João 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Jesus kon go one feast wey dem dey do for Jerusalem.
1 Depois disso, havia uma festa entre os judeus, e Jesus subiu a Jerusalém.
2 One pool dey der wey near di Sheep Gate, di name na Betsaida for Aramaik language. Na five roads pipol take dey enter inside.
2 Ora, em Jerusalém há, próximo à Porta das Ovelhas, um tanque, chamado em hebreu Betesda, o qual tem cinco alpendres.
3 Pipol wey nor well, wey blind and doz wey nor fit waka dey liedan for di difren roads.
3 Nestes jazia grande multidão de enfermos: cegos, coxos e paralíticos, esperando o movimento das águas.
4 From time to time, one angel dey kom shake di wota and anybody wey first enter di wota afta di angel don shake am, go well.
4 Porquanto um anjo descia em certo tempo ao tanque e agitava a água; e o primeiro que ali descia, depois do movimento da água, sarava de qualquer enfermidade que tivesse.
5 One man dey der wey nor fit waka for thirty-eight years.
5 E estava ali um homem que, havia trinta e oito anos, se achava enfermo.
6 Wen Jesus si am liedan for der, e kon know sey di man neva fit waka for long time. So, Jesus kon ask am, “Yu won waka?”
6 E Jesus, vendo este deitado e sabendo que estava neste estado havia muito tempo, disse-lhe: Queres ficar são?
7 Di man ansa am, “Oga God, I nor get anybody wey go put mi inside di pool wen di wota dey shake. Anytime I dey try to enter di wota, anoda pesin go kwik enter before I rish der.”
7 O enfermo respondeu-lhe: Senhor, não tenho homem algum que, quando a água é agitada, me coloque no tanque; mas, enquanto eu vou, desce outro antes de mim.
8 Jesus tell am, “Make yu get up! Karry yor mat make yu bigin waka.”
8 Jesus disse-lhe: Levanta-te, toma tua cama e anda.
9 At wons, di man get up, karry en mat kon bigin waka. (Dat day na Sabat).
9 Logo, aquele homem ficou são, e tomou a sua cama, e partiu. E aquele dia era sábado.
10 Den di Jew oga dem kon tell di man wey dey waka naw sey, “Today na Sabat, yu nor suppose to karry yor mat dey waka.”
10 Então, os judeus disseram àquele que tinha sido curado: É sábado, não te é lícito levar a cama.
11 Naim e ansa dem, “Di man wey make mi well, tell mi sey, ‘Make I karry my mat and make I bigin waka.’ ”
11 Ele respondeu-lhes: Aquele que me curou, ele próprio disse: Toma a tua cama e anda.
12 Dem kon ask am, “Who bi di man wey sey, ‘Make yu karry yor mat, make yu dey waka?’ ”
12 Perguntaram-lhe, pois: Quem é o homem que te disse: Toma a tua cama e anda?
13 But di man nor know who e bi, bikos Jesus don komot der and plenty pipol dey for dat place.
13 E o que fora curado não sabia quem era, porque Jesus se havia retirado, em razão de naquele lugar haver grande multidão.
14 Afta dis, Jesus kon si di man inside di temple. So e kon tell am, “Look, yu don well naw, make yu nor kommit sin again, oda-wise, di tin wey bad pass wetin do yu before, go happen to yu.”
14 Depois, Jesus encontrou-o no templo e disse-lhe: Eis que já estás são; não peques mais, para que te não suceda alguma coisa pior.
15 Di man kon go tell di Jew oga dem sey, “Na Jesus bi di pesin wey make mi well.”
15 E aquele homem foi e anunciou aos judeus que Jesus era o que o curara.
16 Bikos Jesus dey do all dis tins for Sabat Day, di Jew oga dem kon dey make trobol with am.
16 E, por essa causa, os judeus perseguiram Jesus e procuravam matá-lo, porque fazia essas coisas no sábado.
17 So e tell dem, “My Papa dey work evritime and na so mi too dey work.”
17 E Jesus lhes respondeu: Meu Pai trabalha até agora, e eu trabalho
18 Bikos of dis, di Jew oga dem kon dey try to kill-am, bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey koll God en papa, like sey en and God na mate.
18 Por isso, pois, os judeus ainda mais procuravam matá-lo, porque não só quebrantava o sábado, mas também dizia que Deus era seu próprio Pai, fazendo-se igual a Deus.
19 Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too.
19 Mas Jesus respondeu e disse-lhes: Na verdade, na verdade vos digo que o Filho por si mesmo não pode fazer coisa alguma, se o não vir fazer ao Pai, porque tudo quanto ele faz, o Filho o faz igualmente.
20 Bikos di Papa get strong love for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz.
20 Porque o Pai ama ao Filho e mostra-lhe tudo o que faz; e ele lhe mostrará maiores obras do que estas, para que vos maravilheis.
21 As di Papa get pawa to take wake pesin wey don die, na so too di pikin get pawa to give life to anybody wey en won give.
