João 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Wen Jesus dey waka pass, e kon si one man wey blind from di time wey en mama born am.
1 Enquanto Jesus caminhava, viu um homem cego de nascença.
2 En disciples ask am, “Tisha, na wish pesin sin, wey make dis man blind since di time en mama born am? Na di man or na en papa and mama?”
2 E os seus discípulos perguntaram: — Mestre, quem pecou para que este homem nascesse cego? Ele ou os pais dele?
3 Jesus ansa dem, “Nor bi di man or en papa and mama sin, but e blind since dem born am, bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am.
3 Jesus respondeu:
4 I must do di work for di Pesin wey send mi before day go dark, bikos nite dey kom wen nobody go fit work.
4 É necessário que façamos as obras daquele que me enviou enquanto é dia; a noite vem, quando ninguém pode trabalhar.
5 As far as I dey inside dis world, na mi bi di lite for di world.
5 Enquanto estou no mundo, sou a luz do mundo.
6 “Afta e tok finish, e spit for groun kon take di san-san wey e spit put take rub di blind man eye.
6 Depois de dizer isso, Jesus cuspiu na terra, fez lama com a saliva e com a lama untou os olhos do cego.
7 Den e tell am, Make yu go wosh yor face inside di pond wey dem dey koll Siloam (dis name mean ‘Send’).” So di blind man kon go wosh en face as Jesus tell am. As e dey kom back, e kon bigin si.
7 Então disse ao cego: Siloé quer dizer “Enviado”. O cego foi, lavou-se e voltou vendo.
8 Den en neighbours and oda pipol wey dey si am dey beg before, kon ask sey, “Dis nor bi di man wey dey sidan dey beg for money?”
8 Então os vizinhos e os que antes o conheciam de vista, como mendigo, perguntavam: — Não é este o que ficava sentado pedindo esmolas?
9 Some pipol ansa, “Na-im o-o!” Odas tok sey, “Nor bi en, but e look like am.”
9 Uns diziam: — É ele. Outros: — Não, mas se parece com ele. O homem dizia: — Sou eu.
10 Dem ask am, “Wetin happen wey make yu bigin si?”
10 Então lhe perguntaram: — Como foram abertos os seus olhos?
11 E ansa dem, “Na di man wey dem dey koll Jesus take san-san wey e spit put rub my eye. Den e tell mi sey, ‘Make yu go Siloam go wosh yor face.’ Afta I go wosh my face for di pond, I kon bigin si.”
11 Ele respondeu: — O homem chamado Jesus fez lama, passou nos meus olhos e disse: “Vá ao tanque de Siloé e lave-se.” Então fui, lavei-me e estou vendo.
12 Naim dem ask am, “Where di man dey?”
12 Eles perguntaram: — Onde está ele? Respondeu: — Não sei.
13 Dem take di man wey blind before go meet di Farisee pipol,
13 Levaram aos fariseus aquele que antes era cego.
14 (bikos na for Sabat Day Jesus spit for san-san take rub di blind man eye).
14 E era sábado o dia em que Jesus fez a lama e lhe abriu os olhos.
15 Naim di Farisee pipol ask am again, “How yu take bigin si?” E ansa dem, “E take di san-san wey e spit put rub my eye and afta I don wosh my face, I kon bigin si.”
15 Então os fariseus lhe perguntaram outra vez como podia ver. Ele respondeu: — Ele pôs lama sobre os meus olhos, lavei-me e estou vendo.
16 Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.”
16 Por isso, alguns dos fariseus diziam: — Esse homem não é de Deus, porque não guarda o sábado. Mas outros diziam: — Como pode um homem pecador fazer sinais como estes? E houve divisão entre eles.
17 Dem ask di man wey blind before sey, “Wetin yu tink about di man wey make yu dey si?”
17 De novo perguntaram ao cego: — O que você diz a respeito dele, uma vez que lhe abriu os olhos? Ele respondeu: — É um profeta.
18 Di Jew oga dem nor gri bilive sey, true-true di man blind before, so dem kon koll en papa and mama.
18 Os judeus não acreditaram que ele tinha sido cego e que agora podia ver, enquanto não chamaram os pais dele
19 Dem ask dem, “Na una pikin bi dis? Na true sey e blind wen una born am? How e kon take dey si naw?”
19 e lhes perguntaram: — É este o filho de vocês, que vocês dizem que nasceu cego? Como é que agora ele está vendo?
20 So en papa and mama ansa, “Wi know sey dis na awa pikin and e blind wen wi born am.
20 Então os pais responderam: — Sabemos que este é o nosso filho e que nasceu cego,
21 But wi nor know how e take bigin si or even who open en eye. Make una ask am, e don big rish to tok for ensef.”
21 mas não sabemos como agora está vendo. E também não sabemos quem lhe abriu os olhos. Perguntem a ele, pois já tem idade e poderá falar por si mesmo.
