João 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Afta, Jesus kon travel go evriwhere for Galilee. Den e komot for Judea, bikos di Jew oga dem won kill-am.
1 Passadas essas coisas, Jesus andava pela Galileia, porque não desejava andar pela Judeia, visto que os judeus queriam matá-lo.
2 Di time kon rish wen Jew pipol dey do dia feast wey dem dey koll Tabanako Feast.
2 E a festa dos judeus, chamada de Festa dos Tabernáculos, estava próxima.
3 Jesus brodas kon dey tell am, “Komot for here go Judea, make yor disciples si di mirakles wey yu dey do.
3 Então os irmãos de Jesus se dirigiram a ele e disseram: — Deixe este lugar e vá para a Judeia, para que também os seus discípulos vejam as obras que você faz.
4 Bikos anybody wey wont make pipol sabi who e bi, nor go do anytin for korna. Since yu dey do dis tins, e good sey make yu show yorsef to evribody.”
4 Porque, se alguém quer ser conhecido, não pode realizar os seus feitos em segredo. Já que você faz essas coisas, manifeste-se ao mundo.
5 (Even en brodas nor bilive wetin Jesus dey do.)
5 Acontece que nem mesmo os irmãos de Jesus criam nele.
6 Jesus ansa dem, “Time neva rish for mi to go, but una fit go anytime una like.
6 Então Jesus lhes disse:
7 Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.
7 O mundo não pode odiar vocês, mas a mim ele odeia, porque eu dou testemunho a respeito dele, dizendo que as suas obras são más.
8 Make una go di feast, I nor go-go, bikos my time neva rish.”
8 Vão vocês para a festa. Eu não vou, porque o meu tempo ainda não se cumpriu.
9 Afta e don tok finish, e kon stay for Galilee.
9 Tendo dito isso, Jesus continuou na Galileia.
10 But wen en brodas don go di feast, Jesus kon go der too, but e nor let anybody know sey e dey der.
10 Depois que seus irmãos tinham ido à festa, Jesus também foi, não publicamente, mas em segredo.
11 Di Jew oga dem kon dey ask pipol, “Where e dey?”
11 Ora, os judeus o procuravam na festa e perguntavam: — Onde estará ele?
12 Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.”
12 E havia grande murmuração a respeito de Jesus entre as multidões. Uns diziam: — Ele é bom. E outros afirmavam: — Não, não é! Ele engana o povo.
13 But nobody fit tok out, bikos dem dey fear di Jew oga dem.
13 Entretanto, ninguém falava dele abertamente, por ter medo dos judeus.
14 Wen di feast don rish half, Jesus enter di temple kon dey tish.
14 Quando a festa já estava na metade, Jesus foi ao templo e começou a ensinar.
15 Di Jew oga dem sopraiz and dem kon dey sey, “How e take know dis tins wey e dey tish so, as e bi sey e nor go skool at-all?”
15 Então os judeus se maravilhavam e diziam: — Como é que ele pode ser letrado, se não chegou a estudar?
16 Jesus ansa dem, “Wetin I dey tish nor bi my own, but na di Pesin wey send mi, na-im give mi.
16 Jesus lhes respondeu:
17 Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.
17 Se alguém quiser fazer a vontade de Deus, conhecerá a respeito da doutrina, se ela é de Deus ou se eu falo por mim mesmo.
18 Anybody wey dey tok with en own pawa, go wont make pipol praiz am, but di pesin wey won honor who send am, naim dey do wetin korrect and sin nor dey inside am.
18 Quem fala por si mesmo está buscando a sua própria glória; mas o que busca a glória de quem o enviou, esse é verdadeiro, e nele não há falsidade.
19 Moses nor give una di law? But una nor gri obey am. Why e bi sey una won kill misef?”
19 Não é fato que Moisés deu a Lei para vocês? Contudo, nenhum de vocês a cumpre. Por que estão querendo me matar?
20 Di pipol ansa Jesus, “Demon don enter yor body! Who won kill yu?”
20 A multidão respondeu: — Você tem demônio. Quem é que está querendo matá-lo?
21 Den Jesus ansa, “Na one mirakle wey I do so, make una dey sopraiz?
21 Jesus respondeu:
22 Na true sey Moses tell una to sekonsaiz una son, (nor bi Moses start am, na from Abraham time e start) and una dey sekonsaiz una son for Sabat Day.
22 Moisés lhes deu a circuncisão — se bem que ela não vem de Moisés, mas dos patriarcas —, e vocês fazem a circuncisão de um menino até mesmo no sábado.
23 Since una dey sekonsaiz for Sabat Day so dat una nor go break Moses Law, why una dey vex with mi, bikos I heal dis sick man for Sabat Day?
23 E, se um menino pode ser circuncidado em dia de sábado, para que a Lei de Moisés não seja desrespeitada, por que vocês ficam indignados contra mim, pelo fato de eu ter curado por completo um homem num sábado?
24 Make una nor dey judge pesin, bikos of wetin una si with una eye, but make una give korrect judgement as e suppose to bi.”
24 Não julguem segundo a aparência, mas julguem pela reta justiça.
25 Some pipol wey dey stay for Jerusalem kon dey sey, “Dis nor bi di man wey dem won kill?
25 Alguns de Jerusalém diziam: — Não é este o homem que estão querendo matar?
26 Naim dey here dey tok for publik so and dem nor fit tell am anytin. Abi di oga dem don gri sey naim bi di Christ?
26 Eis que ele fala abertamente, e ninguém lhe diz nada. Será que as autoridades reconhecem de fato que este é o Cristo?
27 Wisef know di place where dis man from kom and wi know sey anytime wey Christ go kom, nobody go fit know where e go kom from.”
