Jeremias 19

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 God tell Jeremaya, “Make yu take some leaders and priest go buy pot wey dem take klay make.
1 Assim disse o Senhor: Vai, e compra uma botija de oleiro, e leva contigo alguns anciãos do povo e alguns anciãos dos sacerdotes;
2 Make una pass Potsherd Gate go Ben-Hinnom Valley. Den yu go tell dem wetin I tell yu, for der.
2 e sai ao vale do filho de Hinom, que está à entrada da Porta Harsite, e apregoa ali as palavras que eu te disser;
3 “God sey, ‘Judah king and Jerusalem pipol, make una listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok: I go bring wahala kom dis place and anybody wey hear about am, go fear!
3 e dirás: Ouvi a palavra do Senhor, ó reis de Judá, e moradores de Jerusalém. Assim diz o Senhor dos exércitos, o Deus de Israel: Eis que trarei sobre este lugar uma calamidade tal que fará retinir os ouvidos de quem quer que dela ouvir.
4 I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.
4 Porquanto me deixaram, e profanaram este lugar, queimando nele incenso a outros deuses, que nunca conheceram, nem eles nem seus pais, nem os reis de Judá; e encheram este lugar de sangue de inocentes.
5 Dem build altar for Baal juju, so dat dem go fit sakrifice dia shidren gi-am. I nor sey make dem do like dis and I neva even tink about dis kind tin at-all.
5 E edificaram os altos de Baal, para queimarem seus filhos no fogo em holocaustos a Baal; o que nunca lhes ordenei, nem falei, nem entrou no meu pensamento.
6 So mi wey bi God dey sey, “Time dey kom wen pipol nor go koll dis place Tofet or Ben-Hinnom Valley again, but dem go dey koll am, di Valley Where Dem For Dey Kill Pipol!”
6 Por isso eis que dias vêm, diz o Senhor, em que este lugar não se chamara mais Tofete, nem o vale do filho de Hinom, mas o vale da matança.
7 Na for der I go for skata di plan wey Judah and Jerusalem pipol dey plan. I go make dia enemies win kon kill dem for war and birds with wiked animals go chop dia dead body.
7 E tornarei vão o conselho de Judá e de Jerusalém neste lugar, e os farei cair à espada diante de seus inimigos e pela mão dos que procuram tirar-lhes a vida. Darei os seus cadáveres por pasto as aves do céu e aos animais da terra.
8 I go distroy dis place well-well. Pipol wey dey pass go shok and shake dia head, bikos of wetin happen.
8 E farei esta cidade objeto de espanto e de assobios; todo aquele que passar por ela se espantará, e assobiará, por causa de todas as suas pragas.
9 Wen dia enemies surround di town won kill dem, I go make dem chop dia shidren and dem go still chop each oda too.’ ”
9 E lhes farei comer a carne de seus filhos, e a carne de suas filhas, e comerá cada um a carne do seu próximo, no cerco e no aperto em que os apertarão os seus inimigos, e os que procuram tirar-lhes a vida.
10 God still sey, “Naw, make yu break di pot for di pipol front
10 Então quebrarás a botija à vista dos homens que foram contigo,
11 kon tell dem, ‘Oga God wey dey mighty sey, “Just as Jeremaya take distroy dis pot, na so too I go distroy dis town and di pipol wey dey stay inside. Dem go beri pipol for Tofet, until place nor go dey again to beri pipol put.
11 e lhes dirás: Assim diz o Senhor dos exércitos: Deste modo quebrarei eu a este povo, e a esta cidade, como se quebra o vaso do oleiro, de sorte que não pode mais refazer-se; e os enterrarão em Tofete, porque não haverá outro lugar para os enterrar.
12 I don promise and I must make dis town and di pipol, bi like Tofet.
12 Assim farei a este lugar e aos seus moradores, diz o Senhor; sim, porei esta cidade como Tofete.
13 Di house for Jerusalem; Judah king house and di pipol house wey dem for don burn incense give di stars kon pour wine as ofrin give oda gods, all of dem go dirty, just as Tofet dirty.” ’ ”
13 E as casas de Jerusalém, e as casas dos reis de Judá, serão imundas como o lugar de Tofete, como também todas as casas, sobre cujos terraços queimaram incenso a todo o exército dos céus, e ofereceram libações a deuses estranhos.
14 Den, Jeremaya komot from Tofet where God for tok to mi kon go stand for di kourt wey dey di temple front, den tell all di pipol wetin
14 Então voltou Jeremias de Tofete, aonde o tinha enviado o Senhor a profetizar; e pôs-se em pé no átrio da casa do Senhor, e disse a todo o povo:
15 Israel God wey dey mighty tok: “I go soon ponish dis town and di oda towns wey surround am, bikos una sturbon well-well and una nor gri listin to wetin I tok.”
15 Assim diz o Senhor dos exércitos, o Deus de Israel: Eis que trarei sobre esta cidade, e sobre todas as suas cercanias, todo o mal que pronunciei contra ela, porquanto endureceram a sua cerviz, para não ouvirem as minhas palavras.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jeremias 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.