João 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 “Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but klimb pass anoda side enter di place, na big tif.
1 Em verdade, em verdade vos digo: quem não entra pela porta no aprisco das ovelhas, mas sobe por outra parte, esse é ladrão e salteador.
2 Di pesin wey pass di door enter, na-im bi di shepad wey dey guide di sheep.
2 Mas o que entra pela porta é o pastor das ovelhas.
3 Di gateman go open di door for am and en sheep go hear en vois wen e koll dia name and e go lead dem kom out.
3 A este o porteiro abre; e as ovelhas ouvem a sua voz; e ele chama pelo nome as suas ovelhas, e as conduz para fora.
4 Wen e don bring all en sheep kom out, e go-go dia front and di sheep go follow am, bikos dem know en vois.
4 Depois de conduzir para fora todas as que lhe pertencem, vai adiante delas, e as ovelhas o seguem, porque conhecem a sua voz;
5 Dem nor go gri follow strenja, but dem go run from dem, bikos dem nor know di strenja vois.”
5 mas de modo algum seguirão o estranho, antes fugirão dele, porque não conhecem a voz dos estranhos.
6 Jesus tell dem dis parabol, but dem nor undastand wetin e tok.
6 Jesus propôs-lhes esta parábola, mas eles não entenderam o que era que lhes dizia.
7 So Jesus kon tell dem again, “I dey tell una true word. Na mi bi di door wey di sheep go must pass enter.
7 Tornou, pois, Jesus a dizer-lhes: Em verdade, em verdade vos digo: eu sou a porta das ovelhas.
8 All di pipol wey kom before mi, na big tif dem bi and di sheep nor go gri listin to dem.
8 Todos quantos vieram antes de mim são ladrões e salteadores; mas as ovelhas não os ouviram.
9 Na mi bi di door, anybody wey enter thru mi, God go save am. E go-go inside and out and e go si betta grass chop.
9 Eu sou a porta; se alguém entrar a casa; o filho fica entrará e sairá, e achará pastagens.
10 Di tin wey tif dey do, na to tif, kill and distroy pipol, but mi, I kom so dat pipol go get life, di kind life wey full well-well.
10 O ladrão não vem senão para roubar, matar e destruir; eu vim para que tenham vida e a tenham em abundância.
11 “Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die for di sheep.
11 Eu sou o bom pastor; o bom pastor dá a sua vida pelas ovelhas.
12 Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di sheep, kon kill di ones wey e katch.
12 Mas o que é mercenário, e não pastor, de quem não são as ovelhas, vendo vir o lobo, deixa as ovelhas e foge; e o lobo as arrebata e dispersa.
13 Bikos di pesin nor kare for di sheep, go run leave dem.
13 Ora, o mercenário foge porque é mercenário, e não se importa com as ovelhas.
14 “Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.
14 Eu sou o bom pastor; conheço as minhas ovelhas, e elas me conhecem,
15 Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep.
15 assim como o Pai me conhece e eu conheço o Pai; e dou a minha vida pelas ovelhas.
16 I get oda sheep wey nor dey here. I must gada dem too and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem.
16 Tenho ainda outras ovelhas que não são deste aprisco; a essas também me importa conduzir, e elas ouvirão a minha voz; e haverá um rebanho e um pastor.
17 Na dis bi di rizin wey make my Papa like mi, bikos I ready to sakrifice my life, so dat I go fit get di life back again.
17 Por isto o Pai me ama, porque dou a minha vida para a retomar.
18 Nobody go fit take my life from mi, but na mi go put am down by mysef and I get di pawa to take am back again. Dis na wetin God kommand mi to do.”
18 Ninguém ma tira de mim, mas eu de mim mesmo a dou; tenho autoridade para a dar, e tenho autoridade para retomá-la. Este mandamento recebi de meu Pai.
19 Anoda big kworel kon happen between di Jew pipol bikos of wetin Jesus tok.
19 Por causa dessas palavras, houve outra dissensão entre os judeus.
20 Many of dem kon dey sey, “Demon dey inside am and en head nor korrect. Why una dey listin to am sef?”
20 E muitos deles diziam: Tem demônio, e perdeu o juízo; por que o escutais?
21 Odas kon sey, “Di pesin wey get demon nor go fit tok like dis. No demon fit make blind pesin si.”
21 Diziam outros: Essas palavras não são de quem está endemoninhado; pode porventura um demônio abrir os olhos aos cegos?
