João 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Wen three days don pass, Mary, wey bi Jesus mama, go one marriage for Kana, wey dey for Galilee.
1 E, ao terceiro dia, fizeram-se umas bodas em Caná da Galiléia; e estava ali a mãe de Jesus.
2 Dem invite Jesus and en disciple for di marriage too.
2 E foi também convidado Jesus e os seus discípulos para as bodas.
3 Wen wine finish, Jesus mama kon tell am, “Dia wine don finish.”
3 E, faltando vinho, a mãe de Jesus lhe disse: Não têm vinho.
4 Jesus ansa am, “Mama, why yu dey tell mi? My time neva rish.”
4 Disse-lhe Jesus: Mulher, que tenho eu contigo? Ainda não é chegada a minha hora.
5 So en mama kon tell di savants sey, “Anytin wey e tell una, make una do am.”
5 Sua mãe disse aos serventes: Fazei tudo quanto ele vos disser.
6 For dat place, six big wota pot dey and only one fit kontain about twenty to thirty gallon for wota, wey di Jew pipol dey use wosh leg as dia tradishon tok.
6 E estavam ali postas seis talhas de pedra, para as purificações dos judeus, e em cada uma cabiam dois ou três almudes.
7 Jesus tell di savants, “Make una full di pots with wota.” So dem kon full all di pot with wota.
7 Disse-lhes Jesus: Enchei de água essas talhas. E encheram-nas até em cima.
8 Jesus tell dem, “Make una take some wota from di pot go give di chairman for di party.”
8 E disse-lhes: Tirai agora, e levai ao mestre-sala. E levaram.
9 Wen di chairman taste di wota wey don turn to wine, bikos e nor know how e happen (but di savants wey draw di wota know), e koll di man wey dey marry kon tell am sey,
9 E, logo que o mestre-sala provou a água feita vinho (não sabendo de onde viera, se bem que o sabiam os serventes que tinham tirado a água), chamou o mestre-sala ao esposo,
10 “Wen pesin dey do party, na betta wine e dey first serve pipol, den wen di pipol don drink taya, naim e dey serve cheap wine. But yu kon keep di good wine until di party don one finish.”
10 E disse-lhe: Todo o homem põe primeiro o vinho bom e, quando já têm bebido bem, então o inferior; mas tu guardaste até agora o bom vinho.
11 Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee. Dis na how e show en honor, so en disciples kon bilive am.
11 Jesus principiou assim os seus sinais em Caná da Galiléia, e manifestou a sua glória; e os seus discípulos creram nele.
12 Den Jesus with en mama, brodas and en disciples kon go Kapanaum. Dem kon stay der for some days.
12 Depois disto desceu a Cafarnaum, ele, e sua mãe, e seus irmãos, e seus discípulos; e ficaram ali não muitos dias.
13 By dis time, di Jew Passova Feast don near well-well, so Jesus kon go Jerusalem.
13 E estava próxima a páscoa dos judeus, e Jesus subiu a Jerusalém.
14 E si di pipol dey sell melu, sheep and dove inside di temple yard and e still si pipol wey dey shange money, sidan near dia tabol.
14 E achou no templo os que vendiam bois, e ovelhas, e pombos, e os cambiadores assentados.
15 So e use koboko wey e make, take drive dem with dia sheep and melu komot from di temple yard. E trowey di tabol wey di pipol dey take shange money and dia money kon skata.
15 E tendo feito um azorrague de cordéis, lançou todos fora do templo, também os bois e ovelhas; e espalhou o dinheiro dos cambiadores, e derribou as mesas;
16 E kon tell di pipol wey dey sell dove, “Make una karry all dis tins komot for here. Make una nor turn my Papa house to market.”
16 E disse aos que vendiam pombos: Tirai daqui estes, e não façais da casa de meu Pai casa de venda.
17 Den en disciples kon remember as den rite for Psalms Book sey, “Di love wey e get for en Papa house dey burn for en heart like fire.”
17 E os seus discípulos lembraram-se do que está escrito: O zelo da tua casa me devorou.
18 Di Jew oga dem kon ask am, “As yu dey do all dis tins, na wish sign yu go show us make wi for fit bilive yu?”
18 Responderam, pois, os judeus, e disseram-lhe: Que sinal nos mostras para fazeres isto?
19 Jesus ansa dem, “Even if una distroy dis Temple, for three days time, I go build am again.”
19 Jesus respondeu, e disse-lhes: Derribai este templo, e em três dias o levantarei.
20 Den di Jew oga dem tell am, “Na forty-six years dem take build dis Temple and yu dey sey yu go fit build am for three days?”
20 Disseram, pois, os judeus: Em quarenta e seis anos foi edificado este templo, e tu o levantarás em três dias?
21 But na di temple for Jesus body naim e dey tok about.
21 Mas ele falava do templo do seu corpo.
22 So wen Jesus don wake-up from deat, en disciples kon remember sey, e tok so before. Den dem kon bilive wetin dem rite for God word and wetin Jesus tell dem.
22 Quando, pois, ressuscitou dentre os mortos, os seus discípulos lembraram-se de que lhes dissera isto; e creram na Escritura, e na palavra que Jesus tinha dito.
23 Jesus dey for Jerusalem by di time wey dem dey do di Passova Feast. For der, many pipol kon bilive am, bikos dem si di mirakles wey e do.
23 E, estando ele em Jerusalém pela páscoa, durante a festa, muitos, vendo os sinais que fazia, creram no seu nome.
24 But Jesus nor gri open en mind give di pipol, bikos e know dem well-well.
24 Mas o mesmo Jesus não confiava neles, porque a todos conhecia;
25 E nor nid anybody to tok about am, bikos e know wetin dey inside pipol belle, so e nor fit trust dem.
25 E não necessitava de que alguém testificasse do homem, porque ele bem sabia o que havia no homem.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.