João 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 E get one man wey bi Farisee, en name na Nikodimos and e bi memba for di kansol wey dey rule Jew pipol.
1 Havia entre os fariseus um homem chamado Nicodemos, um dos principais dos judeus.
2 E hide go meet Jesus for nite kon tell am, “Tisha, wi know sey yu bi di pesin wey God send kom meet us, bikos nobody fit do di mirakles wey yu dey do, unless God dey with am.”
2 Este, de noite, foi até Jesus e lhe disse: — Rabi, sabemos que o senhor é Mestre vindo da parte de Deus, porque ninguém pode fazer estes sinais que o senhor faz, se Deus não estiver com ele.
3 Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”
3 Jesus respondeu:
4 Den Nikodimos ask am, “How dem go fit take born pesin wey don old for di sekond time? Abi di pesin go enter en mama belle make di mama born am again? E fit happen like dat?”
4 Nicodemos perguntou: — Como pode um homem nascer, sendo velho? Será que pode voltar ao ventre materno e nascer uma segunda vez?
5 Jesus ansa am, “I tell yu di trut, unless God born pesin with wota and en Spirit, di pesin nor go fit enter God kingdom.
5 Jesus respondeu:
6 Wetin flesh born, na flesh e bi, but wetin God Spirit born, na spirit e bi.
6 O que é nascido da carne é carne, e o que é nascido do Espírito é espírito.
7 So, make yu nor konfuse bikos I tok sey, ‘God go born yu for di sekond time.’
7 Não fique admirado por eu dizer: “Vocês precisam nascer de novo.”
8 Wen breeze dey blow, e dey go anywhere e wont, yu dey hear di sound wey e dey make, but yu nor fit know where e dey kom from or where e dey go. Na so e bi with evribody wey God Spirit born.”
8 O vento sopra onde quer, você ouve o barulho que ele faz, mas não sabe de onde ele vem, nem para onde vai; assim é todo o que é nascido do Espírito.
9 Nikodimos kon ask am, “How dis tins go fit happen?”
9 Então Nicodemos perguntou: — Como pode ser isso? Jesus respondeu:
10 Jesus ansa, “Yu bi tisha for Israel, yet yu nor fit undastand dis tins?
10 — Você é mestre em Israel e não compreende estas coisas?
11 Make I tell yu di trut, wi dey tok wetin wi sabi and dey bear witness for wetin wi don si with awa eyes, but una nor gri asept wetin wi tok.
11 Em verdade, em verdade lhe digo que nós falamos do que sabemos e damos testemunho do que vimos, mas vocês não aceitam o nosso testemunho.
12 Naw, if I dey tell una about di tins wey dey for dis world and una nor fit bilive wetin I tok, how una go fit take bilive mi, if I bigin dey tell una about di tins wey dey for heaven?
12 Se vocês não creem quando falo sobre coisas terrenas, como crerão se eu lhes falar sobre as celestiais?
13 Nobody don go heaven before, escept Man Pikin wey kom down from heaven and e go-go back der.
13 Ora, ninguém subiu ao céu, a não ser aquele que de lá desceu, o Filho do Homem.
14 Yu si, as Moses karry di snake go up wen dem dey inside desert, na so too dem go karry Man Pikin up,
14 — E assim como Moisés levantou a serpente no deserto, assim também é necessário que o Filho do Homem seja levantado,
15 so dat anybody wey bilive am, go get life wey nor dey end.
15 para que todo o que nele crê tenha a vida eterna.
16 “God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
16 Porque Deus amou o mundo de tal maneira que deu o seu Filho unigênito, para que todo o que nele crê não pereça, mas tenha a vida eterna.
17 God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world, but make e kom save dem.
17 Porque Deus enviou o seu Filho ao mundo, não para que condenasse o mundo, mas para que o mundo fosse salvo por ele.
18 Anybody wey bilive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor bilive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor bilive God Pikin name.
