João 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Den Jesus waka enter Mount Olives.
1 Mas Jesus foi para o Monte das Oliveiras.
2 For early morning, e enter di temple. Plenty pipol gada for der and e kon sidan dey tish dem.
2 Pela manhã cedo voltou ao templo, e todo o povo vinha ter com ele; e Jesus, sentando-se o ensinava.
3 Di pipol wey sabi di law and di Farisee pipol kon bring one woman wey dem katch sey e sleep with man wey nor bi en husband. Dem kon make am stand for dia front,
3 Então os escribas e fariseus trouxeram-lhe uma mulher apanhada em adultério; e pondo-a no meio,
4 den dem tell Jesus, “Tisha, wi katch dis woman wen e dey sleep with one man wey nor bi en husband.
4 disseram-lhe: Mestre, esta mulher foi apanhada em flagrante adultério.
5 Moses Law sey, ‘Make dem stone dis kind woman die.’ Wetin yu get to tok for dis matter?”
5 Ora, Moisés nos ordena na lei que as tais sejam apedrejadas. Tu, pois, que dizes?
6 (Dem ask am dis kweshon to set trap for am, make dem for fit katch am).
6 Isto diziam eles, tentando-o, para terem de que o acusar. Jesus, porém, inclinando-se, começou a escrever no chão com o dedo.
7 Wen dem kontinue to dey worry am, e kon get up tell dem, “Any of una wey neva kommit sin before, make e bi di first pesin to stone dis woman.”
7 Mas, como insistissem em perguntar-lhe, ergueu-se e disse-lhes: Aquele dentre vós que está sem pecado seja o primeiro que lhe atire uma pedra.
8 E kon bend down again bigin rite for groun.
8 E, tornando a inclinar-se, escrevia na terra.
9 Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.
9 Quando ouviram isto foram saindo um a um, a começar pelos mais velhos, até os últimos; ficou só Jesus, e a mulher ali em pé.
10 Den Jesus stand up ask am, “Madam, where di pipol wey bring yu? Nobody remain to kondemn yu?”
10 Então, erguendo-se Jesus e não vendo a ninguém senão a mulher, perguntou-lhe: Mulher, onde estão aqueles teus acusadores? Ninguém te condenou?
11 Di woman ansa, “Oga God, nobody remain.”
11 Respondeu ela: Ninguém, Senhor. E disse-lhe Jesus: Nem eu te condeno; vai-te, e não peques mais.
12 Den Jesus sey, “Na mi bi di lite wey dey di world, anybody wey follow mi, nor go waka for darkness lie-lie, but e go get di lite wey go gi-am life.”
12 Então Jesus tornou a falar-lhes, dizendo: Eu sou a luz do mundo; quem me segue de modo algum andará em trevas, mas terá a luz da vida.
13 Di Farisee pipol kon dey argue with am sey, “Yu dey tok about yorsef and wetin yu tok, nor bi true.”
13 Disseram-lhe, pois, os fariseus: Tu dás testemunho de ti mesmo; o teu testemunho não é verdadeiro.
14 Jesus ansa dem, “Even if I dey tok about mysef, wetin I dey tok na true, bikos I know where I from kom and where I dey go. But una nor know where I from kom or where I dey go.
14 Respondeu-lhes Jesus: Ainda que eu dou testemunho de mim mesmo, o meu testemunho é verdadeiro; porque sei donde vim, e para onde vou; mas vós não sabeis donde venho, nem para onde vou.
15 Una dey judge pesin with wetin una si with una eye, but I nor dey judge pipol like dat.
15 Vós julgais segundo a carne; eu a ninguém julgo.
16 But, if I sey pesin do bad, di tins wey I si and tok about, na true, as e bi sey nor bi only mi dey tok am. Na mi and my Papa wey send mi, dey tok am togeda.
16 E, mesmo que eu julgue, o meu juízo é verdadeiro; porque não sou eu só, mas eu e o Pai que me enviou.
17 God word sey, ‘Wetin two pipol bear witness about, na true.’
17 Ora, na vossa lei está escrito que o testemunho de dois homens é verdadeiro.
18 I dey bear witness about mysef and my Papa wey send mi, dey bear witness about mi too.”
18 Sou eu que dou testemunho de mim mesmo, e o Pai que me enviou, também dá testemunho de mim.
19 Dem kon bigin kweshon am, “Who bi yor Papa sef?”
19 Perguntavam-lhe, pois: Onde está teu pai? Jesus respondeu: Não me conheceis a mim, nem a meu Pai; se vós me conhecêsseis a mim, também conheceríeis a meu Pai.
