João 20
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 For di first day for di week, wen day neva break well, Mary Magdalin kon go where di grave dey. E si sey dem don remove di stone wey dem take kover di grave mout.
1 No primeiro dia da semana, de madrugada, quando ainda estava escuro, Maria Madalena foi ao túmulo e viu que a pedra da entrada tinha sido removida.
2 Den e run go meet Simon Pita and John kon tell dem, “Somebody don karry Jesus body komot from di grave and wi nor know where dem put am.”
2 Então correu e foi até onde estavam Simão Pedro e o outro discípulo, a quem Jesus amava, e disse-lhes: — Tiraram o Senhor do túmulo, e não sabemos onde o colocaram.
3 So Pita and John kon go where di grave dey.
3 Com isso, Pedro e o outro discípulo saíram e foram até o túmulo.
4 Di two of dem kon dey run togeda, but John run pass Pita kon first am rish di grave.
4 Ambos corriam juntos, mas o outro discípulo correu mais depressa do que Pedro e chegou primeiro ao túmulo.
5 E nor enter inside di grave, but e bend down kon si di linen klot wey dem take wrap Jesus body for groun inside di grave.
5 E, abaixando-se, viu os lençóis de linho, mas não entrou.
6 Wen Simon Pita rish der, e enter inside di grave kon si di linen klot for groun too.
6 Simão Pedro, seguindo-o, chegou e entrou no túmulo. Ele também viu os lençóis
7 But di small klot wey dey for Jesus head nor dey for di same place where di oda klot dey, e dey on en own for one korna.
7 e o lenço que tinha estado sobre a cabeça de Jesus, e que não estava com os lençóis, mas enrolado num lugar à parte.
8 Den John kon enter inside and wetin e si kon make am bilive.
8 Então o outro discípulo, que havia chegado primeiro ao túmulo, também entrou. Ele viu e creu.
9 (Bikos dem undastand God word wey sey, Jesus go wake-up afta e die).
9 Pois ainda não tinham compreendido a Escritura, que era necessário que ele ressuscitasse dentre os mortos.
10 So di two disciple kon go back to dia house.
10 E os discípulos voltaram outra vez para casa.
11 But Mary stand for outside di grave dey kry. As e still dey kry, e kon bend down look inside di grave.
11 Maria, no entanto, permanecia junto à entrada do túmulo, chorando. Enquanto chorava, abaixou-se e olhou para dentro do túmulo.
12 Den e si two angel wey wear white klot sidan for where dem put Jesus body. One dey for where di head dey and di oda dey for where di leg dey.
12 Ela viu dois anjos vestidos de branco, sentados onde o corpo de Jesus tinha sido colocado, um à cabeceira e outro aos pés.
13 Dem kon ask am, “Woman, why yu dey kry?”
13 Então eles perguntaram: — Mulher, por que você está chorando? Ela respondeu: — Porque levaram o meu Senhor, e não sei onde o puseram.
14 Afta e tok finish, e turn round kon si Jesus stand for der, but e nor know sey na Jesus bi dat.
14 Depois de dizer isso, ela se virou para trás e viu Jesus em pé, mas não reconheceu que era Jesus.
15 Jesus tell am, “Woman, why yu dey kry? Na who yu dey find?”
15 Jesus lhe perguntou: Ela, supondo que ele fosse o jardineiro, respondeu: — Se o senhor o tirou daqui, diga-me onde o colocou, e eu o levarei.
16 Den Jesus koll am, “Mary.”
16 Jesus disse: Ela, voltando-se, lhe disse, em hebraico: — Raboni! (“Raboni” quer dizer “Mestre”.)
17 Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”
17 Jesus continuou:
18 Den Mary Magdalin go meet di disciples for where dem dey kon tell dem, “I don si di Oga God!” Den e tell dem wetin Jesus tell am.
18 Então Maria Madalena foi e anunciou aos discípulos: — Eu vi o Senhor! E contava que Jesus lhe tinha dito essas coisas.
19 Dat evening, for di first day for di week, en disciples kon gada togeda. Dem lock di door for di house wey dem dey, bikos dem dey fear di Jew oga dem. Jesus stand among dem kon sey, “Make peace dey with una.”
19 Ao cair da tarde daquele dia, o primeiro da semana, estando trancadas as portas da casa onde estavam os discípulos, com medo dos judeus, Jesus veio e se pôs no meio deles, dizendo:
20 Wen e don tok finish, e show dem en hand and di korna for en belle wey dem shuk with spear. Den di disciples kon happy well-well, wen dem si Jesus.
20 E, dizendo isso, lhes mostrou as mãos e o lado. Então os discípulos se alegraram ao ver o Senhor.
21 Den Jesus tell dem again, “Make peace dey with una. As my Papa send mi, na so I send una too.”
21 E Jesus lhes disse outra vez:
22 Wen e tok finish, e breath for dia body kon sey, “Make una receive di Holy Spirit.
22 E, havendo dito isso, soprou sobre eles e disse-lhes:
23 If una forgive anybody en sin, God go forgi-am, but if una nor forgive anybody en sin, God nor go forgi-am.”
23 Se de alguns vocês perdoarem os pecados, são-lhes perdoados; mas, se os retiverem, são retidos.
24 For dis time, Tomas (wey bi twins), one among di twelf disciples, nor dey der wen Jesus show ensef to dem.
24 Tomé, um dos doze, chamado Dídimo, não estava com eles quando Jesus veio.
25 Di oda disciples kon tell am, “Wi don si Jesus.”
25 Então os outros discípulos disseram a Tomé: — Vimos o Senhor. Mas ele respondeu: — Se eu não vir o sinal dos pregos nas mãos dele, ali não puser o dedo e não puser a minha mão no lado dele, de modo nenhum acreditarei.
26 Afta eight days, wen all di disciples gada again inside di house and Tomas dey der with dem dis time, even doh sey dem lock all di doors, Jesus show ensef kon stand among dem sey, “Make peace dey with una.”
26 Passados oito dias, os discípulos de Jesus estavam outra vez reunidos, e Tomé estava com eles. Estando as portas trancadas, Jesus veio, pôs-se no meio deles e disse:
27 Den e tell Tomas, “Put yor finger for my hand, make yu tosh am. Stresh yor hand put inside di korna for my belle. Make yu nor dey doubt again, but make yu bilive.”
27 E logo disse a Tomé:
28 Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”
28 Ao que Tomé lhe respondeu: — Senhor meu e Deus meu!
29 Den Jesus tell am, “So yu bilive naw, bikos yu don si mi? God go bless pipol wey neva take eye si mi, but dem bilive mi.”
29 Jesus lhe disse:
30 Jesus do many mirakles wen e dey with en disciples wey dem nor rite for dis book.
30 Na verdade, Jesus fez diante dos seus discípulos muitos outros sinais que não estão escritos neste livro.
31 But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.
31 Estes, porém, foram registrados para que vocês creiam que Jesus é o Cristo, o Filho de Deus, e para que, crendo, tenham vida em seu nome.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.