalém, e eu estava preso no pátio do palácio real.
3 King Zedekaya put mi for prison, bikos I tell am sey, “God sey, ‘I go allow Babilon king seize dis town
3 O rei Zedequias havia mandado me prender, acusando-me de anunciar que o Senhor tinha dito o seguinte: “Eu entregarei esta cidade ao rei da Babilônia, e ele a conquistará.
4 and yu, King Zedekaya, nor go eskape. Dem go give Zedekaya to Babilon king and both of dem go tok face-to-face.
4 O rei Zedequias não escapará dos babilônios, mas será entregue ao rei deles. Zedequias verá o rei da Babilônia cara a cara e falará com ele pessoalmente.
5 Dem go take Zedekaya go Babilon and e go stay der until I don deal with am finish. Even if e fight Babilon pipol, e nor go win.
5 Será levado para a Babilônia e ficará ali até que eu cuide dele. Mesmo que lute contra os babilônios, não poderá vencer. Eu, o Senhor , estou falando.”
6 Jeremaya sey, “God tell mi sey
6 O Senhor Deus me disse
7 Hanamel wey bi yor papa broda Shallum pikin, go kom meet yu. So make yu buy en field wey dey for Anatot, for Benjamin land, bikos yu bi en klose relashon and yu get rite to buy am.
7 que Hanamel, filho do meu tio Salum, ia me procurar e pedir que eu comprasse as terras dele em Anatote. Isso porque sou o seu parente mais chegado e tenho o direito de comprá-las.
8 So, Hanamel kom meet mi for di kourtyard sey make I buy en field, just as God tok. Den, I kon know sey, God really tok to mi.
8 Então, exatamente como o Senhor tinha dito, o meu primo Hanamel me procurou no pátio da guarda e me disse: — Compre as minhas terras que ficam em Anatote, no território de Benjamim. Você é o meu parente mais chegado e por isso tem o direito de comprar essas terras e ficar com elas. Aí entendi que era Deus que estava me mandando fazer isso.
9 So I buy di field from Hanamel kon pay am seventeen pieces for silva.
9 Assim comprei as terras de Hanamel e pesei o dinheiro para ele. O preço foi de duzentos gramas de prata.
10 I sign and pipol witness evritin wey wi do, den I weigh di money for skale for am.
10 Assinei a escritura e fechei-a com um selo . Depois, chamei testemunhas e pesei o dinheiro numa balança.
11 I take di two paper wey wi sign as agriment (dem kontain di kontract and di kondishon)
11 Então peguei a cópia fechada com o selo, a qual tinha o contrato e as condições, e também a cópia aberta
12 kon gi-am to Baruk wey Mahseaya pikin Neraya born. I give dem to am for Hanamel, di witness wey sign di agriment and all Jew pipol wey sidan for di kourtyard, present.
12 e dei as duas a Baruque, filho de Nerias e neto de Maaseias. Fiz isso na frente de Hanamel, das testemunhas que assinaram a escritura e de todos os judeus que estavam sentados no pátio.
13 I tell Baruk for dia present sey,
13 Diante de todos eles, eu disse a Baruque:
14 ‘Israel God wey dey mighty don orda sey, “Make yu take di two paper kon put dem inside klay pot, so dat dem go dey save.”
14 — O Senhor Todo-Poderoso, o Deus de Israel, mandou que você pegue estas escrituras de compra, tanto a cópia fechada com o selo como a aberta, e as coloque num pote de barro para que durem muitos anos.
15 Israel God sey, “Pipol go buy many house, field and vineyard for dis land, again.” ’
15 O Senhor Todo-Poderoso, o Deus de Israel, disse que neste país ainda serão compradas casas, terras e plantações de uvas.
16 “Afta I don give Baruk di agriment paper wey I take buy di land, I kon pray,
16 Depois que dei a Baruque, filho de Nerias, a escritura de compra, eu orei assim:
17 ‘My Oga God! Na Yu kreate heaven and eart with yor mighty pawa and great strent. Nor-tin dey hard for Yu to do!