27 Mas nós sabemos de onde este homem vem. Quando, porém, o Cristo vier, ninguém saberá de onde ele é.
28 As Jesus dey tish for di temple, e kon shaut sey, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take kom, na God wey send mi naim bi di korrect Pesin. But una nor know am.
28 Enquanto ensinava no templo, Jesus disse em voz alta:
29 But I know am well-well, bikos na from am, I kom and naim send mi.”
29 Eu o conheço, porque venho da parte dele e ele me enviou.
30 Dem kon try to katch Jesus, but nobody fit tosh am, bikos en time neva rish.
30 Então quiseram prendê-lo, mas ninguém lhe pôs as mãos, porque a sua hora ainda não havia chegado.
31 Many pipol for der bilive am kon sey, “Anytime di pesin wey bi di Christ kom, e go fit do mirakle wey pass wetin dis one dey do so?”
31 Porém muitos dentre a multidão creram nele e diziam: — Quando o Cristo vier, será que vai fazer maiores sinais do que este homem tem feito?
32 Wen di Farisee pipol hear pipol dey tok about Jesus, dia oga and di priests kon send sojas go arrest am.
32 Os fariseus, ouvindo a multidão murmurar essas coisas a respeito de Jesus, juntamente com os principais sacerdotes enviaram guardas para o prender.
33 Jesus kon tell dem, “I go only stay with una for small time and afta, I go-go meet di Pesin wey send mi.
33 Jesus disse:
34 Una go dey look for mi, but una nor go si mi and una nor go fit kom meet mi for where I dey.”
34 Vocês irão me procurar, mas não me acharão; vocês também não podem ir para onde eu estou.
35 Den di Jew oga dem kon dey ask each oda, “Where e won go wey wi nor go fit si am, abi e won go tish Jew pipol wey dey stay with Greek pipol?
35 Então os judeus disseram uns aos outros: — Para onde ele irá que não o possamos achar? Será que pretende ir para a diáspora entre os gregos, a fim de ensinar os gregos?
36 Wetin e mean wen e tok sey, ‘Una go look for mi, but una nor go si mi and where I dey, una nor go fit kom der?’ ”
36 Que significa isso que ele diz: “Vocês irão me procurar, mas não me acharão; vocês também não podem ir para onde eu estou?”
37 For di last day for di feast, wey bi di biggest day, Jesus stand kon shaut, “If wota dey hongry anybody, make e kom meet mi.
37 No último dia, o grande dia da festa, Jesus se levantou e disse em voz alta:
38 Di pesin wey bilive mi and wetin I tok, make e kom drink, just as God word sey, ‘Plenty wota wey dey give life, go flow from inside en belle.’ ”
38 Quem crer em mim, como diz a Escritura, do seu interior fluirão rios de água viva.
39 (E tok dis tin about di Spirit wey di pipol wey bilive am go get, bikos by dis time, God neva give en Spirit to pipol, bikos E neva honor Jesus Christ.)
39 Isso ele disse a respeito do Espírito que os que nele cressem haviam de receber; pois o Espírito até aquele momento não tinha sido dado, porque Jesus ainda não havia sido glorificado.
40 Wen pipol hear wetin e tok, some for dem kon sey, “True-true, dis man naim bi di Profet!”
40 Quando ouviram essas palavras, alguns do meio do povo diziam: — Este é verdadeiramente o profeta.
41 Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee.
41 Outros diziam: — Ele é o Cristo. Outros, porém, perguntavam: — Por acaso o Cristo virá da Galileia?
42 Abi God word nor sey, ‘Christ go kom from David family wey dey Betlehem, di village wey David from kom?’ ”
42 Não diz a Escritura que o Cristo vem da descendência de Davi e da aldeia de Belém, de onde era Davi?
43 So di pipol kon divide bikos of Jesus.
43 Assim, houve divisão entre o povo por causa dele.
44 Some of dem kon dey try to katch am, but nobody fit take hand tosh am.
44 Alguns queriam prendê-lo, mas ninguém lhe pôs as mãos.
45 Wen di sojas go back, di priest oga dem and Farisee pipol kon ask dem, “Why una nor katch Jesus kom?”
45 Os guardas voltaram à presença dos principais sacerdotes e fariseus, e estes lhes perguntaram: — Por que vocês não o trouxeram?
46 Di sojas ansa, “Wi neva si anybody wey tok like dis man before!”
46 Eles responderam: — Jamais alguém falou como este homem.
47 Den di Farisee pipol kon ask di sojas, “Abi, e don deceive una too?
47 Os fariseus disseram aos guardas: — Será que também vocês foram enganados?
48 Abi any of us wey bi Farisee pipol or priests don bilive Jesus?
48 Por acaso alguma das autoridades ou algum dos fariseus creu nele?
49 Curse dey dis pipol head, bikos dem nor know di law.”
49 Mas esse povo que nada sabe da lei é maldito.
50 Den one man wey en name bi Nikodimos, wey don first go meet Jesus and wey bi one of di big oga dem kon sey,
50 Nicodemos, um deles, que antes tinha ido conversar com Jesus, perguntou-lhes:
51 “Awa law nor dey kondemn pesin unless wi don hear wetin di pesin tok or si wetin e dey do, abi nor bi so?”
51 — Será que a nossa lei condena um homem sem primeiro ouvi-lo e saber o que ele fez?
52 Dem kon ask am, “Abi na Galilee yu too from kom? If yu look well, yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”
52 Eles responderam: — Por acaso também você é da Galileia? Examine e verá que da Galileia não se levanta profeta.
53 Afta dis, evribody bigin go en house.
53 E cada um foi para a sua casa.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.