Hebreus 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Melkizedek wey bi “Salem king” and “God priest”, na-im bless Abraham, afta Abraham don win di kings for war.
1 Porque este Melquisedeque, rei de Salém, sacerdote do Deus Altíssimo, que saiu ao encontro de Abraão, quando voltava da matança dos reis, e o abençoou,
2 So Abraham kon gi-am one from evry ten tin wey e bring kom back from war. Melkizedek mean, “King wey dey do wetin dey rite” and Salem mean, “Peace.”
2 para o qual também Abraão separou o dízimo de tudo (primeiramente se interpreta rei de justiça, depois também é rei de Salém, ou seja, rei de paz;
3 E nor get papa or mama, e nor get story at-all, en days nor get where e for start or where e go end, but e bi like Man Pikin and e bi priest forever.
3 sem pai, sem mãe, sem genealogia; que não teve princípio de dias, nem fim de existência, entretanto, feito semelhante ao Filho de Deus), permanece sacerdote perpetuamente.
4 But si how e big rish, bikos Abraham (awa grand-grand papa wey evribody know) gi-am one out of evry ten tins wey e bring from war.
4 Considerai, pois, como era grande esse a quem Abraão, o patriarca, pagou o dízimo tirado dos melhores despojos.
5 Levi shidren wey bi priests, get pawa akordin to di law, to kollect one out of evry ten tins from dia own pipol, even doh di pipol demsef, na Abraham shidren too.
5 Ora, os que dentre os filhos de Levi recebem o sacerdócio têm mandamento de recolher, de acordo com a lei, os dízimos do povo, ou seja, dos seus irmãos, embora tenham estes descendido de Abraão;
6 But Melkizedek wey nor even rilate to Levi pipol, still kollect one out of evry ten tins from Abraham, den e kon bless Abraham wey God don promise.
6 entretanto, aquele cuja genealogia não se inclui entre eles recebeu dízimos de Abraão e abençoou o que tinha as promessas.
7 True-true, wi know sey pesin wey bless pesin, na-im big pass di pesin wey e bless.
7 Evidentemente, é fora de qualquer dúvida que o inferior é abençoado pelo superior.
8 Evry priests dey kollect one out of evry ten tins wey pipol bring, but dem nor dey stay for di world forever, esept Melkizedek, bikos God word tish us sey, e dey alive.
8 Aliás, aqui são homens mortais os que recebem dízimos, porém ali, aquele de quem se testifica que vive.
9 Levi shidren dey kollect one out of evry ten tins from pipol, but naw, wi go fit sey, wen Abraham give one out of evry ten to Melkizedek, Levi pay too,
9 E, por assim dizer, também Levi, que recebe dízimos, pagou-os na pessoa de Abraão.
10 bikos dat time wen Abraham give one out of evry ten tins wey e bring from war to Melkizedek, dem neva born Levi, but Levi dey inside am.
10 Porque aquele ainda não tinha sido gerado por seu pai, quando Melquisedeque saiu ao encontro deste.
11 Even doh Moses Law sey priest must kom from Levi family, dat kind priest nor fit make pesin dey pafet. So anoda priest like Melkizedek must kom and e nor bi like priest wey kom from Aaron family.
11 Se, portanto, a perfeição houvera sido mediante o sacerdócio levítico (pois nele baseado o povo recebeu a lei), que necessidade haveria ainda de que se levantasse outro sacerdote, segundo a ordem de Melquisedeque, e que não fosse contado segundo a ordem de Arão?
12 Since dem don shange di rule to selet priest, di law must shange too.
12 Pois, quando se muda o sacerdócio, necessariamente há também mudança de lei.
13 Di pesin wey wi dey tok about, na awa Oga God wey kom from di tribe where nobody don ever serve as priest for altar before.
13 Porque aquele de quem são ditas estas coisas pertence a outra tribo, da qual ninguém prestou serviço ao altar;
14 Evribody know sey na from Judah tribe, Jesus from kom and Moses Law nor sey make priest kom from dat tribe.
14 pois é evidente que nosso Senhor procedeu de Judá, tribo à qual Moisés nunca atribuiu sacerdotes.
15 Dis matter klear well-well afta God selet anoda priest like Melkizedek.
15 E isto é ainda muito mais evidente, quando, à semelhança de Melquisedeque, se levanta outro sacerdote,
16 E nor selet dat pesin bikos of en grand-grand papa dem, but na bikos en life nor go ever end.
16 constituído não conforme a lei de mandamento carnal, mas segundo o poder de vida indissolúvel.
17 God word sey: “Yu bi priest forever, just as Melkizedek bi.”
17 Porquanto se testifica: Tu és sacerdote para sempre, segundo a ordem de Melquisedeque.
18 Bikos of dis, God put di old law for korna, since e dey weak and yuzles,
18 Portanto, por um lado, se revoga a anterior ordenança, por causa de sua fraqueza e inutilidade
19 bikos di law nor fit make anytin dey pafet. But naw, wi get betta hope wey go draw us near God.
19 (pois a lei nunca aperfeiçoou coisa alguma), e, por outro lado, se introduz esperança superior, pela qual nos chegamos a Deus.
20 God ensef make promise wen E choose dis priest, wey bi Jesus. E nor make dis kind promise wen E choose di oda priests,
20 E, visto que não é sem prestar juramento (porque aqueles, sem juramento, são feitos sacerdotes,
21 but Jesus kon bi priest wen God sey, “I don swear and I nor go shange my mind sey yu go bi priest forever.”
21 mas este, com juramento, por aquele que lhe disse: O Senhor jurou e não se arrependerá: Tu és sacerdote para sempre );
22 Bikos God swear like dis, Jesus don make us dey sure of di new kovenant wey betta pass.
22 por isso mesmo, Jesus se tem tornado fiador de superior aliança.
23 Many priests don dey before and all of dem die,
23 Ora, aqueles são feitos sacerdotes em maior número, porque são impedidos pela morte de continuar;
24 but Jesus nor go ever die. So, e go bi priest forever.
24 este, no entanto, porque continua para sempre, tem o seu sacerdócio imutável.
25 So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem.
25 Por isso, também pode salvar totalmente os que por ele se chegam a Deus, vivendo sempre para interceder por eles.
26 Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven
26 Com efeito, nos convinha um sumo sacerdote como este, santo, inculpável, sem mácula, separado dos pecadores e feito mais alto do que os céus,
27 and e betta pass any oda high priests. Jesus nor nid to offa sakrifice evriday, like di oda priests wey dey offa for dia own sins and for di pipol own. Bikos na wons and for all e sakrifice ensef for evribody, wen e die for di cross.
27 que não tem necessidade, como os sumos sacerdotes, de oferecer todos os dias sacrifícios, primeiro, por seus próprios pecados, depois, pelos do povo; porque fez isto uma vez por todas, quando a si mesmo se ofereceu.
28 Moses Law choose human being wey get weakness as High Priest, but God promise wey kom afta di law, choose di pikin and na-im bi di korrect Priest forever.
28 Porque a lei constitui sumos sacerdotes a homens sujeitos à fraqueza, mas a palavra do juramento, que foi posterior à lei, constitui o Filho, perfeito para sempre.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Hebreus 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.