17 — Ó Senhor , meu Deus, com o teu grande poder e com a tua força, fizeste o céu e a terra. Nada é impossível para ti.
18 Yu don show betta love to many-many pipol and Yu don still ponish pipol, bikos of dia papa and mama sin. Yu bi great God wey get pawa well-well and Yu dey rule evritin.
18 Tens sido bondoso para milhares de pessoas, mas também tens castigado os filhos por causa dos pecados dos seus pais. Tu és o grande e poderoso Deus; o teu nome é , o Todo-Poderoso.
19 Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.
19 Tu fazes grandes planos e coisas maravilhosas. Tu vês tudo o que as pessoas fazem e tratas cada uma de acordo com o seu modo de agir e de viver.
20 Yu do strong and wonderful tins for Egypt and Yu still dey do dem till naw, both for Israel and for all di nashon and naw, dem don know Yu for evriwhere.
20 Fizeste milagres e maravilhas na terra do Egito e continuas a fazer o mesmo até hoje, tanto em Israel como em todas as outras nações. Por isso, agora és conhecido em toda parte.
21 Yu use yor mighty pawa and great strent take do mirakles and wonders wey make fear katch awa enemies. Na like dis Yu take bring yor pipol, Israel kom back from Egypt land.
21 Tiraste o povo de Israel da terra do Egito por meio do teu poder e da tua força e por meio de milagres e maravilhas que encheram de terror os nossos inimigos.
22 Yu give dem di rish and betta land wey Yu promise dia grand-grand papa.
22 Deste aos israelitas esta terra boa e rica, como havias prometido aos seus antepassados.
23 But wen dem kom dis land kon dey stay as dia own, dem nor kon dey obey yor kommand or do wetin Yu tish dem; dem nor do wetin Yu orda dem to do and na dis make Yu distroy dem.
23 Mas, quando eles entraram nesta terra e tomaram posse dela, não obedeceram aos teus mandamentos, nem viveram de acordo com os teus ensinamentos; não fizeram nada daquilo que havias mandado. Por isso, fizeste cair sobre eles toda esta desgraça.
24 Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.
24 — Os babilônios construíram rampas de terra em volta das muralhas da cidade a fim de invadi-la e agora estão atacando. A guerra, a fome e as doenças vão fazer a cidade cair nas mãos deles. Como vês, tudo o que disseste aconteceu.
25 Even doh Yu know sey Babilon pipol won seize di land, na Yu my Oga God, still orda sey make I go buy di field and do di agriment for pipol present.’
25 No entanto, Senhor , meu Deus, tu me mandaste comprar terras na presença de testemunhas, apesar de os babilônios estarem quase tomando a cidade.
26 “Den God ansa mi,
26 Então o Senhor me respondeu:
27 ‘Na mi bi di Oga wey bi evribody God. Nor-tin too hard for mi to do.
27 — Eu sou o Senhor , o Deus de toda a humanidade. Nada é impossível para mim.
28 So, mi wey bi God sey, “I go give dis town to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas and dem go seize
28 Por isso, vou entregar esta cidade ao rei Nabucodonosor, da Babilônia, e ao seu exército, e eles a tomarão.
29 and burn am rish groun. Dem go burn am with di house where pipol for don make mi vex, bikos dem dey burn incense give Baal juju on-top di house and dey pour wine as ofrin give oda gods.
29 Os babilônios, que estão atacando, vão entrar na cidade e pôr fogo nela. Eles queimarão as casas onde o povo me tem provocado queimando incenso ao deus Baal nos terraços e derramando bebidas como oferta a outros deuses.
30 Dis tin go happen, bikos from di biginnin kon rish naw, Israel and Judah pipol don disobey and make mi vex, bikos of wetin dem do.
30 Desde o princípio, o povo de Israel e o povo de Judá só têm feito coisas más. As suas maldades têm provocado a minha ira .
31 E go happen bikos since dem build dis town kon rish naw, di pipol for dis town don make mi vex well-well, so I go distroy am.
31 Esta cidade tem provocado a minha ira e o meu furor desde o dia em que foi construída. Eu resolvi acabar com ela
32 I go must do am, bikos of di bad-bad tins wey Judah and Jerusalem pipol don do. Bikos of di wiked tins wey dem do, I go distroy am with both dia king, leaders, priests and profets.
