Hebreus 13

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Make una dey love each oda like Christian brodas and sistas.
1 Permaneça o amor fraternal.
2 Make una always dey welkom strenja for una house, bikos like dis, some pipol don welkom angel enter dia house and dem nor know.
2 Não vos esqueçais da hospitalidade, porque por ela alguns, sem o saberem, hospedaram anjos.
3 Make una remember doz wey dey prison, like sey unasef dey der with dem and make una remember doz wey dey sofa, like sey una dey sofa like dem.
3 Lembrai-vos dos presos, como se estivésseis presos com eles, e dos maltratados, como sendo-o vós mesmos também no corpo.
4 Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.
4 Honrado seja entre todos o matrimônio e o leito sem mácula; pois aos devassos e adúlteros, Deus os julgará.
5 Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”
5 Seja a vossa vida isenta de ganância, contentando-vos com o que tendes; porque ele mesmo disse: Não te deixarei, nem te desampararei.
6 So make wi get mind wey go make us fit sey, “Na God bi my helpa, so wi nor go fear. Wetin human being go fit do us?”
6 De modo que com plena confiança digamos: O Senhor é quem me ajuda, não temerei; que me fará o homem?
7 Make una remember una leaders wey tish una God word; make una tink about di kind life wey dem dey live, den make una follow dia faith.
7 Lembrai-vos dos vossos guias, os quais vos falaram a palavra de Deus, e, atentando para o êxito da sua carreira, imitai-lhes a fé.
8 Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange!
8 Jesus Cristo é o mesmo, ontem, e hoje, e eternamente.
9 Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.
9 Não vos deixeis levar por doutrinas várias e estranhas; porque bom é que o coração se fortifique com a graça, e não com alimentos, que não trouxeram proveito algum aos que com eles se preocuparam.
10 Wi get altar where di workers for di Tabanako nor fit chop from.
10 Temos um altar, do qual não têm direito de comer os que servem ao tabernáculo.
11 Di High Priest dey karry animal blood enter di Holy Place as ofrin for sins, but di animal body, na outside di kamp dem for dey burn am.
11 Porque os corpos dos animais, cujo sangue é trazido para dentro do santo lugar pelo sumo sacerdote como oferta pelo pecado, são queimados fora do arraial.
12 Derfor, Jesus take en own blood make sakrifice, so dat en pipol go dey holy. So Jesus Christ sofa outside di kamp too.
12 Por isso também Jesus, para santificar o povo pelo seu próprio sangue, sofreu fora da porta.
13 Wi must go meet am for outside di kamp kon share di shame with am.
13 Saiamos pois a ele fora do arraial, levando o seu opróbrio.
14 Bikos for here, wi nor get any town wey go last, but wi dey wait di town wey go kom.
14 Porque não temos aqui cidade permanente, mas buscamos a vindoura.
15 True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”
15 Por ele, pois, ofereçamos sempre a Deus sacrifício de louvor, isto é, o fruto dos lábios que confessam o seu nome.
16 Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.
16 Mas não vos esqueçais de fazer o bem e de repartir com outros, porque com tais sacrifícios Deus se agrada.
17 Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.
17 Obedecei a vossos guias, sendo-lhes submissos; porque velam por vossas almas como quem há de prestar contas delas; para que o façam com alegria e não gemendo, porque isso não vos seria útil.
18 Make una pray for us, bikos wi dey sure sey awa mind klean and wi won live awa life for di korrect way.
18 Orai por nós, porque estamos persuadidos de que temos boa consciência, sendo desejosos de, em tudo, portar-nos corretamente.
19 Abeg, make una pray well-well, so dat dem go free mi and I go fit kom meet una soon.
19 E com instância vos exorto a que o façais, para que eu mais depressa vos seja restituído.
20 God wey get peace, di Pesin wey use di everlastin kovenant blood bring awa Oga God Jesus Christ kom back from deat; awa Oga God wey dey look di sheep,
20 Ora, o Deus de paz, que pelo sangue do pacto eterno tornou a trazer dentre os mortos a nosso Senhor Jesus, grande pastor das ovelhas,
21 make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!
21 vos aperfeiçoe em toda boa obra, para fazerdes a sua vontade, operando em nós o que perante ele é agradável, por meio de Jesus Cristo, ao qual seja glória para todo o sempre. Amém.
22 My brodas and sistas, I dey beg una, make una get patient and listin to di advise wey dey dis my leta, bikos wetin I rite, nor long.
22 Rogo-vos, porém, irmãos, que suporteis estas palavras de exortação, pois vos escrevi em poucas palavras.
23 Make una know sey dem don release awa broda Timoti from prison. If e kwik kom, e go follow mi kom si una.
23 Sabei que o irmão Timóteo já está solto, com o qual, se ele vier brevemente, vos verei.
24 Make una greet all una leaders and all God pipol. God pipol for Italy dey greet una.
24 Saudai a todos os vossos guias e a todos os santos. Os de Itália vos saúdam.
25 Make God grace dey with all of una.
25 A graça seja com todos vós.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Hebreus 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.