João 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 “Make una nor let anytin worry una mind. Since una bilive God, make una still bilive mi.
1 — Que o coração de vocês não fique angustiado; vocês creem em Deus, creiam também em mim.
2 Many rooms dey for my Papa house and I dey go prepare place for una to stay, if nor bi so, I for tell una.
2 Na casa de meu Pai há muitas moradas. Se não fosse assim, eu já lhes teria dito. Pois vou preparar um lugar para vocês.
3 Wen I don finish, I go kom take una, so dat una go stay with mi for where I dey.
3 E, quando eu for e preparar um lugar, voltarei e os receberei para mim mesmo, para que, onde eu estou, vocês estejam também.
4 And una go know di place wey I dey go and how una go take rish der.”
4 E vocês conhecem o caminho para onde eu vou.
5 Tomas ask am, “Oga God, wi nor know where yu dey go, how wi go take know road?”
5 Então Tomé disse a Jesus: — Não sabemos para onde o Senhor vai. Como podemos saber o caminho?
6 Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.
6 Jesus respondeu:
7 But since una don know mi, una go know my Papa too. Naw wey una don know am, una don si am.”
7 Se vocês me conheceram, conhecerão também o meu Pai. E desde agora vocês o conhecem e têm visto.
8 Filip kon sey, “Oga God, show us yor Papa and wi go dey okay.”
8 Filipe disse a Jesus: — Senhor, mostre-nos o Pai, e isso nos basta.
9 Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’
9 Jesus respondeu:
10 Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same? As E dey inside mi, na so I dey inside am. Di word wey I dey tell una so, I nor dey tok am with my own pawa, but na my Papa wey dey inside mi, dey do all dis mirakle thru mi.
10 Você não crê que eu estou no Pai e que o Pai está em mim? As palavras que eu digo a vocês não as digo por mim mesmo, mas o Pai, que permanece em mim, faz as suas obras.
11 Make una bilive sey I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi, but if una nor fit bilive mi, make una bilive bikos of di mirakles wey I dey do.
11 Creiam que eu estou no Pai e que o Pai está em mim; creiam ao menos por causa das mesmas obras.
12 I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
12 Em verdade, em verdade lhes digo que aquele que crê em mim fará também as obras que eu faço e outras maiores fará, porque eu vou para junto do Pai.
13 And anytin wey una use my name ask, I go do am, so dat pipol go honor di Papa bikos of en pikin.
13 E tudo o que vocês pedirem em meu nome, isso farei, a fim de que o Pai seja glorificado no Filho.
14 If una ask anytin with my name, I go do am for una.
14 Se me pedirem alguma coisa em meu nome, eu o farei.
15 “If una love mi, una go do wetin I tok.
15 — Se vocês me amam, guardarão os meus mandamentos.
16 Den I go ask my Papa and E go send una anoda Pesin wey go help and stay with una forever.
16 E eu pedirei ao Pai, e ele lhes dará outro Consolador, a fim de que esteja com vocês para sempre:
17 Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una.
17 é o Espírito da verdade, que o mundo não pode receber, porque não o vê, nem o conhece. Vocês o conhecem, porque ele habita com vocês e estará em vocês.
18 I nor go leave una like pikin wey nor get papa and mama, bikos I go kom meet una again.
18 — Não deixarei que fiquem órfãos; voltarei para junto de vocês.
19 Afta sometaim, di pipol for dis world nor go si mi, but una go si mi and bikos I dey alive, una go dey alive too.
19 Mais um pouco e o mundo não me verá mais; vocês, no entanto, me verão. Porque eu vivo, vocês também viverão.
20 Dat time, una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi, as I dey inside una.
20 Naquele dia vocês saberão que eu estou em meu Pai, que vocês estão em mim e que eu estou em vocês.
21 Anybody wey hear and do wetin I tok, love mi. Di pesin wey love mi, mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”
21 Aquele que tem os meus mandamentos e os guarda, esse é o que me ama; e aquele que me ama será amado por meu Pai, e eu também o amarei e me manifestarei a ele.
22 Judas (dis nor bi Judas Iskariot) kon sey, “Oga God, why yu won show yorsef give us and yu nor won show oda pipol for di world?”
22 Então Judas, não o Iscariotes, disse a Jesus: — Por que razão o Senhor se manifestará a nós e não ao mundo?
23 Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.
23 Jesus respondeu:
24 Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own.
24 Quem não me ama não guarda as minhas palavras. E a palavra que vocês estão ouvindo não é minha, mas do Pai, que me enviou.
25 “I don dey tell una all dis tins since I dey with una.
25 — Tenho dito isso enquanto ainda estou com vocês.
26 But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.
26 Mas o Consolador, o Espírito Santo, que o Pai enviará em meu nome, esse ensinará a vocês todas as coisas e fará com que se lembrem de tudo o que eu lhes disse.
27 Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.
27 Deixo com vocês a paz, a minha paz lhes dou; não lhes dou a paz como o mundo a dá. Que o coração de vocês não fique angustiado nem com medo.
28 “Una remember wen I tell una sey, ‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’ If una love mi, una go happy wen I tok sey, ‘I dey go meet my Papa’, bikos my Papa big pass mi.
28 Vocês ouviram que eu disse: “Vou e volto para junto de vocês.” Se vocês me amassem, ficariam alegres com a minha ida para o Pai, porque o Pai é maior do que eu.
29 I don tell una naw before e happen, so dat wen e happen, una go bilive mi.
29 Isso eu falei agora, antes que aconteça, para que, quando acontecer, vocês creiam.
30 I nor go tok too mush naw, bikos di devil wey dey rule dis world, dey kom and e nor get pawa for my body.
30 Já não falarei muito com vocês, porque aí vem o príncipe do mundo, e ele não tem poder sobre mim.
31 Since I dey do wetin my Papa tell mi, di world go know sey I love my Papa.
31 No entanto, faço isso para que o mundo saiba que eu amo o Pai e que faço como o Pai me ordenou.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.