Hebreus 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 E don rish wen wi go stop to learn only di first tins wey Christ tell us, so make wi dey grow kon know Christ more-more. Wi nor nid to still dey tish una about tins wey dey kause deat; why wi must bilive God;
1 Pelo que deixando os rudimentos da doutrina de Cristo, prossigamos até a perfeição, não lançando de novo o fundamento de arrependimento de obras mortas e de fé em Deus,
2 wetin baptizim mean; to put hand for pipol head; to wake pipol from deat and about God final judgement.
2 e o ensino sobre batismos e imposição de mãos, e sobre ressurreição de mortos e juízo eterno.
3 As God dey help us, na new-new tins wi go dey tish una about di faith.
3 E isso faremos, se Deus o permitir.
4 Wen pesin don first know di trut; taste God gift from heaven; know di Holy Spirit;
4 Porque é impossível que os que uma vez foram iluminados, e provaram o dom celestial, e se fizeram participantes do Espírito Santo,
5 don taste God good work and di betta wey dey kom,
5 e provaram a boa palavra de Deus, e os poderes do mundo vindouro,
6 den e kon start to sin, dat pesin nor go fit turn from sin kom meet God, since e don kill God Pikin for di sekond time and disgrace am for publik.
6 e depois caíram, sejam outra vez renovados para arrependimento; visto que, quanto a eles, estão crucificando de novo o Filho de Deus, e o expondo ao vitupério.
7 Wen rain don soak groun and e bear betta fruits for di farmer, dat mean sey God don bless di man.
7 Pois a terra que embebe a chuva, que cai muitas vezes sobre ela, e produz erva proveitosa para aqueles por quem é lavrada, recebe a bênção da parte de Deus;
8 But if na so-so shuku-shuku and grass di groun dey bear, dat mean sey e dey yuzles. So God go curse and distroy am with fire.
8 mas se produz espinhos e abrolhos, é rejeitada, e perto está da maldição; o seu fim é ser queimada.
9 But as for una wey bi my friends, even doh wi dey tok to una like dis, wi know sey dis tins nor go happen to una, bikos una don undastand God salvashon.
9 Mas de vós, ó amados, esperamos coisas melhores, e que acompanham a salvação, ainda que assim falamos.
10 God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.
10 Porque Deus não é injusto, para se esquecer da vossa obra, e do amor que para com o seu nome mostrastes, porquanto servistes aos santos, e ainda os servis.
11 As una still dey dis world, wi wont make una kontinue to love one anoda, so dat wetin una dey hope for, go kom.
11 E desejamos que cada um de vós mostre o mesmo zelo até o fim, para completa certeza da esperança;
12 So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.
12 para que não vos torneis indolentes, mas sejais imitadores dos que pela fé e paciência herdam as promessas.
13 Nobody big pass God, bikos God swear with en name wen E promise Abraham sey,
13 Porque, quando Deus fez a promessa a Abraão, visto que não tinha outro maior por quem jurar, jurou por si mesmo,
14 “Na mi bi Oga God, I go bless yu well-well and yor shidren go plenty.”
14 dizendo: Certamente te abençoarei, e grandemente te multiplicarei.
15 Bikos Abraham get patient, God kon gi-am wetin E promise am.
15 E assim, tendo Abraão esperado com paciência, alcançou a promessa.
16 Wen pipol won setol matter, dem dey swear with pesin wey big pass dem and di agriment wey dem make, dey end di matter.
16 Pois os homens juram por quem é maior do que eles, e o juramento para confirmação é, para eles, o fim de toda contenda.
17 So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.
17 assim que, querendo Deus mostrar mais abundantemente aos herdeiros da promessa a imutabilidade do seu conselho, se interpôs com juramento;
18 God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.
18 para que por duas coisas imutáveis, nas quais é impossível que Deus minta, tenhamos poderosa consolação, nós, os que nos refugiamos em lançar mão da esperança proposta;
19 Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey;
19 a qual temos como âncora da alma, segura e firme, e que penetra até o interior do véu;
20 di place where Jesus don enter for us and don bikom High Priest forever, just as Melkizedek bi.
20 aonde Jesus, como precursor, entrou por nós, feito sacerdote para sempre, segundo a ordem de Melquisedeque.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Hebreus 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.