20 Jesus dey tok to dem near di box where dem dey put ofrin money, wey dey inside di temple. Nobody fit katch am, bikos en time neva rish.
20 Essas palavras proferiu Jesus no lugar do tesouro, quando ensinava no templo; e ninguém o prendeu, porque ainda não era chegada a sua hora.
21 Den Jesus kon tell dem again, “I dey go and una go look for mi, but una go die inside una sin. Where I dey go, una nor go fit kom der.”
21 Disse-lhes, pois, Jesus outra vez: Eu me retiro; buscar-me-eis, e morrereis no vosso pecado. Para onde eu vou, vós não podeis ir.
22 So di Jew oga dem kon dey ask, “Abi e won go kill ensef? As e dey tok sey, ‘Where I dey go, una nor go fit kom der?’ ”
22 Então diziam os judeus: Será que ele vai suicidar-se, pois diz: Para onde eu vou, vós não podeis ir?
23 Jesus ansa dem, “Na groun una from kom, but mi, na heaven I from kom. Una kom from dis world, but I nor kom from dis world.
23 Disse-lhes ele: Vós sois de baixo, eu sou de cima; vós sois deste mundo, eu não sou deste mundo.
24 Na dis make mi sey una go die inside una sin. Unless una bilive sey, ‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’, una go die inside una sin.”
24 Por isso vos disse que morrereis em vossos pecados; porque, se não crerdes que eu sou, morrereis em vossos pecados.
25 Den dem ask am, “Who yu bi sef?”
25 Perguntavam-lhe então: Quem és tu? Respondeu-lhes Jesus: Exatamente o que venho dizendo que sou.
26 I get plenty tins to tok about wetin una dey do, but my Papa wey send mi, nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”
26 Muitas coisas tenho que dizer e julgar acerca de vós; mas aquele que me enviou é verdadeiro; e o que dele ouvi, isso falo ao mundo.
27 (But dem nor undastand sey e dey tok about en Papa for heaven).
27 Eles não perceberam que lhes falava do Pai.
28 Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.
28 Prosseguiu, pois, Jesus: Quando tiverdes levantado o Filho do homem, então conhecereis que eu sou, e que nada faço de mim mesmo; mas como o Pai me ensinou, assim falo.
29 And di Pesin wey send mi dey with mi. E nor dey leave mi, bikos I always dey do di tins wey E wont.”
29 E aquele que me enviou está comigo; não me tem deixado só; porque faço sempre o que é do seu agrado.
30 As e dey tok, many pipol kon bilive am.
30 Falando ele estas coisas, muitos creram nele.
31 Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am, “If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disciples
31 Dizia, pois, Jesus aos judeus que nele creram: Se vós permanecerdes na minha palavra, verdadeiramente sois meus discípulos;
32 and una go know di trut and di trut go free una.”
32 e conhecereis a verdade, e a verdade vos libertará.
33 Dem tell am, “All of us na Abraham pikin, wi neva bi slave to anybody before. Why yu dey sey, wi go dey free?”
33 Responderam-lhe: Somos descendentes de Abraão, e nunca fomos escravos de ninguém; como dizes tu: Sereis livres?
34 Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una, anybody wey dey kommit sin, na sin bi di masta wey dey rule am.
34 Replicou-lhes Jesus: Em verdade, em verdade vos digo que todo aquele que comete pecado é escravo do pecado.
35 Pesin wey bi slave nor dey stay for inside dat family forever, but pesin wey bi pikin for di family, naim dey stay forever.
35 Ora, o escravo não fica para sempre na casa; o filho fica para sempre.
36 So wen Man Pikin free una, una don dey free bi dat.
36 Se, pois, o Filho vos libertar, verdadeiramente sereis livres.
37 I know sey una kom from Abraham family, but una won kill mi bikos una nor won hear wetin I dey tok.
37 Bem sei que sois descendência de Abraão; contudo, procurais matar-me, porque a minha palavra não encontra lugar em vós.