21 Pois assim como o Pai ressuscita os mortos e os vivifica, assim também o Filho vivifica aqueles que quer.
22 Di Papa nor dey judge anybody, but e don give en pikin pawa to judge evribody,
22 E também o Pai a ninguém julga, mas deu ao Filho todo o juízo,
23 so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.
23 para que todos honrem o Filho, como honram o Pai. Quem não honra o Filho não honra o Pai, que o enviou.
24 “I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.
24 Na verdade, na verdade vos digo que quem ouve a minha palavra e crê naquele que me enviou tem a vida eterna e não entrará em condenação, mas passou da morte para a vida.
25 I tell una true word, di time dey kom and e don even rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again.
25 Em verdade, em verdade vos digo que vem a hora, e agora é, em que os mortos ouvirão a voz do Filho de Deus, e os que a ouvirem viverão.
26 Bikos as di Papa get life for inside am, na so e give en pikin life too.
26 Porque, como o Pai tem a vida em si mesmo, assim deu também ao Filho ter a vida em si mesmo.
27 Di Papa don give en pikin di pawa to judge pipol.
27 E deu-lhe o poder de exercer o juízo, porque é o Filho do Homem.
28 “So, make dis word nor sopraiz una, bikos di time dey kom, wen all doz wey dey inside grave go hear di pikin vois,
28 Não vos maravilheis disso, porque vem a hora em que todos os que estão nos sepulcros ouvirão a sua voz.
29 and di angels go kon separate di pipol wey do good tins, so dat dem go enter life wey nor dey end, but God go kondemn di pipol wey dey do bad tins.
29 E os que fizeram o bem sairão para a ressurreição da vida; e os que fizeram o mal, para a ressurreição da condenação.
30 I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.
30 Eu não posso de mim mesmo fazer coisa alguma; como ouço, assim julgo, e o meu juízo é justo, porque não busco a minha vontade, mas a vontade do Pai, que me enviou.
31 “If I tok about mysef, e fit bi sey wetin I tok nor bi true”,
31 Se eu testifico de mim mesmo, o meu testemunho não é verdadeiro.
32 bikos anoda pesin dey wey go tok about mi and I know sey wetin e tok about mi, na true.
32 Há outro que testifica de mim, e sei que o testemunho que ele dá de mim é verdadeiro.
33 “Una don send message go meet John and e don tell una true word.
33 Vós mandastes a João, e ele deu testemunho da verdade.
34 (I nor dey trust wetin pipol tok, but I dey tell una dis word make God for save una.)
34 Eu, porém, não recebo testemunho de homem, mas digo isso, para que vos salveis.
35 John lite shine well-well for small time and una happy wen una si en lite.”
35 Ele era a candeia que ardia e alumiava; e vós quisestes alegrar-vos por um pouco de tempo com a sua luz.
36 But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi.
36 Mas eu tenho maior testemunho do que o de João, porque as obras que o Pai me deu para realizar, as mesmas obras que eu faço testificam de mim, de que o Pai me enviou.
37 And my Papa wey send mi, en ensef don bear witness about mi. Una neva hear my Papa vois or si am before.
37 E o Pai, que me enviou, ele mesmo testificou de mim. Vós nunca ouvistes a sua voz, nem vistes o seu parecer;
38 En word neva still dey inside una, bikos una nor bilive sey na-im send mi.
38 e a sua palavra não permanece em vós, porque naquele que ele enviou não credes vós.
39 Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,
39 Examinais as Escrituras, porque vós cuidais ter nelas a vida eterna, e são elas que de mim testificam.
40 but una nor ready to kom meet mi, so dat una go get life wey nor dey end.
40 E não quereis vir a mim para terdes vida.
41 “I nor like make pipol dey praiz mi,
41 Eu não recebo glória dos homens,
42 bikos I know sey, una nor love God for inside una heart.
42 mas bem vos conheço, que não tendes em vós o amor de Deus.
43 I kom with my Papa name and una nor gri asept mi, but if anoda pesin kom with en own name, una go asept am.
43 Eu vim em nome de meu Pai, e não me aceitais; se outro vier em seu próprio nome, a esse aceitareis.
44 How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.
44 Como podeis vós crer, recebendo honra uns dos outros e não buscando a honra que vem só de Deus?
45 “Make una nor tink sey I go akuiz una before my Papa. Di tin wey go stand against una na di law wey Moses rite, wey una dey put hope for.
45 Não cuideis que eu vos hei de acusar para com o Pai. Há um que vos acusa, Moisés, em quem vós esperais.
46 If una bilive wetin Moses rite for di law, una suppose to bilive mi too, bikos na mi e rite about.
46 Porque, se vós crêsseis em Moisés, creríeis em mim, porque de mim escreveu ele.
47 But if una nor bilive wetin Moses rite, how una go take bilive wetin I dey tell una naw?”
47 Mas, se não credes nos seus escritos, como crereis nas minhas palavras?
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.