22 (En papa and mama tok like dis, bikos dem dey fear di Jew oga dem wey don tok sey, “Anybody wey tok sey na Jesus bi di Christ, dem go drive am komot from di sinagog.”
22 Os pais dele disseram isso porque estavam com medo dos judeus, pois estes já tinham combinado que, se alguém confessasse que Jesus era o Cristo, seria expulso da sinagoga.
23 Na dis one make en papa and mama sey, “Make dem ask am, bikos e don big rish to tok for ensef).”
23 Foi por isso que os pais dele disseram: “Ele já tem idade e poderá falar por si mesmo.”
24 So dem koll di man again kon tell am, “Make yu promise before God sey yu go tok di trut, bikos wi know sey di man na sina.”
24 Então chamaram, pela segunda vez, o homem que tinha sido cego e lhe disseram: — Diga a verdade diante de Deus; nós sabemos que esse homem é pecador.
25 Man ansa dem, “Weda na sina e bi, I nor know! But wetin I know bi sey, before I blind, but naw, I don dey si.”
25 Ele respondeu: — Se é pecador, não sei. Uma coisa sei: eu era cego e agora vejo.
26 So dem ask am again, “Wetin e do? How e take make yu dey si sef?”
26 Perguntaram-lhe outra vez: — O que ele fez a você? Como lhe abriu os olhos?
27 E kon ansa dem, “I don tell una before, but una nor gri. Why una won hear am again? Abi, una won bi en disciples too?”
27 Ele respondeu: — Já lhes disse, mas vocês não ouviram. Por que querem ouvir outra vez? Por acaso vocês também querem se tornar discípulos dele?
28 Dem shaut for di man kon sey, “Na yu bi en disciple. Wi bi Moses disciples.
28 Então o insultaram e lhe disseram: — Discípulo dele é você! Nós somos discípulos de Moisés.
29 Wi know sey God tok to Moses, but wi nor know where dis man from kom.”
29 Sabemos que Deus falou a Moisés, mas este nem sabemos de onde é.
30 Di man kon sey, “I sopraiz for una o-o. Una nor know where e from kom, but na-im open my eye!
30 O homem respondeu: — É estranho que vocês não saibam de onde ele é, mas ele me abriu os olhos.
31 Wi know sey God nor dey listin to anybody wey dey sin, but if pesin dey do wetin God tok, God go hear en prayer.
31 Sabemos que Deus não atende a pecadores. Pelo contrário, se alguém teme a Deus e pratica a sua vontade, a este atende.
32 Wi neva hear before sey, anybody don fit make pesin wey blind si.
32 Desde que o mundo existe, jamais se ouviu que alguém tenha aberto os olhos a um cego de nascença.
33 If God nor send dis man, e nor go fit do dis kind tin.”
33 Se este homem não fosse de Deus, não poderia ter feito nada.
34 Dem kon tell di man, “Na for inside sins born yu, yu tink sey yu go fit tish us anytin?” So dem drive am komot from di place.
34 Mas eles disseram: — Você nasceu cheio de pecado e quer nos ensinar? E o expulsaram.
35 Wen Jesus hear sey dem don drive di man komot, e go look for am kon ask am, “Yu bilive who Man Pikin bi?”
35 Jesus ouviu que eles tinham expulsado o homem. Ao encontrá-lo, perguntou:
36 Di man kon sey, “Oga God, tell mi who e bi, make I for fit bilive am?”
36 Ele respondeu: — Quem é, Senhor, para que eu creia nele?
37 Jesus ansa am, “Na-im dey here dey tok to yu so.”
37 E Jesus lhe disse:
38 Di man kon sey, “Oga God, I bilive.” Den e knee down kon woship Jesus.
38 Então ele afirmou: — Eu creio, Senhor! E o adorou.
39 Jesus tell am, “I kon judge pipol for di world, so dat di pipol wey nor dey si, go bigin si and doz wey tink sey dem dey si, dia eye go blind.”
39 Jesus continuou: —
40 Wen di Farisee pipol wey dey der hear wetin Jesus tok, dem kon ask am, “Yu tink sey wisef blind?”
40 Alguns dos fariseus que estavam perto dele perguntaram-lhe: — Por acaso também nós somos cegos?
41 Jesus ansa dem, “If una gri sey una blind, God nor go kondemn una bikos of una sin, but as una tok sey una dey si so, una sin dey for una head.”
41 Jesus respondeu:

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.