João 13

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.
1 Faltava somente um dia para a Festa da Páscoa . Jesus sabia que tinha chegado a hora de deixar este mundo e ir para o Pai. Ele sempre havia amado os seus que estavam neste mundo e os amou até o fim.
2 Before dem start to chop evening food, devil don already enter Judas Iskariot mind, wey bi Simon pikin sey, make e sell Jesus give en enemy.
2 Jesus e os seus discípulos estavam jantando. O Diabo já havia posto na cabeça de Judas, filho de Simão Iscariotes, a ideia de trair Jesus.
3 Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am,
3 Jesus sabia que o Pai lhe tinha dado todo o poder. E sabia também que tinha vindo de Deus e ia para Deus.
4 e kon stand up for where dem dey chop, remove en big koat kon tie towel for en waist.
4 Então se levantou, tirou a sua capa , pegou uma toalha e amarrou na cintura.
5 E pour wota for basin, bigin dey wosh en disciples leg and dey dry dem with di towel wey dey en waist.
5 Em seguida pôs água numa bacia e começou a lavar os pés dos discípulos e a enxugá-los com a toalha.
6 Wen e rish Simon Pita turn, Pita kon tell am, “Oga God, yu won wosh my leg?”
6 Quando chegou perto de Simão Pedro, este lhe perguntou: — Vai lavar os meus pés, Senhor?
7 Jesus ansa, “Yu nor go fit undastand wetin I dey do naw, but yu go undastand am leta.”
7 Jesus respondeu:
8 Pita tell am, “I nor go gri make yu wosh my leg!”
8 — O senhor nunca lavará os meus pés! — disse Pedro.
9 So Simon Pita tell am, “Oga God, make yu nor wosh only my leg, but make yu wosh my hand and head too!”
9 — Então, Senhor, não lave somente os meus pés; lave também as minhas mãos e a minha cabeça! — pediu Simão Pedro.
10 Jesus ansa, “Di pesin wey don baf, only nid to wosh en leg, bikos e don dey klean. Una dey klean, but nor bi all of una.”
10 Aí Jesus disse:
11 (Bikos Jesus know di pesin wey go sell am, naim make am sey, “Nor bi all of una dey klean.”)
11 Jesus sabia quem era o traidor. Foi por isso que disse: “Todos menos um.”
12 So wen Jesus don wosh dia leg finish, e kon wear en big koat back. Den e go sidan for di tabol kon ask dem, “Una undastand wetin I do for una so?
12 Depois de lavar os pés dos seus discípulos, Jesus vestiu de novo a capa, sentou-se outra vez à mesa e perguntou:
13 Una dey koll mi ‘Tisha’ and ‘Oga God’, una korrect, bikos na so I bi.
13 Vocês me chamam de “Mestre” e de “Senhor” e têm razão, pois eu sou mesmo.
14 So, if mi wey bi una oga and tisha, wosh una leg, e good make una wosh each oda leg too.
14 Se eu, o Senhor e o Mestre, lavei os pés de vocês, então vocês devem lavar os pés uns dos outros.
15 I don give una ezample wey una go follow. So make una do for each oda as I don do for una.
15 Pois eu dei o exemplo para que vocês façam o que eu fiz.
16 Make I tell una true word, savant nor dey big pass en oga, just as di pesin wey bi messenja nor dey big pass di oga wey send am.
16 Eu afirmo a vocês que isto é verdade: o empregado não é mais importante do que o patrão, e o mensageiro não é mais importante do que aquele que o enviou.
17 Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.
17 Já que vocês conhecem esta verdade, serão felizes se a praticarem.
18 “Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’
18 — Não estou falando de vocês todos; eu conheço aqueles que escolhi. Pois tem de se cumprir o que as
19 “I don tell una before e go happen, so dat wen e happen, una go bilive sey na mi bi Christ.
19 Digo isso a vocês agora, antes que aconteça, para que, quando acontecer, vocês creiam que “
20 I dey tell una true word, anybody wey receive di pesin wey I send, don receive mi and anybody wey receive mi, don receive God wey send mi kom.”
20 Eu afirmo a vocês que isto é verdade: quem receber aquele que eu enviar estará também me recebendo; e quem me recebe recebe aquele que me enviou.
