João 16

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 “I dey tell una all dis tins, so dat nobody go fit deceive una.
1 — Falo essas coisas para que vocês não se escandalizem.
2 Dem go drive una komot for di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una, go tink sey e dey do God work.
2 Eles expulsarão vocês das sinagogas, e até chegará a hora em que todo aquele que os matar pensará que, com isso, está prestando culto a Deus.
3 Dem go do all dis tins, bikos dem nor know mi and my Papa.
3 Isso farão porque não conhecem o Pai nem a mim.
4 But I tell una all dis tins, so dat wen di time rish, una go remember sey I tell una about dem before. I just dey tell una all dis tins, bikos I dey with una since.
4 Mas estou falando essas coisas para que, quando chegar a hora, vocês se lembrem de que eu já tinha dito isto para vocês.
5 “Naw, I dey go meet di Pesin wey send mi kom, but una dey ask mi, ‘Where yu dey go?’
5 Mas, agora, vou para junto daquele que me enviou, e nenhum de vocês me pergunta: “Para onde o senhor vai?”
6 But una nor happy as I dey tell una all dis tins.
6 Pelo contrário, porque eu lhes disse essas coisas, a tristeza encheu o coração de vocês.
7 I tell una true word, na for una own good naim make mi won go, bikos if I nor go, di Pesin wey go help una nor go kom, but if I go, I go send am kom meet una.
7 Mas eu lhes digo a verdade: é melhor para vocês que eu vá, porque, se eu não for, o Consolador não virá para vocês; mas, se eu for, eu o enviarei a vocês.
8 Wen e kom, e go show pipol for dis world wetin sin, God raitiousness and God judgement, bi.
8 Quando ele vier, convencerá o mundo do pecado, da justiça e do juízo:
9 Di Spirit go show dem sey dem dey wrong about sin, bikos dem nor bilive mi.
9 do pecado, porque eles não creem em mim;
10 Dem dey wrong about God raitiousness, bikos I dey go meet my Papa and dem nor go si mi again.
10 da justiça, porque vou para o Pai, e vocês não me verão mais;
11 And dem dey wrong about judgement, bikos God don kondemn di pesin wey dey rule dis world.
11 do juízo, porque o príncipe deste mundo já está julgado.
12 “I get plenty tins wey I won tell una, but una nor go fit bear dem naw.
12 — Tenho ainda muito para lhes dizer, mas vocês não o podem suportar agora.
13 But wen God Spirit kom, e go show una di trut. E nor go tok wetin dey en mind, but e go tok wetin e hear from God and wetin go happen afta I don go.
13 Porém, quando vier o Espírito da verdade, ele os guiará em toda a verdade. Ele não falará por si mesmo, mas dirá tudo o que ouvir e anunciará a vocês as coisas que estão para acontecer.
14 E go dey give mi glory wen e dey tell una di tins wey e dey hear from mi.
14 Ele me glorificará, porque vai receber do que é meu e anunciará isso a vocês.
15 Evritin wey my Papa get, na my own, naim make mi tok sey di Spirit go tell una wetin e dey hear from mi.
15 Tudo o que o Pai tem é meu. Por isso eu disse que o Espírito vai receber do que é meu e anunciar isso a vocês.
16 “Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi.”
16 — Um pouco, e vocês não me verão mais; outra vez um pouco, e me verão de novo.
17 Den some among di disciple kon dey ask each oda, “Wetin e mean wen e sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi bikos I dey go meet my Papa?’ ”
17 Então alguns dos seus discípulos disseram uns aos outros: — Que vem a ser isto que ele está nos dizendo: “Um pouco, e vocês não me verão mais, e outra vez um pouco, e me verão de novo”; e: “Vou para o Pai”?
18 Some still sey, “Wetin e get for mind wen e sey, ‘Time go soon kom?’ Wi nor undastand wetin e dey tok.”
18 E diziam: — Que vem a ser esse “um pouco”? Não compreendemos o que ele está dizendo.
19 Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem, naim e ask dem, “Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi?’
19 Jesus, percebendo que queriam lhe fazer perguntas, disse:
20 I tell una true word, una go kry and mourn, but di world go dey happy; una go dey sad well-well, but una sadnes go turn to happiness.
20 Em verdade, em verdade lhes digo que vocês vão chorar e se lamentar, mas o mundo se alegrará. Vocês ficarão tristes, mas a tristeza de vocês se transformará em alegria.
21 Wen woman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en time to born don rish, but wen e don born, e go happy and e nor go remember di pain again, bikos e go si sey e don born pikin.
21 A mulher, quando está para dar à luz, fica triste, porque chegou a sua hora; mas, depois de nascida a criança, já não se lembra da aflição, pela alegria de ter trazido alguém ao mundo.
22 Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.
22 Assim também agora vocês estão tristes. Mas eu os verei outra vez, e o coração de vocês ficará cheio de alegria, e ninguém poderá tirar essa alegria de vocês.
23 By dat time, una nor go ask mi anytin again. I tell una true word sey, anytin wey una ask my Papa with my name, E go give una.
23 — Naquele dia vocês não me perguntarão nada. Em verdade, em verdade lhes digo: se pedirem ao Pai alguma coisa em meu nome, ele lhes concederá.
24 Before naw, una neva take my name ask for anytin. Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am, so dat una joy go full well-well.
24 Até agora vocês não pediram nada em meu nome; peçam e receberão, para que a alegria de vocês seja completa.
25 “Since I dey use parabol tok to una; but di time dey kom wen I nor go use parabol again, but I go tell una about my Papa for di way wey una go undastand.
25 — Essas coisas eu falei a vocês por meio de figuras. Vem a hora em que não falarei mais por meio de figuras, mas falarei a vocês claramente a respeito do Pai.
26 By dat time, una go fit ask anytin with my name and God go do am for una.
26 Naquele dia vocês pedirão em meu nome. E não lhes digo que pedirei ao Pai em favor de vocês,
27 My Papa love una, bikos una love mi and bilive sey na-im send mi.
27 porque o próprio Pai os ama, visto que vocês me amam e creem que eu vim da parte de Deus.
28 Na my Papa send mi kom dis world, but naw, I dey go back go meet am.”
28 Vim do Pai e entrei no mundo, mas agora deixo o mundo e vou para o Pai.
29 En disciples kon sey, “Yu si, na naw yu dey tok for di way wey wi undastand and nor bi with parabol.
29 Então os seus discípulos disseram: — Agora o senhor fala claramente e não emprega nenhuma figura.
30 Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon. Bikos of dis, wi bilive sey na God send yu kom.”
30 Agora vemos que o senhor sabe todas as coisas e não precisa que alguém lhe pergunte. Por isso, cremos que o senhor veio de Deus.
31 Jesus kon tell dem, “So una don bilive naw?
31 Jesus respondeu:
32 Look, di time dey kom and e don even rish, wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone. But I nor dey alone, bikos my Papa dey with mi.
32 Eis que vem a hora — e já chegou — em que vocês serão dispersos, cada um para a sua casa, e vocês me deixarão sozinho. Mas não estou sozinho, porque o Pai está comigo.
33 “I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
33 Falei essas coisas para que em mim vocês tenham paz. No mundo, vocês passam por aflições; mas tenham coragem: eu venci o mundo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.