18 Quem nele crê não é condenado; mas o que não crê já está condenado, porque não crê no nome do unigênito Filho de Deus.
19 Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.
19 A condenação é esta: a luz veio ao mundo, mas os homens amaram mais as trevas do que a luz, porque as suas obras eram más.
20 Yu si, evribody wey dey do bad tins dey hate lite and dem nor go gri kom out for where lite dey, make pipol nor for si di bad tins wey dem dey do.
20 Pois todo aquele que pratica o mal detesta a luz e não se aproxima da luz, para que as suas obras não sejam reprovadas.
21 But di pesin wey dey do good tins, dey kom out for lite, so dat pipol go si di tins wey e dey do, bikos na as God wont naim e dey do.”
21 Quem pratica a verdade se aproxima da luz, para que as suas obras sejam manifestas, porque são feitas em Deus.
22 Leta, Jesus and en disciples go Judea aria and dem kon stay der for sometaim dey baptize pipol.
22 Depois disso, Jesus foi com os seus discípulos para a terra da Judeia; ali permaneceu com eles e batizava.
23 John dey baptize for Aenon, one town wey near Salim, bikos plenty wota dey der and pipol dey kom meet am make e baptize dem.
23 Ora, João também estava batizando em Enom, perto de Salim, porque ali havia muitas águas, e o povo se dirigia para lá e era batizado.
24 (For dis time, dem neva put John for prison).
24 Pois João ainda não havia sido preso.
25 Den one Jew man kon dey argue with John disciples about how dem suppose to wosh dia body as dia tradishon tok.
25 Então surgiu uma discussão entre os discípulos de João e um judeu a respeito da purificação.
26 Some among dem go meet John kon tell am, “Oga God, di pesin wey dey with yu for di oda side for Jordan River, wey yu tok about before, en too, dey baptize pipol and evribody dey rush go meet am.”
26 E foram até João e lhe disseram: — Mestre, aquele que estava com o senhor no outro lado do Jordão, do qual o senhor deu testemunho, está batizando, e todos vão até ele.
27 John ansa dem, “Nobody go fit get anytin unless God wey dey heaven, gi-am.
27 João respondeu: — Ninguém pode receber coisa alguma se não lhe for dada do céu.
28 Unasef go fit bear witness sey, I tok sey I nor bi di Christ, but God send mi kom, before Christ go kom.
28 Vocês mesmos são testemunhas de que eu disse: “Eu não sou o Cristo, mas fui enviado como o seu precursor.”
29 Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.
29 O que tem a noiva é o noivo; o amigo do noivo que está presente e o escuta se alegra muito por causa da voz do noivo. Pois essa alegria já se cumpriu em mim.
30 Pipol must know Christ pass as dem know mi.
30 Convém que ele cresça e que eu diminua.
31 “Di pesin wey kom from heaven betta pass evribody wey dey for dis world. And who dey dis world, dey tok about di tins wey dey inside di world.
31 Quem vem das alturas certamente está acima de todos; quem vem da terra é terreno e fala da terra. Quem veio do céu está acima de todos
32 But di pesin wey kom from heaven dey tok about wetin e si and hear for heaven, but pipol nor gri listin to am.
32 e dá testemunho daquilo que viu e ouviu, mas ninguém aceita o seu testemunho.
33 But pesin wey bilive wetin e tok about God, bilive sey wetin God tok, na true.
33 Quem, porém, aceita o testemunho que ele dá certifica que Deus é verdadeiro.
34 Di pesin wey God send dey tok about God word, bikos God dey give en Spirit to pipol.
34 Pois aquele que Deus enviou fala as palavras de Deus, porque Deus não dá o Espírito por medida.
35 God love en pikin well-well and E gi-am pawa to kontrol evritin.
35 O Pai ama o Filho e entregou todas as coisas nas mãos dele.
36 Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
36 Por isso, quem crê no Filho tem a vida eterna; quem se mantém rebelde contra o Filho não verá a vida, mas sobre ele permanece a ira de Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.