Jeremias 29
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Dis na di leta wey I rite go give di priests, profets, leaders and all di oda pipol wey Nebukadnezzar karry as prisona from Jerusalem go Babilon.
1 Eis o teor da carta que o profeta Jeremias endereçou de Jerusalém aos demais anciãos cativos, aos sacerdotes e profetas, e a todo o povo deportado por Nabucodonosor para Babilônia,
2 I rite am afta dem don karry King Jehoiashin, en mama, di ofisas for di palis, Judah and Jerusalem leaders and doz wey know work well-well, go Babilon.
2 depois que deixaram Jerusalém, o rei Jeconias, a rainha-mãe, os eunucos, os chefes de Judá e Jerusalém e os carpinteiros e serralheiros.
3 I give di leta to Eleasah wey bi Shafan pikin and Gemaraya wey Hilkaya born and na-im King Zedekaya for Judah send go meet King Nebukadnezzar for Babilon. Dis na wetin dey di leta:
3 Foi esta carta levada por Elasa, filho de Safã, e Gamarias, filho de Helcias,os quais Sedecias, rei de Judá, enviara a Babilônia, junto ao rei Nabucodonosor, e assim dizia:
4 “Israel God wey dey mighty dey tell di pipol wey Babilon king karry from Jerusalem go as prisona sey:
4 Eis o que diz o Senhor dos exércitos, Deus de Israel, a todos os cativos que deportei de Jerusalém para Babilônia:
5 ‘Make una build house kon setol down, den plant seeds and chop anytin wey e produce.
5 construí casas e nelas morai, plantai pomares e comei seus frutos.
6 Make una marry kon born shidren. Make una shidren marry kon born shidren too, so dat una go plenty for di land.
6 Procurai mulher e gerai filhos e filhas, procurai mulheres para vossos filhos, e dai vossas filhas a maridos para que dêem ao mundo rapazes e moças. Multiplicai-vos em lugar de diminuir.
7 Make una work well-well for di town wey I send una go as prisonas and make una pray make I bless dem, bikos if dem prosper, una go prosper too.
7 Tomai a peito o bem da cidade para onde vos exilei e rogai por ela ao Senhor, porque só tereis que lucrar com a sua prosperidade.
8 Mi wey bi Israel God dey warn una. Make una nor let di profets wey dey stay among una or any oda pesin wey klaim sey e dey si tumoro, deceive una. Make una nor listin to dia dreams.
8 Pois assim disse o Senhor dos exércitos, Deus de Israel: Não vos deixeis engodar pelos profetas que se acham entre vós, nem pelos adivinhos. Não escuteis os sonhos que anunciam.
9 Dem dey lie with my name, but I dey tell una naw sey I nor send dem kom meet una.’
9 Porquanto esses homens mentem, pretendendo pronunciar oráculos em meu nome. Não lhes outorguei tal encargo - oráculo do Senhor.
10 “God sey, ‘Wen di seventy years wey I give Babilon don finish, I go kare and bring una kom back to una land, just as I promise.
10 Eis o que diz o Senhor: Quando setenta anos tiverem decorrido para Babilônia, eu vos visitarei a fim de realizar a promessa que vos fiz de aqui vos reconduzir.
11 Bikos I know wetin I plan for una; my plan na to make una prosper, nor bi to give una wahala and na to give una di kind future wey una dey hope to get.
11 Bem conheço os desígnios que mantenho para convosco - oráculo do Senhor -, desígnios de prosperidade e não de calamidade, de vos garantir um futuro e uma esperança.
12 Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una.
12 Invocar-me-eis e vireis suplicar-me, e eu vos atenderei.
13 Una go pray and woship mi with all una heart and I go dey with una.
13 Procurar-me-eis e me haveis de encontrar, porque de todo o coração me fostes buscar.
14 Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon.
14 Permitirei que me encontreis - oráculo do Senhor; e vos trarei do cativeiro e vos irei buscar em todas as nações e em todos os lugares por onde vos dispersei - oráculo do Senhor - para reintegrar-vos no lugar de onde vos exilei.
15 “Una sey, ‘God don give una profet for Babilon wey go give us good news.’
15 Objetareis, porém, que o Senhor vos suscitou profetas em Babilônia.
16 But make una listin to wetin God tok about di king wey dey rule David kingdom and di pipol for di town wey bi una relashon, wey dem nor karry as prisonas follow una.
16 Eis o que diz o Senhor a propósito do rei que ocupa o trono de Davi, do povo que permaneceu na cidade, e de todos os vossos irmãos que não partiram convosco para o exílio:
17 God wey dey mighty sey, ‘I dey bring war, honga and diziz kom meet dem and I go make dem bi like rotin fig fruit wey nobody fit chop.
17 eis o que diz o Senhor dos exércitos: vou enviar contra eles a espada, a fome e a peste, e os tratarei como figos deteriorados, tão maus que não se podem mais comer.
