João 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Den Pilate kon sey make dem flog Jesus with koboko.
1 Pilatos mandou então flagelar Jesus.
2 Den di sojas go kut tree branches wey get shuku-shuku make crown put for en head and dem kon wear am klot wey dear well-well.
2 Os soldados teceram de espinhos uma coroa e puseram-lha sobre a cabeça e cobriram-no com um manto de púrpura.
3 Dem kon dey laf am, dey take am make yeye, dey sey, “Make una kon si di Jew pipol king.” Dem slap am for face many times.
3 Aproximavam-se dele e diziam: Salve, rei dos judeus! E davam-lhe bofetadas.
4 Pilate kom out again kon tell di Jew oga dem sey, “I won bring am kom out for una, to let una know sey I nor si anytin bad wey e do.”
4 Pilatos saiu outra vez e disse-lhes: Eis que vo-lo trago fora, para que saibais que não acho nele nenhum motivo de acusação.
5 So Jesus kom outside, with di shuku-shuku crown for en head and di fine klot wey dem gi-am wear. Den Pilate kon sey, “Na di man bi dis!”
5 Apareceu então Jesus, trazendo a coroa de espinhos e o manto de púrpura. Pilatos disse: Eis o homem!
6 Wen di priest oga dem and di temple polish dem si am, dem kon dey shaut, “Nail am for cross! Nail am for cross!”
6 Quando os pontífices e os guardas o viram, gritaram: Crucifica-o! Crucifica-o! Falou-lhes Pilatos: Tomai-o vós e crucificai-o, pois eu não acho nele culpa alguma.
7 Di Jew oga dem ansa, “Wi get law and di law sey, e suppose to die, bikos e sey en na God Pikin.”
7 Responderam-lhe os judeus: Nós temos uma lei, e segundo essa lei ele deve morrer, porque se declarou Filho de Deus.
8 Wen Pilate hear wetin dem tok, fear kon katch am well-well.
8 Estas palavras impressionaram Pilatos.
9 So e enter di house back kon ask Jesus, “Na where yu from kom sef?” But Jesus nor ansa am.
9 Entrou novamente no pretório e perguntou a Jesus: De onde és tu? Mas Jesus não lhe respondeu.
10 So Pilate kon sey, “Yu nor won tok to mi? Yu nor know sey I get pawa to free or kill yu?”
10 Pilatos então lhe disse: Tu não me respondes? Não sabes que tenho poder para te soltar e para te crucificar?
11 Jesus ansa, “Yu nor get pawa at-all for my life, escept God gi-am to yu. So, na di pipol wey bring mi kom meet yu, na dia sin big pass yor own.”
11 Respondeu Jesus: Não terias poder algum sobre mim, se de cima não te fora dado. Por isso, quem me entregou a ti tem pecado maior.
12 From dat time, Pilate kon bigin find way to free Jesus, but di Jew oga dem kon dey shaut, “If yu free dis man, yu nor bi Caesar friend. Anybody wey sey en bi king, na Caesar enemy e bi.”
12 Desde então Pilatos procurava soltá-lo. Mas os judeus gritavam: Se o soltares, não és amigo do imperador, porque todo o que se faz rei se declara contra o imperador.
13 Wen Pilate hear wetin dem tok, e bring Jesus kom out kon sidan for di chair for where e dey judge kase, (dem dey koll di chair, “Di Stone Pavement”, but na Gabbata dem dey koll am for Aramaik language.)
13 Ouvindo estas palavras, Pilatos trouxe Jesus para fora e sentou-se no tribunal, no lugar chamado Lajeado, em hebraico Gábata.
14 (Dat time na aftanoon for di day wen dem dey prepare for Passova Feast).
14 {Era a Preparação para a Páscoa, cerca da hora sexta.} Pilatos disse aos judeus: Eis o vosso rei!
15 Den, dem kon bigin dey shaut, “Kill-am trowey! Kill-am trowey! Make yu kill-am!”
15 Mas eles clamavam: Fora com ele! Fora com ele! Crucifica-o! Pilatos perguntou-lhes: Hei de crucificar o vosso rei? Os sumos sacerdotes responderam: Não temos outro rei senão César!
