João 18

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Afta e don tok finish, Jesus and en disciples komot cross go Kidron Valley kon enter one big farm.
1 Depois dessas palavras, Jesus saiu com os seus discípulos para além da torrente de Cedron, onde havia um jardim, no qual entrou com os seus discípulos.
2 (Judas, wey sell Jesus, know di place, bikos Jesus don go der with en disciples many times).
2 Judas, o traidor, conhecia também aquele lugar, porque Jesus ia freqüentemente para lá com os seus discípulos.
3 So Judas kon escort many soja, some Temple polise and Farisee pipol enter di farm. Dem whole lamp, tosh and some whole swod and stik for hand.
3 Tomou então Judas a coorte e os guardas de serviço dos pontífices e dos fariseus, e chegaram ali com lanternas, tochas e armas.
4 Bikos Jesus know evritin wey go happen to am, e kon ask dem, “Who una dey find?”
4 Como Jesus soubesse tudo o que havia de lhe acontecer, adiantou-se e perguntou-lhes: A quem buscais?
5 Dem ansa am, “Na Jesus wey kom from Nazaret.”
5 Responderam: A Jesus de Nazaré. Sou eu, disse-lhes. {Também Judas, o traidor, estava com eles.}
6 So wen Jesus don tell dem sey, “Na mi bi di pesin”, dem dress go back kon fall for groun.
6 Quando lhes disse Sou eu, recuaram e caíram por terra.
7 Den Jesus ask dem again, “Who una sey una dey find?”
7 Perguntou-lhes ele, pela segunda vez: A quem buscais? Disseram: A Jesus de Nazaré.
8 Jesus kon sey, “I don tell una sey na mi bi di pesin. Since na mi una dey find, make una allow dis men go.”
8 Replicou Jesus: Já vos disse que sou eu. Se é, pois, a mim que buscais, deixai ir estes.
9 (E tok dis word make e bi sey wetin dem rite for God word na true, “I nor lost anybody among di sheep wey yu give mi.”)
9 Assim se cumpriu a palavra que disse: Dos que me deste não perdi nenhum {Jo 17,12}.
10 Den Simon Pita bring en swod out kon kut di High Priest savant rite ear komot. (Di savant name na Malkus).
10 Simão Pedro, que tinha uma espada, puxou dela e feriu o servo do sumo sacerdote, decepando-lhe a orelha direita. {O servo chamava-se Malco.}
11 Jesus kon tell Pita, “Make yu put yor swod back for where e dey before! Yu nor know sey I go drink from di sofa cup wey my Papa give mi?”
11 Mas Jesus disse a Pedro: Enfia a tua espada na bainha! Não hei de beber eu o cálice que o Pai me deu?
12 Den di sojas with dia oga and di Jew oga dem take Jesus kon tie am with rope.
12 Então a coorte, o tribuno e os guardas dos judeus prenderam Jesus e o ataram.
13 Dem take am go meet Annas, Kaiafas fada-in-law, wey bi di High Priest for dat year.
13 Conduziram-no primeiro a Anás, por ser sogro de Caifás, que era o sumo sacerdote daquele ano.
14 (Dis na di Kaiafas wey advise di Jew oga dem sey, “E good make one man die for evribody”).
14 Caifás fora quem dera aos judeus o conselho: Convém que um só homem morra em lugar do povo.
15 Simon Pita with anoda disciple kon follow dem as dem dey take Jesus go meet Annas. (Di oda disciples know di High Priest well-well, so e follow Jesus enter inside di High Priest kompond).
15 Simão Pedro seguia Jesus, e mais outro discípulo. Este discípulo era conhecido do sumo sacerdote e entrou com Jesus no pátio da casa do sumo sacerdote,
16 But Simon Pita stand outside di kompond near di door. Den di oda disciple wey know di High Priest kom out kon tok to di savant girl wey dey guide di gate and e kon allow Pita enter inside.
16 porém Pedro ficou de fora, à porta. Mas o outro discípulo {que era conhecido do sumo sacerdote} saiu e falou à porteira, e esta deixou Pedro entrar.
17 Di girl wey dey di gate kon ask Pita, “Yu nor bi one of dis man disciple?”
17 A porteira perguntou a Pedro: Não és acaso também tu dos discípulos desse homem? Não o sou, respondeu ele.
18 For dis time, all di savant and guards gada round shako fire wey dem make to warm demsef, bikos kold strong well-well. Pita follow dem stand der dey warm ensef too.
18 Os servos e os guardas acenderam um fogo, porque fazia frio, e se aqueciam. Com eles estava também Pedro, de pé, aquecendo-se.
19 As dem dey der, di High Priest bigin dey ask Jesus kweshon about en disciples and wetin e tish.
19 O sumo sacerdote indagou de Jesus acerca dos seus discípulos e da sua doutrina.
20 Jesus kon ansa am, “Na for publik I tok wetin I tish. Na inside sinagog and Temple where all di Jew pipol dey gada, na der I for dey tish. I nor tok anytin for sekret.