18 I go use war, honga and diziz take porshu dem, sotey all di oda nashons for di world go shok, fear, laf and curse dem for anywhere wey I skata dem go,
18 Persegui-los-ei com a espada, a fome e a peste, e deles farei objeto de horror ante todos os reinos da terra, exemplo a ser citado entre as maldições, assunto de espanto que fará pasmar, e vergonha aos olhos das nações para onde eu os dispersar;
19 bikos dem nor gri hear my word wey I dey always send go give dem thru my profets.
19 porque não escutaram minhas palavras - oráculo do Senhor - quando, sem cessar, lhes enviava os profetas, meus servos, aos quais também não ouviram - oráculo do Senhor.
20 All of una wey I send go Babilon as prisonas, make una listin to wetin mi wey bi God dey tok.’
20 Mas vós todos, exilados que deportei de Jerusalém para Babilônia, escutai a palavra do Senhor:
21 “Dis na wetin Israel God wey dey mighty tok about Ahab wey bi Kolaya pikin and Zedekaya wey Maaseaya born, wey dey lie for una with God name. God sey, ‘I don give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and e go kill dem for una present.’
21 eis o que diz o Senhor dos exércitos, Deus de Israel, a respeito de Acab, filho de Colias, e de Sedecias, filho de Maasias, que vos transmitem em meu nome falsos oráculos: vou entregá-los nas mãos de Nabucodonosor, rei de Babilônia, que os mandará matar ante vossos olhos.
22 So wen di pipol wey dem take from Jerusalem go Babilon won curse pesin, dem go sey, ‘Make God trit yu like Zedekaya and Ahab wey Babilon king roast alive!’
22 Servirão eles de maldição entre os judeus cativos que se acham em Babilônia. E dir-se-á: Que Deus faça contigo como a Sedecias e Acab, os quais o rei de Babilônia mandou frigir no fogo!
23 Dis na wetin go happen to dem, bikos dem sin: dem sleep with dia neighbour wife kon lie with God name. God nor like all dis tins. E know wetin dem don do and wetin dem do dey stand against dem.”
23 E isso porque cometeram uma infâmia em Israel; por consumarem o adultério com as mulheres de seus vizinhos, e ainda por haverem proferido falsos oráculos em meu nome e contra minha vontade. Tudo isso eu sei por havê-lo testemunhado - oráculo do Senhor.
24 Israel God tell Jeremaya, “Make yu go tell Shemaya wey kom from Nehelam
24 E a Semeias Neelamita dirás:
25 sey di Oga wey bi Israel God wey dey rule di nashons get message for am. Tell am sey, ‘Just as yor mind tell yu, na so too yu send leta go give Zefanaya di priest wey Maaseaya born; di oda priests and all di pipol wey dey Jerusalem.’ For yor leta, yu tell Zefanaya sey,
25 Eis o que diz o Senhor dos exércitos, Deus de Israel: já que enviaste uma carta em teu nome a todo o povo de Jerusalém, ao sacerdote Sofonias, filho de Maasias, e a todos os sacerdotes, na qual lhes dizes:
26 ‘God don make yu priest instead of Jehoiada. E put yu for en temple so dat yu go dey kontrol doz kraze pipol wey dey pritend sey dem bi profets. And na yor work to tie dat kind pesin for groun.
26 Fez-te o Senhor sacerdote em lugar do sacerdote Jojada, a fim de que vigies no templo todo fanático que se intitular profeta e o metas no cepo ou no cárcere;
27 But why yu neva do am to Jeremaya for Anatot, wey dey tell pipol sey e bi profet?
27 por que, então, não fizeste voltar à razão Jeremias de Anatot que profetiza entre vós?
28 Bikos Jeremaya tell di pipol wey dey Babilon sey, dem go stay as prisonas for long time, so make dem build house, setol down, plant and chop anytin wey dem plant.’ ”
28 Eis que nos escreve para Babilônia a fim de nos dizer: isso durará longo tempo. Construí casas e habitai-as; plantai pomares e deles comei os frutos.
29 Zefanaya di priest kon read di leta give Profet Jeremaya.
29 Leu esta carta o sacerdote Sofonias ao profeta Jeremias,
30 Den God tell Jeremaya sey,
30 ao qual falou o Senhor, nestes termos:
31 “Send message go give all di prisonas for Babilon about Shemaya. Mi wey bi God, go ponish Shemaya and all en shidren-shidren. I nor send am, but e tok to una as if en na profet and e make una bilive di lie wey e tell una.
31 Eis o que mandarás dizer a todos os deportados: oráculo do Senhor a respeito de Semeias Neelamita: porque Semeias vos proferiu oráculos, sem que eu lhos houvesse delegado, e vos levou a crer em mentiras,
32 Bikos e sey make my pipol go against mi, I go kill all en shidren-shidren and e nor go dey alive to si all di good tins wey I go do for my pipol.
32 eis o que diz o Senhor: vou usar de severidade com Semeias Neelamita e sua descendência. Nenhum dos seus subsistirá entre vós para desfrutar a felicidade que concederei a meu povo - oráculo do Senhor - , pois que pregou a revolta contra o Senhor.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 29, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.