João 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Jesus kon know sey di Farisee pipol don hear sey e dey baptize plenty pipol pass John and di pipol dey follow am,
1 Quando Jesus soube que os fariseus tinham ouvido dizer que ele fazia e batizava mais discípulos do que João
2 (aldo nor bi Jesus ensef dey baptize pipol, but na en disciples dey do am).
2 — se bem que Jesus mesmo não batizava, e sim os seus discípulos —,
3 Jesus komot for Judea dey go Galilee.
3 deixou a Judeia, retirando-se outra vez para a Galileia.
4 For am to rish der, e go must pass thru Samaria.
4 E era-lhe necessário passar pela região da Samaria.
5 E kon rish one town for Samaria wey dem dey koll Saikar, wey near di land wey Jakob give Josef, wey bi en pikin.
5 Assim, Jesus chegou a uma cidade samaritana, chamada Sicar, perto das terras que Jacó tinha dado a seu filho José.
6 Jakob well dey der too. Dat aftanoon, bikos Jesus don taya to waka, e kon sidan near di well.
6 Ali ficava o poço de Jacó. Cansado da viagem, Jesus sentou-se junto ao poço. Era por volta do meio-dia.
7 So one woman for di town kom draw wota for di well. Jesus tell am, “Abeg give mi wota make I drink.”
7 Nisso veio uma mulher samaritana tirar água. Jesus lhe disse:
8 By dis time, en disciples don go inside di town go buy food.
8 Pois os seus discípulos tinham ido à cidade comprar alimentos.
9 Den di woman kon tell Jesus, “How yu wey bi Jew kon dey ask mi wey bi Samaria pesin, sey, ‘Make I give yu wota drink?’ ” (E tok dis one bikos Jew and Samaria pipol nor dey gri at-all.)
9 Então a mulher samaritana perguntou a Jesus: — Como, sendo o senhor um judeu, pede água a mim, que sou mulher samaritana? Ela disse isso porque os judeus não se dão com os samaritanos.
10 Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”
10 Jesus respondeu:
11 Di woman ask am, “Oga God, yu nor get bucket and di well deep well-well, where yu go fit get dat kind wota?
11 Ao que a mulher respondeu: — O senhor não tem balde e o poço é fundo. De onde vai conseguir essa água viva?
12 Yu big pass awa grand-grand papa Jakob wey give us dis well, where en family and animals dey drink from?”
12 Por acaso o senhor é maior do que Jacó, o nosso pai, que nos deu o poço, do qual ele mesmo bebeu, assim como os seus filhos e o seu gado?
13 Jesus ansa, “Pesin wey drink from dis wota go always dey hongry for wota.
13 Jesus respondeu:
14 But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”
14 mas aquele que beber da água que eu lhe der nunca mais terá sede. Pelo contrário, a água que eu lhe der será nele uma fonte a jorrar para a vida eterna.
15 Di woman kon tell am, “Oga God, give mi dis wota, so dat I nor go hongry for wota or kom here kon draw wota again.”
15 A mulher lhe disse: — Senhor, quero que me dê essa água para que eu não mais tenha sede, nem precise vir aqui buscá-la.
16 Jesus tell am, “Go koll yor husband, make two of una kom meet mi.”
16 Jesus disse:
17 Di woman ansa, “I nor get husband.”
17 Ao que a mulher respondeu: — Não tenho marido. Então Jesus disse:
18 Bikos yu don marry five husband before and di man wey yu dey stay with naw, nor bi yor real husband. Na true yu tok.”
18 Porque já teve cinco, e esse que agora tem não é seu marido. O que você disse é verdade.
19 Di woman kon tell am, “Oga God, I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go happen.
19 A mulher então lhe disse: — Agora eu sei que o senhor é um profeta!
20 Awa papa dem serve God for dis mountin, but una kon tok sey, di place wey pipol suppose to woship God, na Jerusalem e dey.”