16 So Pilate kon gi-am to dem make dem go kill-am. Den dem kon take Jesus komot for der.
16 Entregou-o então a eles para que fosse crucificado.
17 As Jesus karry en cross dey go, e kon rish di place wey dem dey koll “Di Skull” (na Golgota dem dey koll di place for Aramaik language.)
17 Levaram então consigo Jesus. Ele próprio carregava a sua cruz para fora da cidade, em direção ao lugar chamado Calvário, em hebraico Gólgota.
18 For der, dem kon nail Jesus for cross. Dem still nail two oda pipol for cross, one for en rite and di oda for en left.
18 Ali o crucificaram, e com ele outros dois, um de cada lado, e Jesus no meio.
19 Pilate kon rite for sign-board wey dem nail on-top Jesus cross, wey sey, “dis na Jesus wey kom from Nazaret, wey bi di Jew pipol king.”
19 Pilatos redigiu também uma inscrição e a fixou por cima da cruz. Nela estava escrito: Jesus de Nazaré, rei dos judeus.
20 Since di place where dem kill Jesus near town, many of di Jew pipol wey dey for Jerusalem kom read di sign-board, bikos dem rite am for three language wey bi Aramaik, Latin and Greek.
20 Muitos dos judeus leram essa inscrição, porque Jesus foi crucificado perto da cidade e a inscrição era redigida em hebraico, em latim e em grego.
21 Den di shief priests kon tell Pilate, “Make yu nor rite sey, dis na Jew pipol king, but rite sey, dis man sey, ‘I bi Jew pipol king.’ ”
21 Os sumos sacerdotes dos judeus disseram a Pilatos: Não escrevas: Rei dos judeus, mas sim: Este homem disse ser o rei dos judeus.
22 But Pilate ansa dem, “Wetin I don rite finish, na so e go bi.”
22 Respondeu Pilatos: O que escrevi, escrevi.
23 Wen di sojas don nail Jesus for cross, dem tear en klot and dem for kon divide am. But dem leave di fine koat (bikos e nor get where dem join am, since dem weave-am from top go rish bottom).
23 Depois de os soldados crucificarem Jesus, tomaram as suas vestes e fizeram delas quatro partes, uma para cada soldado. A túnica, porém, toda tecida de alto a baixo, não tinha costura.
24 So di sojas tell each oda sey, “Make wi nor tear am, but make wi gambol to si who go take am.”
24 Disseram, pois, uns aos outros: Não a rasguemos, mas deitemos sorte sobre ela, para ver de quem será. Assim se cumpria a Escritura: Repartiram entre si as minhas vestes e deitaram sorte sobre a minha túnica {Sl 21,19}. Isso fizeram os soldados.
25 By dis time, di only pipol wey stand near di cross where dem nail Jesus, na-im mama; en aunty, Mary wey bi Klopas wife and Mary Magdalin.
25 Junto à cruz de Jesus estavam de pé sua mãe, a irmã de sua mãe, Maria, mulher de Cléofas, e Maria Madalena.
26 So wen Jesus si en mama and John, di disciple wey e love well-well stand for der, e kon tell en mama, “Mama, look, dis na yor pikin.”
26 Quando Jesus viu sua mãe e perto dela o discípulo que amava, disse à sua mãe: Mulher, eis aí teu filho.
27 Den e tell di disciple, “Make yu look, dis na yor mama.” From dat time, di disciple kon take Jesus mama go en own house.
27 Depois disse ao discípulo: Eis aí tua mãe. E dessa hora em diante o discípulo a levou para a sua casa.
28 Wen Jesus si sey evritin don finish, e kon sey, “Wota dey hongry mi”, (dis show sey wetin God tok, really happen).
28 Em seguida, sabendo Jesus que tudo estava consumado, para se cumprir plenamente a Escritura, disse: Tenho sede.
29 Di sojas soak sponge inside wine wey betta, wey dey one kontaina for der kon put am for di branches of one plant wey dem dey koll hyssop kon stresh am put for Jesus mout.
