Hebreus 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Di first kovenant show how pipol go woship God for dis world.
1 Ora, também a primeira tinha ordenanças de culto divino, e um santuário terrestre.
2 Di building get two rooms. Di first one where lantan-stand dey, “Na di Holy Place.” One tabol and di bread wey dem offa give God, dey der too.
2 Porque um tabernáculo estava preparado, o primeiro, em que havia o candeeiro, e a mesa, e os pães da proposição; ao que se chama o santuário.
3 Anoda room wey dem rite, “Holy of Holies”, dey for di curtain back.
3 Mas depois do segundo véu estava o tabernáculo que se chama o santo dos santos,
4 Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.
4 Que tinha o incensário de ouro, e a arca da aliança, coberta de ouro toda em redor; em que estava um vaso de ouro, que continha o maná, e a vara de Arão, que tinha florescido, e as tábuas da aliança;
5 God angels wey kover di place where God dey show mesi and forgive sins, dey on-top dis box. But dis nor bi di time for mi to esplain all dis tins give una.
5 E sobre a arca os querubins da glória, que faziam sombra no propiciatório; das quais coisas não falaremos agora particularmente.
6 Wen all dis tins don ready, di priests dey enter di first room evriday go do dia work.
6 Ora, estando estas coisas assim preparadas, a todo o tempo entravam os sacerdotes no primeiro tabernáculo, cumprindo os serviços;
7 But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.
7 Mas, no segundo, só o sumo sacerdote, uma vez no ano, não sem sangue, que oferecia por si mesmo e pelas culpas do povo;
8 Di Holy Spirit kon esplain sey, “Di way to rish di Holy Place neva open as long as di old tent still dey.”
8 Dando nisto a entender o Espírito Santo que ainda o caminho do santuário não estava descoberto enquanto se conservava em pé o primeiro tabernáculo,
9 Dis na sign make wi for fit undastand sey: Di gifts and sakrifice wey di priests dey offa for God pipol, nor fit make dia mind klean.
9 Que é uma alegoria para o tempo presente, em que se oferecem dons e sacrifícios que, quanto à consciência, não podem aperfeiçoar aquele que faz o serviço;
10 To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.
10 Consistindo somente em comidas, e bebidas, e várias abluções e justificações da carne, impostas até ao tempo da correção.
11 So Christ don bi High Priest for di good tins wey don kom. E don enter di Holy Place for heaven wey dey pafet. Nor bi human being make di place and e nor dey among tins wey God kreate for dis world.
11 Mas, vindo Cristo, o sumo sacerdote dos bens futuros, por um maior e mais perfeito tabernáculo, não feito por mãos, isto é, não desta criação,
12 Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever.
12 Nem por sangue de bodes e bezerros, mas por seu próprio sangue, entrou uma vez no santuário, havendo efetuado uma eterna redenção.
13 If goat or ram blood and ashes fit klean pesin akordin to di old tradishon,
13 Porque, se o sangue dos touros e bodes, e a cinza de uma novilha esparzida sobre os imundos, os santifica, quanto à purificação da carne,
14 wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.
14 Quanto mais o sangue de Cristo, que pelo Espírito eterno se ofereceu a si mesmo imaculado a Deus, purificará as vossas consciências das obras mortas, para servirdes ao Deus vivo?
15 Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.
15 E por isso é Mediador de um novo testamento, para que, intervindo a morte para remissão das transgressões que havia debaixo do primeiro testamento, os chamados recebam a promessa da herança eterna.
16 Dis kind agriment bi like pesin will. Di pesin must die first, before dem go fit use di will.
16 Porque onde há testamento, é necessário que intervenha a morte do testador.
17 Bikos pesin will nor dey mean anytin wen e still dey alive; e only dey yuzful wen di pesin don die.
17 Porque um testamento tem força onde houve morte; ou terá ele algum valor enquanto o testador vive?
18 Na dis make di first kovenant nor get pawa to save pipol, unless dem sakrifice blood.
18 Por isso também o primeiro não foi consagrado sem sangue;
19 Wen Moses read all di kommand give Israel pipol, e take goat and ram blood with wota and soap, kon sprinkol di blood on-top di Law Book and all di pipol body, den e sey,
19 Porque, havendo Moisés anunciado a todo o povo todos os mandamentos segundo a lei, tomou o sangue dos bezerros e dos bodes, com água, lã purpúrea e hissopo, e aspergiu tanto o mesmo livro como todo o povo,
20 “Na dis bi di blood for di kovenant wey God kommand sey una must obey.”
20 Dizendo: Este é o sangue do testamento que Deus vos tem mandado.
21 Moses still sprinkol di blood for di tent and all di plate wey dem dey use take woship God.
21 E semelhantemente aspergiu com sangue o tabernáculo e todos os vasos do ministério.
22 True-true, akordin to di law, na almost evritin blood dey make klean and if dem neva pour blood, God nor go forgive dem dia sins.
22 E quase todas as coisas, segundo a lei, se purificam com sangue; e sem derramamento de sangue não há remissão.
23 Na dis make dem dey klean di Holy Place for dis eart with animal blood, bikos e bi like di one for heaven. But di tins wey dey for heaven, nid sakrifice wey betta pass dat one.
23 De sorte que era bem necessário que as figuras das coisas que estão no céu assim se purificassem; mas as próprias coisas celestiais com sacrifícios melhores do que estes.
24 Christ nor enter di Holy Place wey human being build like di original building for heaven, but na heaven e enter and naw, e stand for God present for awa sake.
24 Porque Cristo não entrou num santuário feito por mãos, figura do verdadeiro, porém no mesmo céu, para agora comparecer por nós perante a face de Deus;
25 Christ nor nid to offa ensef evry year like di High Priests dey do for di temple with animal blood,
25 Nem também para a si mesmo se oferecer muitas vezes, como o sumo sacerdote cada ano entra no santuário com sangue alheio;
26 bikos if na so, Christ for dey kom die for us evry year since di time wey God kreate di world. But nor bi so! E die wons and for all, so dat awa sins go-go forever.
26 De outra maneira, necessário lhe fora padecer muitas vezes desde a fundação do mundo. Mas agora na consumação dos séculos uma vez se manifestou, para aniquilar o pecado pelo sacrifício de si mesmo.
27 Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom,
27 E, como aos homens está ordenado morrerem uma vez, vindo depois disso o juízo,
28 na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.
28 Assim também Cristo, oferecendo-se uma vez para tirar os pecados de muitos, aparecerá segunda vez, sem pecado, aos que o esperam para salvação.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Hebreus 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.