20 Nossos pais adoravam neste monte, mas vocês dizem que em Jerusalém é o lugar onde se deve adorar.
21 Jesus kon sey, “Woman, make yu bilive mi, di time dey kom, wen pipol go woship God for anywhere wey dem dey, nor bi only for dis mountin or for Jerusalem.
21 Jesus respondeu:
22 Una dey serve wetin una nor know, but wi dey serve wetin wi know, bikos na Jew pipol, naim God first koll to ensef.
22 Vocês adoram o que não conhecem; nós adoramos o que conhecemos, porque a salvação vem dos judeus.
23 But di time dey kom and e don even rish, wen di pipol wey won really serve God, go serve am for di true way, wey God Spirit go show dem.
23 Mas vem a hora — e já chegou — em que os verdadeiros adoradores adorarão o Pai em espírito e em verdade. Porque são esses que o Pai procura para seus adoradores.
24 God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”
24 Deus é Espírito, e é necessário que os seus adoradores o adorem em espírito e em verdade.
25 Di woman ansa, “I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ), wey go save evribody, go kom and anytime wen e kom, e go tell us evritin.”
25 A mulher respondeu: — Eu sei que virá o Messias, chamado Cristo. Quando ele vier, nos anunciará todas as coisas.
26 Jesus kon tell am, “Na mi wey dey tok to yu so, bi di Mezaya.”
26 Então Jesus disse:
27 Wen Jesus dey tok to di woman, en disciples kon kom back. Dem sopraiz sey e dey tok with one woman, but dem nor fit ask am, “Wetin e wont?” or “Why e dey tok to di woman?”
27 Naquele momento, chegaram os discípulos de Jesus e se admiraram ao vê-lo falando com uma mulher. Mas nenhum deles perguntou: “O que você está querendo?” Ou: “Por que o senhor está falando com ela?”
28 By dis time, di woman don leave en pot wey e take kom draw wota kon run go inside di town go tell pipol sey,
28 Quanto à mulher, deixou o seu cântaro, foi à cidade e disse ao povo:
29 “Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do. Dis man nor bi di Mezaya so?”
29 — Venham comigo e vejam um homem que me disse tudo o que eu já fiz. Não seria ele, por acaso, o Cristo?
30 So di pipol kom out for di town go meet Jesus.
30 Então saíram da cidade e foram até onde Jesus estava.
31 By dis time, di disciples kon beg am, “Tisha, make yu chop sometin naw.”
31 Enquanto isso, os discípulos pediam a Jesus, dizendo: — Mestre, coma!
32 But e tell dem, “I get food wey I go chop wey una nor know about.”
32 Mas ele lhes disse:
33 Di disciples kon dey ask demsef, “Abi somebody don bring sometin for am to chop wen wi nor dey here?”
33 Então os discípulos começaram a dizer entre si: — Será que alguém lhe trouxe algo para comer?
34 Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.
34 Jesus lhes declarou:
35 Nor bi una dey tok sey, ‘Na for monts remain before dem go plok fruit wey dem plant for farm?’ Make una look round and una go si sey fruit don ripe rish to plok.
35 Vocês não dizem que ainda faltam quatro meses até a colheita? Eu, porém, lhes digo: Levantem os olhos e vejam os campos, pois estão maduros para a colheita.
36 God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go happy togeda.
36 Quem colhe recebe desde já a recompensa e ajunta o seu fruto para a vida eterna, para que se alegrem ao mesmo tempo o que semeia e o que colhe.
37 Dis one show sey, di tin wey pipol dey tok sey, ‘One pesin plant and anoda pesin plok di fruit’, na true word.
37 Pois, no caso, é verdadeiro o ditado: “Um é o que semeia, outro é o que colhe.”
38 I send una go plok wetin una nor plant. Oda pipol don sofa plant dem, but una kon enjoy wetin dem sofa for.”
38 Eu os enviei a colher o que vocês não semearam; outros trabalharam, e vocês aproveitaram o trabalho deles.
39 By dis time, many pipol from Samaria town kon bilive am, bikos of di tins wey di woman tok, “E tell mi all di tins wey I don do.”