20 Jesus respondeu-lhe: Falei publicamente ao mundo. Ensinei na sinagoga e no templo, onde se reúnem os judeus, e nada falei às ocultas.
21 Why yu dey ask mi? Make yu ask di pipol wey hear mi. Dem know wetin I tok.”
21 Por que me perguntas? Pergunta àqueles que ouviram o que lhes disse. Estes sabem o que ensinei.
22 Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”
22 A estas palavras, um dos guardas presentes deu uma bofetada em Jesus, dizendo: É assim que respondes ao sumo sacerdote?
23 Den Jesus sey, “If wetin I tok nor korrect, make yu tell mi, but if e korrect, why yu slap mi?”
23 Replicou-lhe Jesus: Se falei mal, prova-o, mas se falei bem, por que me bates?
24 Den Annas kon send am as dem still tie am with rope, go meet Kaiafas, wey bi di High Priest.
24 {Anás enviou-o preso ao sumo sacerdote Caifás.}
25 As Simon Pita stand for inside di kompond dey warm ensef, dem kon ask am, “Yu too nor bi one of en disciple?”
25 Simão Pedro estava lá se aquecendo. Perguntaram-lhe: Não és porventura, também tu, dos seus discípulos? Negou-o, dizendo: Não!
26 One High Priest savant, wey bi di same family with di man wey Pita take swod kut en ear kon sey, “I nor si yu with am for inside di farm?”
26 Disse-lhe um dos servos do sumo sacerdote, parente daquele a quem Pedro cortara a orelha: Não te vi eu com ele no horto?
27 Pita deny again for dia front and fawol kon do “Kukuruku.”
27 Mas Pedro negou-o outra vez, e imediatamente o galo cantou.
28 Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food.
28 Da casa de Caifás conduziram Jesus ao pretório. Era de manhã cedo. Mas os judeus não entraram no pretório, para não se contaminarem e poderem comer a Páscoa.
29 So Pilate kom meet dem for outside kon ask dem, “Wetin una sey dis man do?”
29 Saiu, por isso, Pilatos para ter com eles, e perguntou: Que acusação trazeis contra este homem?
30 Dem ansa, “If to sey dis man nor bi criminal, wi nor for bring am kom meet yu.”
30 Responderam-lhe: Se este não fosse malfeitor, não o teríamos entregue a ti.
31 Den Pilate tell dem, “Make una go judge am as una law tok.”
31 Disse, então, Pilatos: Tomai-o e julgai-o vós mesmos segundo a vossa lei. Responderam-lhe os judeus: Não nos é permitido matar ninguém.
32 (Dis tin happen to show sey wetin Jesus tok about how e go die, na true).
32 Assim se cumpria a palavra com a qual Jesus indicou de que gênero de morte havia de morrer {Mt 20,19}.
33 So Pilate go inside en house for di palis, kon koll Jesus ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?”
33 Pilatos entrou no pretório, chamou Jesus e perguntou-lhe: És tu o rei dos judeus?
34 Jesus ansa am, “Na from yor mind yu ask dis kweshon, abi pipol don tell yu about mi?”
34 Jesus respondeu: Dizes isso por ti mesmo, ou foram outros que to disseram de mim?
35 Pilate kon sey, “Yu know sey I nor bi Jew, abi? Na yor pipol and priest oga dem bring yu kom meet mi. Wetin yu do sef?”
35 Disse Pilatos: Acaso sou eu judeu? A tua nação e os sumos sacerdotes entregaram-te a mim. Que fizeste?
36 Jesus ansa, “My kingdom nor dey dis world. If to sey my kingdom dey dis world, my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem. But as e bi so, my kingdom nor dey here.”
36 Respondeu Jesus: O meu Reino não é deste mundo. Se o meu Reino fosse deste mundo, os meus súditos certamente teriam pelejado para que eu não fosse entregue aos judeus. Mas o meu Reino não é deste mundo.
37 Den Pilate ask am, “So yu bi king?”
37 Perguntou-lhe então Pilatos: És, portanto, rei? Respondeu Jesus: Sim, eu sou rei. É para dar testemunho da verdade que nasci e vim ao mundo. Todo o que é da verdade ouve a minha voz.
38 Pilate still ask am, “Wetin bi di trut?” Den e go outside again go meet di Jew oga dem kon tell dem, “I nor si any bad tin wey dis man do o-o.
38 Disse-lhe Pilatos: Que é a verdade?... Falando isso, saiu de novo, foi ter com os judeus e disse-lhes: Não acho nele crime algum.
39 But as una custom sey make I free one prisona for una for Passova, una wont make I free Jesus, wey bi di Jew king?”
39 Mas é costume entre vós que pela Páscoa vos solte um preso. Quereis, pois, que vos solte o rei dos judeus?
40 Den, dem kon dey shaut, “Wi nor wont dat man, na Barabas wi wont and na criminal dis Barabas bi.”
40 Então todos gritaram novamente e disseram: Não! A este não! Mas a Barrabás! {Barrabás era um salteador.}

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.