João 21
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 Afta dis, Jesus show ensef again to en disciples near Tiberias Sea. Dis na how e do am.
1 Depois disso, Jesus apareceu novamente a seus discípulos junto ao mar de Tiberíades. Foi assim que aconteceu:
2 Simon Pita and Tomas (wey bi twins), with Netanel (wey en town bi Kana for Galilee), with Zebedee pikin and two oda Jesus disciples, kon gada togeda.
2 estavam ali Simão Pedro, Tomé, apelidado de Gêmeo, Natanael, de Caná da Galileia, os filhos de Zebedeu e outros dois discípulos.
3 Simon Pita kon tell dem, “I dey go katch fish.” Dem sey, “Wi too go follow yu go.” Den dem komot go enter one kenu. But dat nite dem nor katch any fish.
3 Simão Pedro disse: “Vou pescar”. “Nós também vamos”, disseram os outros. Assim, entraram no barco e foram, mas não pegaram coisa alguma a noite toda.
4 Wen day break, Jesus stand for di wotaside, but di disciples nor know sey naim dey der.
4 Ao amanhecer, Jesus estava na praia, mas os discípulos não o reconheceram.
5 Jesus kon ask dem, “My shidren, una katch any fish?”
5 Ele perguntou: “Filhos, por acaso vocês têm peixe para comer?”. “Não”, responderam eles.
6 E kon tell dem, “Make una trow una net go di rite side for di kenu and una go katch some fish.” Wen dem don trow dia net inside di river, dem nor fit draw am komot from di wota, bikos di fish wey dem katch, plenty well-well.
6 Então ele disse: “Lancem a rede para o lado direito do barco e pegarão”. Fizeram assim e não conseguiam recolher a rede, de tão cheia de peixes que estava.
7 Den, John, di disciple wey Jesus love kon tell Pita, “Dis man na Jesus o-o.” Wen Simon Pita hear sey di man na Jesus, e kon kwik-kwik tie en klot well (bikos e nor wear anytin under), den e jump inside di river.
7 O discípulo a quem Jesus amava disse a Pedro: “É o Senhor!”. Quando Simão Pedro ouviu que era o Senhor, vestiu a capa, pois a havia removido para trabalhar, e saltou na água.
8 By dis time, di oda disciples dey inside di kenu dey pul di net with di plenty fish go rish groun for di wotaside (bikos where dem dey, na about one hundred yard from di wotaside).
8 Os outros ficaram no barco e puxaram até a praia a rede carregada, pois estavam a apenas uns noventa metros de distância.
9 Wen dem don kom down from di kenu, dem kon si shako fire with fish and some bread on-top am.
9 Quando chegaram, encontraram um braseiro, no qual havia um peixe, e pão.
10 Jesus tell dem, “Make una bring some for di fish wey una katch kom.”
10 Jesus disse: “Tragam alguns dos peixes que vocês acabaram de pegar”.
11 Den Simon Pita enter di kenu kon pul di net kom groun. Di net katch plenty big-big fish wey rish one hundred and fifty-three and di net nor tear.
11 Simão Pedro entrou no barco e arrastou a rede para a praia. Havia 153 peixes grandes e, no entanto, a rede não arrebentou.
12 Jesus tell dem, “Make una kom chop.” But dem nor fit ask am, “Who yu bi”, bikos dem bilive sey na Jesus e bi.
12 “Venham comer!”, disse Jesus. Nenhum dos discípulos tinha coragem de perguntar: “Quem é você?”, pois sabiam muito bem que era o Senhor.
13 Den Jesus kon give dem bread and fish.
13 Então Jesus lhes serviu o pão e o peixe.
14 Dis make am di third time wen Jesus show ensef to en disciples, afta e don raiz-up from grave.
14 Foi a terceira vez que Jesus apareceu a seus discípulos depois de ressuscitar dos mortos.
15 Wen dem don chop finish, Jesus ask Simon Pita, “Simon, John pikin, yu love mi pass all dis tins?”
15 Depois da refeição, Jesus perguntou a Simão Pedro: “Simão, filho de João, você me ama mais do que estes?”. “Sim, Senhor”, respondeu Pedro. “O senhor sabe que eu o amo”. “Então alimente meus cordeiros”, disse Jesus.
16 Jesus ask am again, “Simon, John pikin, yu really tink sey yu love mi?”
16 Jesus repetiu a pergunta: “Simão, filho de João, você me ama?”. “Sim, Senhor”, disse Pedro. “O senhor sabe que eu o amo”. “Então cuide de minhas ovelhas”, disse Jesus.
17 Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?”
17 Pela terceira vez, ele perguntou: “Simão, filho de João, você me ama?”. Pedro ficou triste porque Jesus fez a pergunta pela terceira vez e disse: “O Senhor sabe todas as coisas. Sabe que eu o amo”. Jesus disse: “Então alimente minhas ovelhas.
18 I tell yu true word, wen yu dey small, yu dey do as yu like, dey dress as yu like and dey go anywhere wey yu wont, but wen yu go old, yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and karry yu go where yu nor won go.”
18 “Eu lhe digo a verdade: quando você era jovem, podia agir como bem entendia; vestia-se e ia aonde queria. Mas, quando for velho, estenderá as mãos e outros o vestirão e o levarão aonde você não quer ir”.
19 (Jesus tok dis to show how Pita go die, so dat God go get honor). Afta Jesus tok finish, e kon tell Pita, “Make yu follow mi.”
19 Jesus disse isso para informá-lo com que tipo de morte ele iria glorificar a Deus. Então Jesus lhe disse: “Siga-me”.
20 Wen Pita turn round, e kon si John, (di disciple wey Jesus love well-well), dey follow dem. (Dis na di disciple wey bend en head near Jesus chest wen dem dey chop kon ask am, “Oga God, who bi di pesin wey go sell yu give yor enemy?”)
20 Pedro se virou e viu atrás deles o discípulo a quem Jesus amava, aquele que havia se reclinado perto de Jesus durante a ceia e perguntado: “Senhor, quem o trairá?”.
21 Wen Pita si am, e kon ask Jesus, “Oga God, wot about dis man?”
21 Pedro perguntou a Jesus: “Senhor, e quanto a ele?”.
22 Jesus ansa am, “Make yu mind yor own business. If I wont sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside? Make yu yorsef follow mi.”
22 Jesus respondeu: “Se eu quiser que ele permaneça vivo até eu voltar, o que lhe importa? Quanto a você, siga-me”.
23 Den di rumor kon dey spread among di brodas and sistas sey, di disciple nor go die. But Jesus nor really tell Pita sey di oda disciple nor go die, but e sey, “If I won sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside?”
23 Por isso espalhou-se entre a comunidade dos irmãos o rumor de que esse discípulo não morreria. Não foi isso, porém, o que Jesus disse. Ele apenas disse: “Se eu quiser que ele permaneça vivo até eu voltar, o que lhe importa?”.
24 Na dis bi di disciple wey bear witness about all dis tins and wey rite dem and wi know sey wetin e rite, na true.
24 Este é o discípulo que dá testemunho destes acontecimentos e que os registrou aqui. E sabemos que seu relato é fiel.
25 Jesus do many oda tins wey dem nor rite down. If to sey dem rite all of dem, di world nor go get space wey go kontain all di book, where dem rite dem put.
25 Jesus também fez muitas outras coisas. Se todas fossem registradas, suponho que nem o mundo inteiro poderia conter todos os livros que seriam escritos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.