Isaías 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Wen King Ahaz wey bi Jotam pikin and Uzzaya grand-pikin dey rule for Judah, King Rezin for Siria and King Pekah wey bi Remalaya pikin for Israel, mash go Jerusalem go fight am, but dem nor fit win.
1 Nos dias em que Acaz, filho de Jotão, filho de Uzias, era rei de Judá, Rezim, rei da Síria, e Peca, filho de Remalias, rei de Israel, subiram a Jerusalém para lutar contra ela, mas não conseguiram conquistá-la.
2 So some pipol kon tell Judah king sey Siria sojas dey for Israel aria, den en and all en pipol kon dey fear, sotey dem bigin shake like tree wey breeze dey blow.
2 Quando informaram à casa de Davi que a Síria estava aliada com Efraim, o coração de Acaz e o coração do seu povo ficaram agitados, como se agitam as árvores do bosque com o vento.
3 So God tell Isaya, “Make yu take Shear-Jashub yor pikin go meet King Ahaz. Yu go si am for di side where wota for dey kom di pool, where pipol for dey wosh klot.
3 Então o Senhor disse a Isaías: — Vá, agora, com o seu filho Sear-Jasube encontrar-se com Acaz, que está na outra extremidade do aqueduto do tanque superior, junto ao caminho do campo do Lavandeiro.
4 Den tell am make e nor worry or fear and make e nor let anybody disturb am, bikos King Rezin, en pipol and Pekah vexnashon nor get pawa rish di smoke wey dey kom out from two firewood.
4 Diga-lhe o seguinte: “Tenha cuidado e fique calmo. Não tenha medo nem fique desanimado por causa desses dois tocos de lenha fumegante, por causa do furor da ira de Rezim e da Síria, e do filho de Remalias.
5 Siria with King Pekah and en pipol don plan against yu.
5 Porque a Síria, Efraim e o filho de Remalias resolveram acabar com você, dizendo:
6 Dem sey, ‘Make wi go attack and distroy Judah town, den wi go make Tabeel pikin, dia king.’
6 ‘Vamos atacar e amedrontar o reino de Judá. Vamos conquistá-lo para nós e fazer reinar no meio dele o filho de Tabeal.’”
7 But mi, God don tok sey,
7 Assim diz o Senhor Deus: “Isso não tem nenhuma chance de acontecer.
8 bikos na Damaskus bi Siria main town
8 Porque a capital da Síria é Damasco, e o cabeça de Damasco é Rezim. E dentro de sessenta e cinco anos Efraim será destruído e deixará de ser povo.
9 Na Samaria bi Israel main town
9 A capital de Efraim é Samaria, e o cabeça de Samaria é o filho de Remalias. Se vocês não crerem, certamente não permanecerão.”
10 God send anoda messenja go meet King Ahaz sey.
10 E o Senhor continuou a falar com Acaz, dizendo:
11 “Make yu ask God wey bi yor God make E show yu sign. Di one wey go make yu bilive sey God don tok. Yu fit even ask make E do mirakle for yu.”
11 — Peça ao Senhor , seu Deus, um sinal, quer seja embaixo, nas profundezas, ou em cima, nas alturas.
12 Den King Ahaz ansa, “I nor go ask for sign and I nor go fit tempt my God.”
12 Acaz, porém, disse: — Não pedirei, nem tentarei o
13 So Isaya sey, “Listin naw, una wey bi David shidren-shidren. Even doh e bad to dey try ordinary human being patient, una won try God own too?
13 Então Isaías disse: — Agora escute, ó casa de Davi! Será que não basta vocês abusarem da paciência dos homens? Querem abusar também da paciência do meu Deus?
14 So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’
14 Portanto, o Senhor mesmo lhes dará um sinal: eis que a virgem conceberá e dará à luz um filho e lhe chamará Emanuel.
15 Na milk and honey e go dey chop and dis food go help am know how to rijet evil and choose wetin dey good.
15 Ele comerá manteiga e mel quando souber desprezar o mal e escolher o bem.
16 Even before di pikin go know how to rijet evil and choose wetin dey good, doz two kings wey dey make una fear, God go don skata dem with dia pipol.
16 Na verdade, antes que este menino saiba desprezar o mal e escolher o bem, a terra daqueles dois reis que você tanto teme será abandonada.
17 Time dey kom wen God go bring trobol kon give yu, yor pipol and all di royal family and e go bad pass anytin wey don happen since Israel kingdom separate from Judah and from Assyria king.
17 — Mas o Senhor fará vir sobre você, sobre o seu povo e sobre a casa de seu pai dias tais como nunca houve, desde o dia em que Efraim se separou de Judá; ele fará vir o rei da Assíria.
18 “Wen dat time rish, God go blow wiso as sign for Egypt pipol and dem go kom like fly from evriwhere for Nile. Assyria pipol go kom from dia land like bees kon attack una too.
18 Naquele dia, o Senhor assobiará às moscas que estão no extremo dos rios do Egito e às abelhas que se encontram na terra da Assíria.
19 Dem go dey waka for di valley and for di holes wey dey di rock. Yes, dem go kover evry shuku-shuku, bush and grass for di land.
19 Elas virão e pousarão todas nos vales profundos, nas fendas das rochas, em todos os espinhos e em todas as pastagens.
20 Wen dat time rish, God go bring di pesin wey dey barber hair for Eufrates side, wey bi Assyria king and e go kut di hair wey dey una face, head and body komot.
20 — Naquele dia, o Senhor o rapará com uma navalha alugada do outro lado do rio, a saber, por meio do rei da Assíria. Rapará a sua cabeça e os cabelos dos seus pés e tirará também a sua barba.
21 Wen dat time rish, even if na only one melu and two goats di farmer fit save,
21 Naquele dia, um homem manterá apenas uma vaca nova e duas ovelhas,
22 dem go still produce enough milk for am. Yes! Di few pipol wey go survive go si plenty food chop.
22 e será tal a abundância de leite que elas lhe darão, que comerá manteiga. Todo o restante que ficar no meio da terra comerá manteiga e mel.
23 Wen dat time rish, di vineyard wey fine well-well and get one tazon vine wey rish one tazon pieces for silva, shuku-shuku go grow kover am.
23 — Também, naquele dia, todo lugar em que houver mil videiras, no valor de mil moedas de prata, será tomado por espinheiros e ervas daninhas.
24 Pipol go dey go use dia bow and arrows take katch animals for der. Yes, shuku-shuku go full evriwhere.
24 Com flechas e arco se entrará aí, porque os espinheiros e as ervas daninhas cobrirão toda a terra.
25 Na so too shuku-shuku go kover all di tins wey dem plant for di hill and nobody go fit go der again. E go bi where melu and sheep for dey go chop grass.”
25 Quanto a todos os montes, onde se costuma cavar com enxadas, para ali você não irá com medo dos espinhos e das ervas daninhas; eles servirão para pasto dos bois e para serem pisados pelas ovelhas.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Isaías 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.