22 Di time for di Dedikashon Feast for Jerusalem kon rish.
22 Celebrava-se então em Jerusalém a festa da dedicação. E era inverno.
23 Dat na di time wey rain dey fall (and kold dey strong well-well) and Jesus kon dey waka inside di varanda where Solomon for dey take breeze, wey dey inside di temple yard.
23 Andava Jesus passeando no templo, no pórtico de Salomão.
24 Di Jew oga dem gada round Jesus, kon ask am, “How long yu go make us dey wait? If na yu bi di Christ, make yu tell us.”
24 Rodearam-no, pois, os judeus e lhe perguntavam: Até quando nos deixarás perplexos? Se tu és o Cristo, dize-no-lo abertamente.
25 Jesus ansa dem, “I don tell una and una nor bilive. Di tin wey I take my Papa name dey do, dey bear witness for mi.
25 Respondeu-lhes Jesus: Já vo-lo disse, e não credes. As obras que eu faço em nome de meu Pai, essas dão testemunho de mim.
26 But una nor bilive mi bikos una nor bi my sheep.
26 Mas vós não credes, porque não sois das minhas ovelhas.
27 My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi.
27 As minhas ovelhas ouvem a minha voz, e eu as conheço, e elas me seguem;
28 I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die. Nobody go fit take dem komot from my hand.
28 eu lhes dou a vida eterna, e jamais perecerão; e ninguém as arrebatará da minha mão.
29 My Papa wey give dem to mi big pass evribody and nobody go fit take dem komot from my Papa hand,
29 Meu Pai, que mas deu, é maior do que todos; e ninguém pode arrebatá-las da mão de meu Pai.
30 bikos mi and my Papa, na one.”
30 Eu e o Pai somos um.
31 Di Jew oga dem kon pick stone again, won kon stone am.
31 Os judeus pegaram então outra vez em pedras para o apedrejar.
32 So Jesus tell dem, “I don do many good tins wey una si from my Papa, wish one make una won stone mi so?”
32 Disse-lhes Jesus: Muitas obras boas da parte de meu Pai vos tenho mostrado; por qual destas obras ides apedrejar-me?
33 Di Jew oga dem ansa, “Wi nor won stone yu bikos of di good tins, but na bikos yu wey bi ordinary pesin, dey make mout sey, yu bi God.”
33 Responderam-lhe os judeus: Não é por nenhuma obra boa que vamos apedrejar-te, mas por blasfêmia; e porque, sendo tu homem, te fazes Deus.
34 Jesus ask dem, “Una law nor tok sey, I sey, ‘Una bi gods?’
34 Tornou-lhes Jesus: Não está escrito na vossa lei: Eu disse: Vós sois deuses?
35 If dem koll di pipol wey God send en word go meet, sey, ‘Dem bi gods’ and God word nor go ever shange,
35 Se a lei chamou deuses àqueles a quem a palavra de Deus foi dirigida {e a Escritura não pode ser anulada},
36 Why una dey tell di pesin wey God choose for ensef and wey E send kom dis world sey, Yu dey tok against God, bikos I sey, ‘I bi God Pikin?’
36 àquele a quem o Pai santificou, e enviou ao mundo, dizeis vós: Blasfemas; porque eu disse: Sou Filho de Deus?
37 If I nor do di tins wey my Papa send mi, make una nor bilive mi.
37 Se não faço as obras de meu Pai, não me acrediteis.
38 But if I dey do dem, even if una nor bilive mi, make una bilive di tins wey I dey do, so dat una go know and undastand sey, I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi too.”
38 Mas se as faço, embora não me creiais a mim, crede nas obras; para que entendais e saibais que o Pai está em mim e eu no Pai.
39 So dem try again to katch am, but e kon waka leave dem.
39 Outra vez, pois, procuravam prendê-lo; mas ele lhes escapou das mãos.
40 Jesus go back kon cross Jordan River, where John for baptize pipol and e kon stay for der.
40 E retirou-se de novo para além do Jordão, para o lugar onde João batizava no princípio; e ali ficou.
41 Many pipol kom meet Jesus for di place. Dem bigin dey sey, “Even doh John nor do any mirakle, but evritin wey e tok about Jesus, na true.”
41 Muitos foram ter com ele, e diziam: João, na verdade, não fez sinal algum, mas tudo quanto disse deste homem era verdadeiro.
42 And many pipol for di place kon bilive Jesus.
42 E muitos ali creram nele.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.