Jeremias 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 Jeremaya wey bi Hilkaya pikin, na wetin e profesai, dey dis book. Jeremaya na one among di priests wey dey stay Anatot for Benjamin aria.
1 Palavras de Jeremias, o filho de Hilquias, dos sacerdotes que estavam em Anatote, na terra de Benjamim.
2 God first tok to Jeremaya for di thirtint year wen Amon pikin, Josaya dey rule Judah.
2 A quem a palavra do SENHOR veio nos dias de Josias, o filho de Amom, rei de Judá, no décimo terceiro ano do seu reinado.
3 God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.
3 Veio também nos dias de Jeoiaquim, o filho de Josias, rei de Judá, até o final do décimo primeiro ano de Zedequias, o filho de Josias, rei de Judá, até o cativeiro de Jerusalém no quinto mês.
4 God tell mi sey,
4 Então a palavra do SENHOR veio a mim, dizendo:
5 “Before I put yu for yor mama belle,
5 Antes de que te formasse no ventre eu te conheci, e antes que saísses do útero eu te santifiquei, e te ordenei como profeta para as nações.
6 So I ansa, “My Oga God, I nor sabi tok well and I still yong too.”
6 Então eu disse: Ah, Senhor DEUS! Observes, eu não posso falar, pois eu sou uma criança.
7 But God sey, “Make yu nor sey, ‘I still yong.’ But yu go-go meet anybody wey I send yu go meet kon tell dem evritin wey I kommand yu.
7 Porém o SENHOR me disse: Não digas: Eu sou uma criança, pois tu irás a todos a quem eu te enviar, e tudo o que eu ordenar falarás.
8 Di pipol wey I dey send yu go meet, make yu nor fear dem, bikos I go dey with yu and I go save yu. Mi wey bi God, don tok!”
8 Não tenha medo da sua face, pois eu estou contigo para te livrar, diz o SENHOR.
9 So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.
9 Então o SENHOR estendeu sua mão, e tocou minha boca. E o SENHOR me disse: Observa. Eu tenho colocado minhas palavras em tua boca.
10 So make yu know naw sey, I don give yu pawa ova nashons and kingdoms; to rut and skata; to distroy, ova-take, ribuild and to plant well again.”
10 Vê, ponho-te neste dia sobre as nações e sobre os reinos, para desarraigares e para demolires, para destruíres e para combateres, para construíres e para plantares.
11 Afta, God koll and ask mi: “Jeremaya! Wetin yu dey si?” I ansa, “Na one almond tree branch.”
11 Além disto a palavra do SENHOR veio a mim, dizendo: Jeremias, o que tu vês? E eu disse: Eu vejo uma vara de uma amendoeira.
12 Den God sey, “Yu dey rite and dis mean sey, I dey look well to make sure sey evritin go happen, just as I tok am.”
12 Então disse-me o SENHOR: Tu viste bem, porque eu irei apressar a minha palavra para cumpri-la completamente.
13 God ask mi again, “Na wetin yu dey si?” I ansa, “I si pot wey wota full dey boil for di nort side and e dey kom meet us.”
13 E veio a mim a palavra do SENHOR pela segunda vez, dizendo: O que tu vês? E eu disse: Eu vejo uma panela fervendo, e a sua face está em direção ao norte.
14 So God tell mi, “Dis mean sey, na from nort I go start to distroy kom and I go distroy evribody wey dey di land.
14 Então o SENHOR me disse: Do norte um mal irá brotar sobre todos os habitantes da terra.
15 All di sojas for nort, I go soon koll dem kom attack Jerusalem. Dia kings go build dia throne for Jerusalem gate kon distroy all di walls wey dey guide di town. Den dem go attack all di towns for Judah.
15 Pois eis que eu chamarei todas as famílias dos reinos do norte, diz o SENHOR. E eles virão, e eles irão dispor cada um seu trono à entrada dos portões de Jerusalém, e contra todos os seus muros em redor, e contra todas as cidades de Judá.
16 Like dis, I go ponish my pipol for Jerusalem and Judah, bikos of dia wikedness. Dem forget mi kon dey woship and offa sakrifice give juju and oda gods wey dem make with dia own hand.
16 E eu pronunciarei meus juízos contra eles a respeito de toda a sua perversidade, porque me abandonaram e queimaram incenso a outros deuses, e adoraram as obras das suas próprias mãos.
17 “But yu, Jeremaya! Make yu ready go tell dem evritin wey I kommand yu. Nor fear dem, if not, I go give yu betta rizin to fear dem.
17 Portanto, tu, cinge teus lombos, e levanta-te, e fala para todos aqueles que eu te ordeno. Não estejas desanimado diante deles, para que eu não te envergonhe perante eles.
18 Mi, God don promise to make yu strong like town wey dem dey guide well, wey nobody fit skata and like pila wey dem use iron take make or wall wey get bronze. Yu go fit stand against di whole land: dat is, Judah king, en ofisas, priest and all di pipol for di land.
18 Pois, eis que, te fiz hoje uma cidade protegida, e uma coluna de ferro e muros de bronze contra toda a terra, contra os reis de Judá, contra os príncipes, contra os seus sacerdotes, e contra o povo da terra.
19 Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu.
19 E eles lutarão contra ti, porém não prevalecerão, pois eu estou contigo, diz o SENHOR, para te livrar.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.