38 Na wetin I si wen I dey with my Papa, naim I dey tell una, so make una dey do di tins wey una hear from my Papa.”
38 Eu falo do que vi junto de meu Pai; e vós fazeis o que também ouvistes de vosso pai.
39 Dem tell am, “Na Abraham bi awa papa.”
39 Responderam-lhe: Nosso pai é Abraão. Disse-lhes Jesus: Se sois filhos de Abraão, fazei as obras de Abraão.
40 But una won kill mi, bikos I tell una di real trut wey I hear from God. Abraham nor do wetin una dey do so o-o.
40 Mas agora procurais matar-me, a mim que vos falei a verdade que de Deus ouvi; isso Abraão não fez.
41 Una dey do di tins wey una papa do.”
41 Vós fazeis as obras de vosso pai. Replicaram-lhe eles: Nós não somos nascidos de prostituição; temos um Pai, que é Deus.
42 Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi.
42 Respondeu-lhes Jesus: Se Deus fosse o vosso Pai, vós me amaríeis, porque eu saí e vim de Deus; pois não vim de mim mesmo, mas ele me enviou.
43 Na bikos una nor won asept wetin I dey tish, naim make una nor fit undastand wetin I dey tok.
43 Por que não compreendeis a minha linguagem? é porque não podeis ouvir a minha palavra.
44 Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.
44 Vós tendes por pai o Diabo, e quereis satisfazer os desejos de vosso pai; ele é homicida desde o princípio, e nunca se firmou na verdade, porque nele não há verdade; quando ele profere mentira, fala do que lhe é próprio; porque é mentiroso, e pai da mentira.
45 Na bikos I dey tell una true word, naim make una nor gri bilive mi.
45 Mas porque eu digo a verdade, não me credes.
46 Who among una go fit show sey I kommit sin? Since I dey tell una true word, why una nor won bilive mi?
46 Quem dentre vós me convence de pecado? Se digo a verdade, por que não me credes?
47 Di pesin wey bi God pikin, dey listin and do wetin dem rite for God word. Una nor dey listin and una nor dey do wetin dem rite for God word, bikos una nor bi God Pikin.”
47 Quem é de Deus ouve as palavras de Deus; por isso vós não as ouvis, porque não sois de Deus.
48 So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”
48 Responderam-lhe os judeus: Não dizemos com razão que és samaritano, e que tens demônio?
49 Jesus kon tell dem, “I nor get demon. I dey respet my Papa, but una nor gri respet mi.
49 Jesus respondeu: Eu não tenho demônio; antes honro a meu Pai, e vós me desonrais.
50 I nor wont make una praiz mi, but na God, di One wey dey heaven, na-im wi suppose praiz and E go judge evribody for di korrect way.
50 Eu não busco a minha glória; há quem a busque, e julgue.
51 I dey tell una true word, if anybody follow wetin I dey tish, e nor go die again.”
51 Em verdade, em verdade vos digo que, se alguém guardar a minha palavra, nunca verá a morte.
52 Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’
52 Disseram-lhe os judeus: Agora sabemos que tens demônios. Abraão morreu, e também os profetas; e tu dizes: Se alguém guardar a minha palavra, nunca provará a morte!
53 Yu big pass awa papa Abraham and all di profets wey don die? Who yu tink sey yu bi sef?”
53 Porventura és tu maior do que nosso pai Abraão, que morreu? Também os profetas morreram; quem pretendes tu ser?
54 Jesus ansa, “If I dey praiz mysef, my praiz na yeye one. Di pesin wey dey praiz mi na my Papa, wey una dey sey, ‘Na-im bi awa God.’
54 Respondeu Jesus: Se eu me glorificar a mim mesmo, a minha glória não é nada; quem me glorifica é meu Pai, do qual vós dizeis que é o vosso Deus;
55 Una nor know am, but I know am and if I sey I nor know am, I dey lie like una. I know am and I dey follow wetin e dey tok.
55 e vós não o conheceis; mas eu o conheço; e se disser que não o conheço, serei mentiroso como vós; mas eu o conheço, e guardo a sua palavra.
56 Una papa Abraham happy well-well wen e hear sey I dey kom. E si am and e happy well-well.”
56 Abraão, vosso pai, exultou por ver o meu dia; viu-o, e alegrou-se.
57 Den di pipol ask am, “Yu neva old rish fifty years and yu sey yu don si Abraham?”
57 Disseram-lhe, pois, os judeus: Ainda não tens cinqüenta anos, e viste Abraão?
58 Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una so, before dem born Abraham, I don already dey!”
58 Respondeu-lhes Jesus: Em verdade, em verdade vos digo que antes que Abraão existisse, eu sou.
59 Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria.
59 Então pegaram em pedras para lhe atirarem; mas Jesus ocultou-se, e saiu do templo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.