Isaías 36

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 For di fourteent year wen Hezekaya bi king for Judah, King Sennakerib for Assyria kon attack and seize all Judah strong town.
1 No ano décimo quarto do rei Ezequias, subiu Senaqueribe, rei da Assíria, contra todas as cidades fortificadas de Judá e as tomou.
2 Den e kommand en offisa oga sey make e karry plenty sojas from Lakish go Jerusalem kon tell King Hezekaya sey make e surenda. So, di ofisas take-ova di road where di pipol for dey wosh and dry klot, near di Uppa Pool.
2 O rei da Assíria enviou Rabsaqué, de Laquis a Jerusalém, ao rei Ezequias, com grande exército; parou ele na extremidade do aqueduto do açude superior, junto ao caminho do campo do lavadeiro.
3 Den, Eliakim wey Hilkaya born, Shebna wey bi di kourt seketry and Joah wey bi Asaf pikin wey dey keep rekord, kom out kon go meet Assyria offisa wey di king send kom.
3 Então, saíram a encontrar-se com ele Eliaquim, filho de Hilquias, o mordomo, Sebna, o escrivão, e Joá, filho de Asafe, o cronista.
4 Di offisa tell Jerusalem pipol, “Make una tell Hezekaya sey,
4 Rabsaqué lhes disse: Dizei a Ezequias: Assim diz o sumo rei, o rei da Assíria: Que confiança é essa em que te estribas?
5 Yu tink sey ordinary word fit do wetin soja pawa fit do? Who una tink sey go help una fight Assyria pipol?
5 Bem posso dizer-te que teu conselho e poder para a guerra não passam de vãs palavras; em quem, pois, agora confias, para que te rebeles contra mim?
6 Una dey espect Egypt pipol to kom help una, but dat go bi like sey una won use soft stik take waka; but e go break kon wound una hand. Dat na how Egypt king bi to anybody wey put hope on am.” ’ ”
6 Confias no Egito, esse bordão de cana esmagada, o qual, se alguém nele apoiar-se, lhe entrará pela mão e a traspassará; assim é Faraó, rei do Egito, para com todos os que nele confiam.
7 Di Assyria ofisas still sey,
7 Mas, se me dizes: Confiamos no Senhor , nosso Deus, não é esse aquele cujos altos e altares Ezequias removeu e disse a Judá e a Jerusalém: Perante este altar adorareis?
8 I go make agriment with una bikos of di king. I go give una 2,000 horse, as long as una get who go ride dem.
8 Ora, pois, empenha-te com meu senhor, rei da Assíria, e dar-te-ei dois mil cavalos, se de tua parte achares cavaleiros para os montar.
9 Una sojas nor even dey di same rank with Assyria soja wey small pass, even if una bring Egypt shariot and sojas kom help una.
9 Como, pois, se não podes afugentar um só capitão dos menores dos servos do meu senhor, confias no Egito por causa dos carros e cavaleiros?
10 Na God kommand make mi kom here won distroy dis kountry so. Na God ensef tell mi sey, ‘Make yu go attack and distroy dis land.’ ”
10 Acaso, subi eu agora sem o Senhor contra esta terra, para a destruir? Pois o Senhor mesmo me disse: Sobe contra a terra e destrói-a.
11 Den Eliakim, Shebna and Joah tell di offisa, “Make yu speak Aramaik give us. Wi dey undastand am, make yu nor speak Hibru, bikos all di pipol wey dey di wall dey listin.”
11 Então, disseram Eliaquim, Sebna e Joá a Rabsaqué: Pedimos-te que fales em aramaico aos teus servos, porque o entendemos, e não nos fales em judaico, aos ouvidos do povo que está sobre os muros.
12 Di offisa kon ansa, “Una tink sey na only di king and una three, di king send mi kom tell all dis tins? No! I still dey tell di pipol wey sidan for di wall, wey go soon chop dia shit kon drink dia piss, just as unasef go do.”
12 Mas Rabsaqué lhes respondeu: Mandou-me, acaso, o meu senhor para dizer-te estas palavras a ti somente e a teu senhor? E não, antes, aos homens que estão assentados sobre os muros, para que comam convosco o seu próprio excremento e bebam a sua própria urina?
13 Den di ofisas stand up kon shaut for Hibru, “Make una listin to wetin Assyria king won tell una.
13 Então, Rabsaqué se pôs em pé, e clamou em alta voz em judaico, e disse: Ouvi as palavras do sumo rei, do rei da Assíria.
14 E dey warn una sey make una nor let Hezekaya deceive una, bikos Hezekaya nor go fit save una.
14 Assim diz o rei: Não vos engane Ezequias; porque não vos poderá livrar.
15 Make una nor let am force una trust God. Abi una tink sey God go save una, so dat Assyria sojas nor go kapture una town?
15 Nem tampouco Ezequias vos faça confiar no Senhor , dizendo: O Senhor certamente nos livrará, e esta cidade não será entregue nas mãos do rei da Assíria.
16 “Make una nor listin to Hezekaya! And naw, Assyria king dey kommand una sey, make una surenda. Dem go let all of una chop grapes from una own vine and figs from una own trees kon drink wota from una own well,
16 Não deis ouvidos a Ezequias; porque assim diz o rei da Assíria: Fazei as pazes comigo e vinde para mim; e comei, cada um da sua própria vide e da sua própria figueira, e bebei, cada um da água da sua própria cisterna;
17 till di king go put una for one kountry wey bi like una own; where vineyard dey wey go give una wine and flower to take make bread.
17 até que eu venha e vos leve para uma terra como a vossa; terra de cereal e de vinho, terra de pão e de vinhas.
18 “Make una nor let Hezekaya deceive una sey God go save una. E get any god wey fit save en pipol from Assyria king?
18 Não vos engane Ezequias, dizendo: O Senhor nos livrará. Acaso, os deuses das nações livraram cada um a sua terra das mãos do rei da Assíria?
19 Where Hamat and Arpad gods dey naw? Where Sefarvaim gods dey sef? E get anybody wey save Samaria?
19 Onde estão os deuses de Hamate e de Arpade? Onde estão os deuses de Sefarvaim? Acaso, livraram eles a Samaria das minhas mãos?
20 Wish time any kountry god don fit save en pipol from awa king? So, wetin make una tink sey una God go fit save Jerusalem?”
20 Quais são, dentre todos os deuses destes países, os que livraram a sua terra das minhas mãos, para que o Senhor livre a Jerusalém das minhas mãos?
21 Di pipol no tok at-all, bikos King Hezekaya don tell dem make dem kwayet.
21 Eles, porém, se calaram e não lhe responderam palavra; porque assim lhes havia ordenado o rei, dizendo: Não lhe respondereis.
22 Den Eliakim, Shebna and Joah vex tear dia klot kon go tell di king wetin Assyria offisa tok.
22 Então, Eliaquim, filho de Hilquias, o mordomo, e Sebna, o escrivão, e Joá, filho de Asafe, o cronista, rasgaram suas vestes, vieram ter com Ezequias e lhe referiram as palavras de Rabsaqué.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Isaías 36, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.