29 Havia ali um vaso cheio de vinagre. Os soldados encheram de vinagre uma esponja e, fixando-a numa vara de hissopo, chegaram-lhe à boca.
30 Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.
30 Havendo Jesus tomado do vinagre, disse: Tudo está consumado. Inclinou a cabeça e rendeu o espírito.
31 Dis tin happen for di day wen dem dey prepare for di Passova Feast and bikos dem nor wont make di dead body dem stay for cross for Sabat Day, (bikos dat Sabat Day na special one for dem), di Jew oga dem kon tell Pilate make dem break dia leg, to make sure sey dem don die, so dat dem go fit bring dia dead body kom down.
31 Os judeus temeram que os corpos ficassem na cruz durante o sábado, porque já era a Preparação e esse sábado era particularmente solene. Rogaram a Pilatos que se lhes quebrassem as pernas e fossem retirados.
32 So di sojas break di oda two pipol leg wey dem kill with Jesus.
32 Vieram os soldados e quebraram as pernas do primeiro e do outro, que com ele foram crucificados.
33 But wen dem rish di cross wey Jesus dey and si sey e don die, dem nor kon break en leg.
33 Chegando, porém, a Jesus, como o vissem já morto, não lhe quebraram as pernas,
34 But one soja kon take spear shuk di korna of en belle, den blood and wota kon dey rush kom out.
34 mas um dos soldados abriu-lhe o lado com uma lança e, imediatamente, saiu sangue e água.
35 All dis story na true, (bikos na di pesin wey si dem happen, naim tok about dem and wetin e tok na true), so dat una go fit bilive.
35 O que foi testemunha desse fato o atesta {e o seu testemunho é digno de fé, e ele sabe que diz a verdade}, a fim de que vós creiais.
36 All dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem nor go break one singol bone for en body.”
36 Assim se cumpriu a Escritura: Nenhum dos seus ossos será quebrado {Ex 12,46}.
37 And God word still sey, “Dem go stand dey sopraiz as dem dey look di pesin wey dem shuk en body.”
37 E diz em outra parte a Escritura: Olharão para aquele que transpassaram {Zc 12,10}.
38 Afta dis time, Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jesus sekret disciple, (bikos e dey fear di oda Jew oga dem), kon ask Pilate make e allow am karry Jesus dead body komot for der. Pilate gri for am and e go karry Jesus body komot.Dem dey karry Jesus go beri|alt="Jesus body is being carried to di tomb" src="GT00103.tif" size="col" loc="JHN 19:38-42" copy="Gordon" ref="19:38"
38 Depois disso, José de Arimatéia, que era discípulo de Jesus, mas ocultamente, por medo dos judeus, rogou a Pilatos a autorização para tirar o corpo de Jesus. Pilatos permitiu. Foi, pois, e tirou o corpo de Jesus.
39 Nikodimos, di man wey hide go si Jesus for nite, kon follow Josef. E karry perfume wey heavy rish seventy-five pounds, wey dem take myrrh and aloe spice make.
39 Acompanhou-o Nicodemos {aquele que anteriormente fora de noite ter com Jesus}, levando umas cem libras de uma mistura de mirra e aloés.
40 Den dem pour di perfume for Jesus body kon wrap am with linen klot akordin to di way Jew pipol dey prepare dead body for beri.
40 Tomaram o corpo de Jesus e envolveram-no em panos com os aromas, como os judeus costumam sepultar.
41 One gardin dey near di place where dem kill Jesus and one new grave wey dem neva beri anybody put before, dey inside di gardin.
41 No lugar em que ele foi crucificado havia um jardim, e no jardim um sepulcro novo, em que ninguém ainda fora depositado.
42 Since dat day na di day wey Jew pipol dey prepare for di Passova Feast and bikos di new grave dey near der, dem kon beri Jesus inside di grave.
42 Foi ali que depositaram Jesus por causa da Preparação dos judeus e da proximidade do túmulo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.