32 por causa de todas as maldades que têm sido feitas pelo povo de Israel e pelo povo de Judá, pelos seus reis e autoridades, pelos seus sacerdotes e profetas e pelo povo de Jerusalém.
33 Instead of dem to obey mi, dem turn dia back give mi. And even as I dey try to tish dem rish, dem nor gri learn or listin.
33 Eles me viraram as costas. E, embora eu continuasse ensinando essa gente, eles não escutaram, não aprenderam a lição, nem deram atenção às ameaças.
34 Dem even go put dia yeye juju for di temple wey dem build to woship mi and naw, dem don make am dirty.
34 Até ídolos horrorosos eles colocaram no Templo construído em meu nome e o profanaram .
35 Dem build altar for Baal juju for Ben-Hinnom Valley where dem for dey sakrifice dia shidren give Molek god. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.”
35 No vale de Ben-Hinom, eles construíram altares ao deus Baal, para ali queimar os seus filhos e as suas filhas em honra do deus Moloque . Eu não lhes dei ordem para isso e nunca pensei que eles fizessem uma coisa tão nojenta como essa e levassem o povo de Judá a pecar.
36 “ ‘Jeremaya! Yu and di pipol korrect wen una sey war, honga and diziz go make dis town fall and Babilon king go seize am. Naw, make yu listin to wetin I get to tok about dis town:
36 Depois, o Senhor , o Deus de Israel, disse o seguinte: — Jeremias, o povo anda dizendo que a guerra, a fome e as doenças vão fazer esta cidade cair nas mãos do rei da Babilônia. Agora, escute o que vou dizer!
37 “I go gada all my pipol from di kountry where I skata dem put, bikos I bin dey vex and I go bring dem back to dis land, so dat dem go dey save.
37 Vou ajuntar aqueles que na minha ira , cólera e furor eu espalhei. Eu os trarei de volta a este lugar e os deixarei viver aqui em segurança.
38 Den, dem go bi my pipol and I go bi dia God.
38 Eles serão o meu povo, e eu serei o seu Deus.
39 Di only tin wey I go let dem do for dis life: na to always dey honor mi, bikos na for dem and dia shidren-shidren good.
39 Eu lhes darei este único propósito na vida: temer sempre a mim, para o próprio bem deles e dos seus descendentes.
40 I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.
40 Vou fazer com eles esta aliança eterna: nunca deixarei de lhes fazer o bem; farei com que me respeitem com sinceridade para que nunca se afastem de mim.
41 I go happy to do good tins for dem and I go plant dem for dis land forever.
41 Terei prazer em lhes fazer o bem e com todo o meu coração e com toda a minha alma deixarei que fiquem morando nesta terra.
42 “ ‘ “Just as I bring dis wahala for dem, na so too I go give dem all di good tins wey I don promise dem.
42 — Assim como eu trouxe esta desgraça a este povo, também lhe darei todas as boas coisas que prometi.
43 Una dey sey di land go bi like desert where pipol or animals nor go dey again. Dem still sey dem go give di land to Babilon pipol. But my pipol go buy field for dis land again.
43 Jeremias, o povo anda dizendo que esta terra vai ficar como um deserto, sem gente e sem animais, e que será entregue aos babilônios. Mas eu digo que neste país ainda se comprarão terras.
44 Pipol go buy dia land and dem go sign di agriment, gum-am and pipol go witness am. Dis tins go happen for Benjamin land; di village wey dey round Jerusalem; all Judah town and for di towns wey dey di kountries for hill with all di land under di hill for Judah sout. I go bring di pipol kom back to dia land.
44 As pessoas vão comprar, assinar escrituras, fechá-las com selos e chamar testemunhas. Isso acontecerá nas terras da tribo de Benjamim, nos povoados em volta de Jerusalém, nas cidades de Judá e nas cidades das montanhas, das planícies e da região sul. Eu trarei o povo de volta ao seu país. Eu, o Senhor , falei.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 32, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.