21 Wen e don tok dis tin finish, en heart kon heavy well-well, den e sey, “I dey tell una true word, one of una go sell mi give my enemy.”
21 Depois de dizer isso, Jesus ficou muito aflito e declarou abertamente aos discípulos:
22 Di disciples look each oda kon dey worry and tink for dia mind sey, “Wish pesin e dey tok about?”
22 Então eles olharam uns para os outros, sem saber de quem ele estava falando.
23 John, di disciple wey Jesus love well-well, sidan for en rite hand wen dem dey chop.
23 Ao lado de Jesus estava sentado um deles, a quem Jesus amava.
24 So, Simon Pita kon use eye tell am sey make e ask Jesus wish pesin e dey tok about.
24 Simão Pedro fez um sinal para ele e disse: — Pergunte de quem o Mestre está falando.
25 Den John bend en head near Jesus chest kon ask am, “Oga God, who yu dey tok about?”
25 Então aquele discípulo chegou mais perto de Jesus e perguntou: — Senhor, quem é ele?
26 Jesus ansa, “Na di pesin wey I go give dis bread afta I don shuk am inside di pot.” Den e shuk di bread inside di pot kon gi-am to Judas Iskariot, wey bi Simon pikin.
26 — É aquele a quem vou dar um pedaço de pão passado no molho! — respondeu Jesus. Em seguida pegou um pedaço de pão, passou no molho e deu a Judas, filho de Simão Iscariotes.
27 Afta Judas take di bread, devil enter en mind.
27 E assim que Judas recebeu o pão, Satanás entrou nele. Então Jesus disse a Judas:
28 (No one among dem wey sidan for di tabol undastand why Jesus tok to Judas like dat.
28 Nenhum dos que estavam à mesa entendeu por que Jesus disse isso.
29 Some of dem tink sey, since na Judas dey keep di money, Jesus tell am sey make e go buy wetin dem go use for di feast or make e give poor pipol money).
29 Como era Judas que tomava conta da bolsa do dinheiro, alguns pensaram que Jesus tinha mandado que ele comprasse alguma coisa para a festa ou desse alguma ajuda aos pobres.
30 Wen Judas don take di bread, e hurry komot for di place. (By dis time, day don dark.)
30 Judas recebeu o pão e saiu logo. E era noite.
31 Wen e don komot, Jesus kon sey, “Naw, di time don rish wen God go honor en pikin and en pikin go honor am too.
31 Quando Judas saiu, Jesus disse:
32 Wen di pikin don honor God, God go honor am too.
32 E, se por meio dele a natureza gloriosa de Deus for revelada, então Deus revelará em si mesmo a natureza divina do Filho do Homem. E Deus fará isso agora mesmo.
33 “My shidren, na small time remain wey I go dey with una. Leta, una go dey find mi and as I tell di Jew oga dem before sey, ‘Where I dey go una nor go fit kom der’, na di same word I dey tell una naw.
33 Meus filhos, não vou ficar com vocês por muito tempo. Vocês vão me procurar, mas eu digo agora o que já disse aos líderes judeus: vocês não podem ir para onde eu vou.
34 “I dey give una new kommand: Una must love each oda, as I love una,
34 Eu lhes dou este novo mandamento: amem uns aos outros. Assim como eu os amei, amem também uns aos outros.
35 so dat evribody go know sey, una bi my disciples if una love each oda.”
35 Se tiverem amor uns pelos outros, todos saberão que vocês são meus discípulos.
36 Simon Pita kon tell am, “Oga God, where yu dey go?”
36 Simão Pedro perguntou a Jesus: — Senhor, para onde é que o senhor vai? Jesus respondeu:
37 Pita ask am, “Oga God, why wi nor go fit follow yu naw? I ready to die bikos of yu!”
37 Pedro tornou a perguntar: — Senhor, por que eu não posso segui-lo agora? Eu estou pronto para morrer pelo senhor!
38 Jesus ansa am, “Yu really ready to die for mi? Make I tell yu true word, before fawol go do ‘Kukuruku’ dis nite, yu go tok three times sey, yu nor know mi.”
38 — Está mesmo? — perguntou Jesus. — Pois eu afirmo a você que isto é verdade: antes que o galo cante, você dirá três vezes que não me conhece.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.