Jonas 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 One day, God tell Jonah wey bi Amittai pikin
1 Certo dia, o Senhor Deus disse a Jonas, filho de Amitai:
2 sey, “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol about my judgement wey dey kom, bikos I don hear how di pipol for der wiked rish.”
2 — Apronte-se, vá à grande cidade de Nínive e grite contra ela, porque a maldade daquela gente chegou aos meus ouvidos.
3 But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God.
3 Jonas se aprontou, mas fugiu do Senhor , indo na direção contrária. Ele desceu a Jope e ali encontrou um navio que estava de saída para a Espanha. Pagou a passagem e embarcou a fim de viajar com os marinheiros para a Espanha, para longe do Senhor .
4 But God send strong breeze go kause wahala for di sea and bikos di breeze strong well-well, di ship won kon break to pieces.
4 No entanto, Deus mandou um forte vento, e houve uma tempestade no mar. Era tão violenta, que o navio estava em perigo de se partir ao meio.
5 Di sailors kon dey fear; evribody bigin kry kon dey pray to dia difren juju. Den dem kon dey trowey dia load for wota make di ship for lite. By dis time, Jonah dey inside-inside di ship dey sleep.
5 Os marinheiros ficaram com muito medo e gritavam por socorro, cada um ao seu deus. E, para que o navio ficasse mais leve, jogaram a carga no mar. Porém Jonas tinha descido ao porão e ali havia se deitado e caído num sono profundo.
6 Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.”
6 O capitão do navio o encontrou ali e disse: — Como é que você está aí dormindo? Levante-se e peça socorro ao seu deus. Pode ser que ele tenha pena de nós e não deixe a gente morrer.
7 So di sailors kon sey, “Make wi trow dice take know di pesin wey dey kause dis wahala for us.” So dem trow dice and e kon show sey na Jonah dey kause am.
7 Os marinheiros disseram uns aos outros: — Vamos tirar a sorte para descobrir quem é o culpado de estarmos neste perigo. Eles fizeram isso, e o nome de Jonas foi sorteado.
8 Dem kon sey, “Make yu tell us! Na who make dis tins dey happen to us so? Na wish kind work yu dey do? Where yu from kom? Wetin bi yor kountry name and wish tribe yu bi?”
8 Então lhe perguntaram: — Agora diga: quem é o culpado de tudo isso? O que você está fazendo aqui? De onde você vem? De que país você é, e qual é o seu povo?
9 Jonah ansa, “I bi Hibru pesin! I dey woship God; di Pesin wey make heaven, land and sea.”
9 — Eu sou hebreu — respondeu Jonas — e adoro o Senhor , o Deus do céu, que fez o mar e a terra.
10 Wen dem hear wetin e tok, fear kon katch dem well-well, so dem ask am, “Wish kind tin yu do so?” Di men tok like dis, bikos dem know sey e dey run from God, just as e bin tell dem.
10 Em seguida, Jonas contou que estava fugindo de Deus, o Senhor . Aí os marinheiros ficaram mais apavorados ainda e disseram: — Veja só o que você fez!
11 Bikos di breeze dey strong more-more, dem kon ask am, “Wetin wi go do yu naw make dis breeze for stop?”
11 A tempestade piorava cada vez mais, de modo que os marinheiros perguntaram a Jonas: — Que devemos fazer com você para que o mar se acalme?
12 Jonah ansa, “Make una trow mi inside di wota and di breeze go stop. Bikos na mi kause dis wahala for una.”
12 Jonas respondeu: — Vocês me peguem e joguem no mar, que ele ficará calmo. Pois eu sei que foi por minha culpa que esta terrível tempestade caiu sobre vocês.
13 Instead, dem kon try to padol di ship go land back, but dem know fit, bikos di breeze strong well-well.
13 Em vez de fazerem isso, os marinheiros começaram a remar com toda a força, tentando levar o navio para a praia; porém não conseguiam nada porque a tempestade piorava ainda mais.
14 So dem kry to God sey, “God wey get pawa, wi beg, make Yu know let us die, bikos of dis man! Make Yu know ponish us sey wi kill dis innocent man, bikos Yu wey bi Oga God, must do wetin Yu wont.”
14 Então oraram bem alto, assim: — Ó
15 So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop.
15 Em seguida, os marinheiros pegaram Jonas e o jogaram no mar, e logo o mar se acalmou.
16 Dis tin make di men fear God well-well, so dem offa sakrifice gi-am kon promise to serve am.
16 Eles ficaram com tanto medo do Senhor , que lhe ofereceram um sacrifício e lhe fizeram promessas.
17 So God send one big fish go swallow Jonah. Jonah dey di fish belle for three days and three nite.
17 O Senhor ordenou que um grande peixe engolisse Jonas. E ele ficou dentro do peixe três dias e três noites.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Jonas 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.