João 17

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey,
1 Depois de dizer isso, Jesus olhou para o céu e orou: "Pai, chegou a hora. Glorifica o teu Filho, para que o teu Filho te glorifique.
2 Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.
2 Pois lhe deste autoridade sobre toda a humanidade, para que conceda a vida eterna a todos os que lhe deste.
3 Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’
3 Esta é a vida eterna: que te conheçam, o único Deus verdadeiro, e a Jesus Cristo, a quem enviaste.
4 I don give yu glory for dis world and I don finish di work wey yu send mi.
4 Eu te glorifiquei na terra, completando a obra que me deste para fazer.
5 And naw, Papa honor mi, make yu draw mi near yu, just as wi dey before di world start.
5 E agora, Pai, glorifica-me junto a ti, com a glória que eu tinha contigo antes que o mundo existisse.
6 I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name. Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word.
6 "Eu revelei teu nome àqueles que do mundo me deste. Eles eram teus; tu os deste a mim, e eles têm guardado a tua palavra.
7 Naw, dem don know sey evritin wey yu give mi kom from yu,
7 Agora eles sabem que tudo o que me deste vem de ti.
8 bikos I don tell dem di message wey yu give mi. Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi.
8 Pois eu lhes transmiti as palavras que me deste, e eles as aceitaram. Eles reconheceram de fato que vim de ti e creram que me enviaste.
9 I dey pray for di pipol wey yu give mi, bikos dem bi yor own, but I nor dey pray for di oda pipol wey dey inside di world.
9 Eu rogo por eles. Não estou rogando pelo mundo, mas por aqueles que me deste, pois são teus.
10 Evritin wey I get, na yor own and evritin wey yu get, na my own and dem don honor mi.
10 Tudo o que tenho é teu, e tudo o que tens é meu. E eu tenho sido glorificado por meio deles.
11 I nor go dey di world again, but dem go still dey inside di world, since I won kom meet yu. Holy Papa, make yor name protet di pipol wey yu give mi, so dat dem go bi one, just as mi and yu na one.
11 Não ficarei mais no mundo, mas eles ainda estão no mundo, e eu vou para ti. Pai santo, protege-os em teu nome, o nome que me deste, para que sejam um, assim como somos um.
12 Wen I dey with dem, I keep dem with yor name. No one lost, escept di one wey yor word sey e go perish.
12 Enquanto estava com eles, eu os protegi e os guardei pelo nome que me deste. Nenhum deles se perdeu, a não ser aquele que estava destinado à perdição, para que se cumprisse a Escritura.
13 Since I dey kom meet yu, I dey tok all dis tins for di world, so dat dia joy go full well-well.
13 "Agora vou para ti, mas digo estas coisas enquanto ainda estou no mundo, para que eles tenham a plenitude da minha alegria.
14 I don give dem yor word and bikos of dat, di pipol for world hate dem, since dem nor bilong to di world, as misef nor bilong to di world.
14 Dei-lhes a tua palavra, e o mundo os odiou, pois eles não são do mundo, como eu também não sou.
15 I nor sey make yu remove dem from di world, but make yu protet dem from di devil.
15 Não rogo que os tires do mundo, mas que os protejas do Maligno.
16 Dem nor bilong to di world, just as misef nor bilong to di world.
16 Eles não são do mundo, como eu também não sou.
17 Make yu protet dem with di trut, bikos na yor word bi di trut.
17 Santifica-os na verdade; a tua palavra é a verdade.
18 Just as yu send mi kom inside dis world, na so too I send dem go inside di world.
18 Assim como me enviaste ao mundo, eu os enviei ao mundo.
19 I don separate mysef from di world for dia sake, so dat dem go fit separate diasef from di world too.
19 Em favor deles eu me santifico, para que também eles sejam santificados pela verdade.
20 I nor dey pray for dem alone, but I also dey pray for oda pipol wey go bilive mi thru di word wey dem go tok about mi.
20 "Minha oração não é apenas por eles. Rogo também por aqueles que crerão em mim, por meio da mensagem deles,
21 Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.
21 para que todos sejam um, Pai, como tu estás em mim e eu em ti. Que eles também estejam em nós, para que o mundo creia que tu me enviaste.
22 I don give dem di honor wey yu give mi, so dat dem go bi one just as wi bi one:
22 Dei-lhes a glória que me deste, para que eles sejam um, assim como nós somos um:
23 I dey with dem and yu dey with mi, so dat dem go really bi one, just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem, as yu love mi.
23 eu neles e tu em mim. Que eles sejam levados à plena unidade, para que o mundo saiba que tu me enviaste, e os amaste como igualmente me amaste.
24 Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
24 "Pai, quero que os que me deste estejam comigo onde eu estou e vejam a minha glória, a glória que me deste porque me amaste antes da criação do mundo.
25 Holy Papa, even if di pipol for di world nor know yu, I know yu and dis ones know sey na yu send mi.
25 "Pai justo, embora o mundo não te conheça, eu te conheço, e estes sabem que me enviaste.
26 I don help dem know yor name and I go dey try to make oda pipol know am too, so dat di love wey yu get for mi, go dey with dem, as I dey with dem.”
26 Eu os fiz conhecer o teu nome, e continuarei a fazê-lo, a fim de que o amor que tens por mim esteja neles, e eu neles esteja".

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.