39 Muitos samaritanos daquela cidade creram em Jesus, por causa do testemunho da mulher, que tinha dito: “Ele me disse tudo o que eu já fiz.”
40 Wen Samaria pipol kom meet am, dem kon dey beg am sey, make e stay with dem. So e kon stay der for two days,
40 Quando, pois, os samaritanos foram até Jesus, pediram-lhe que permanecesse com eles; e Jesus ficou ali dois dias.
41 and bikos of wetin e tok, many pipol kon bilive am.
41 Muitos outros creram nele, por causa da palavra de Jesus.
42 Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”
42 E diziam à mulher: — Agora não é mais por causa do que você falou que nós cremos, mas porque nós mesmos ouvimos, e sabemos que este é verdadeiramente o Salvador do mundo.
43 Wen two days pass, Jesus komot from der go Galilee.
43 Passados dois dias, Jesus saiu dali e foi para a Galileia.
44 (Bikos Jesus don tok am sey, “Pesin wey bi profet nor dey get respet for en home-town”).
44 Porque o próprio Jesus testemunhou que um profeta não tem honra na sua própria terra.
45 Wen e rish Galilee, di pipol wey dey der kon welkom am, bikos dem don si all di tins wey e do for Jerusalem for di time wen dem dey do Passova Feast.
45 Assim, quando chegou à Galileia, os galileus o receberam, porque viram todas as coisas que Jesus tinha feito em Jerusalém, por ocasião da festa, à qual eles também tinham comparecido.
46 Again, e go Kana wey dey Galilee, for where e first turn wota to wine. For Kapanaum, one soja-man wey dey work for di king palis dey der and en pikin wey nor well.
46 Jesus foi outra vez a Caná da Galileia, onde tinha transformado água em vinho. E havia ali um oficial do rei, cujo filho estava doente em Cafarnaum.
47 Wen e hear sey Jesus don kom back to Galilee, e go meet am kon beg am sey make e kom heal en pikin wey won die.
47 Quando ouviu dizer que Jesus tinha vindo da Judeia para a Galileia, foi até ele e pediu-lhe que fosse curar o seu filho, que estava morrendo.
48 So Jesus ask am, “If una nor si signs and wonders una nor go bilive mi?”
48 Então Jesus lhe disse:
49 Di man ansa, “Oga God, abeg make yu kom before my pikin go die.”
49 O oficial pediu mais uma vez: — Senhor, venha, antes que o meu filho morra!
50 Jesus kon tell am, “Make yu go house, yor pikin nor go die.”
50 Jesus respondeu: O homem creu na palavra de Jesus e partiu.
51 Wen e don near house, en savants kon meet, tell am sey, “Yor pikin don well, e nor die.”
51 Quando já estava a caminho, os seus servos vieram ao encontro dele, anunciando-lhe que o seu filho estava vivo.
52 So, e ask dem di time wen di pikin bigin dey betta. Dem kon tell am, “Na yestiday for one oklok for aftanoon naim e well.”
52 Então perguntou a que horas o seu filho havia se sentido melhor. Informaram: — Ontem, à uma hora da tarde a febre o deixou.
53 Bikos of wetin dem tok, di pikin papa kon remember sey dat na di time wen Jesus tell am sey, “Yor pikin nor go die.” Bikos of dis, di man and evribody wey dey en house kon bilive Jesus.
53 Com isso, o pai reconheceu que aquela era precisamente a hora em que Jesus tinha dito a ele: “O seu filho vai viver.” E ele e toda a sua casa creram.
54 Dis na di sekond mirakle wey Jesus do for Galilee, afta e kom back from Judea.
54 Este foi o segundo sinal que Jesus fez, depois de ir da Judeia para a Galileia.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.