Hebreus 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Faith na wen wi dey sure sey wetin wi dey hope for go happen and wi sure sey, di tins wey wi neva si, go kom.
1 Ora, a fé é o firme fundamento das coisas que se esperam, e a prova das coisas que se não vêem.
2 Na faith awa grand-grand papa dem take do tins wey make God praiz dem.
2 Porque por ela os antigos alcançaram testemunho.
3 Na thru faith wi take undastand sey, God kreate evritin with en word. So di tins wey wi dey si so, na God make dem from wetin dem nor dey si.
3 Pela fé entendemos que os mundos pela palavra de Deus foram criados; de maneira que aquilo que se vê não foi feito do que é aparente.
4 Na faith make Abel give God sakrifice wey betta pass Kain own and na thru dis faith Abel take know sey God asept en ofrin, bikos God really asept am. Even doh Abel don die, en blood still dey tok for am, bikos of en faith.
4 Pela fé Abel ofereceu a Deus maior sacrifício do que Caim, pelo qual alcançou testemunho de que era justo, dando Deus testemunho dos seus dons, e por ela, depois de morto, ainda fala.
5 Na faith nor let Enoch die, but God karry am take and nobody si am. God word sey, before God karry am, Enoch don make belle sweet God.
5 Pela fé Enoque foi trasladado para não ver a morte, e não foi achado, porque Deus o trasladara; visto como antes da sua trasladação alcançou testemunho de que agradara a Deus.
6 Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.
6 Ora, sem fé é impossível agradar-lhe; porque é necessário que aquele que se aproxima de Deus creia que ele existe, e que é galardoador dos que o buscam.
7 Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.
7 Pela fé Noé, divinamente avisado das coisas que ainda não se viam, temeu e, para salvação da sua família, preparou a arca, pela qual condenou o mundo, e foi feito herdeiro da justiça que é segundo a fé.
8 Na faith make Abraham obey wen God koll am make e leave en house, travel go anoda land wey God promise am, even doh e nor know where e dey go.
8 Pela fé Abraão, sendo chamado, obedeceu, indo para um lugar que havia de receber por herança; e saiu, sem saber para onde ia.
9 Na faith make am stay as strenja for di land wey God promise am. Na inside tent en, Isaak and Jakob wey go inherit di same promise, stay.
9 Pela fé habitou na terra da promessa, como em terra alheia, morando em cabanas com Isaque e Jacó, herdeiros com ele da mesma promessa.
10 Abraham do like dis, bikos e dey wait for di town wey God ensef go build with strong foundashon.
10 Porque esperava a cidade que tem fundamentos, da qual o artífice e construtor é Deus.
11 Na faith make Abraham born, even doh Sarah don too old to get belle and Abraham don old too, but e know sey di Pesin wey promise am pikin, na Pesin wey e fit trust.
11 Pela fé também a mesma Sara recebeu a virtude de conceber, e deu à luz já fora da idade; porquanto teve por fiel aquele que lho tinha prometido.
12 So from dis one man wey en body don die finish, shidren wey plenty rish stars for sky and san for wotaside kon full evriwhere.
12 Por isso também de um, e esse já amortecido, descenderam tantos, em multidão, como as estrelas do céu, e como a areia inumerável que está na praia do mar.
13 All of dem faith still strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promise dem, but dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis world.
13 Todos estes morreram na fé, sem terem recebido as promessas; mas vendo-as de longe, e crendo-as e abraçando-as, confessaram que eram estrangeiros e peregrinos na terra.
14 Pipol wey tok like dis, show evribody sey dem dey espect dia own kountry.
14 Porque, os que isto dizem, claramente mostram que buscam uma pátria.
15 Infact, if to sey dem dey tink of di kountry where dem from kom, dem for get mind to go back.
15 E se, na verdade, se lembrassem daquela de onde haviam saído, teriam oportunidade de tornar.
16 But as tins bi so, dem dey espect kountry wey betta pass dia own and e dey kom from heaven. Naim make God nor shame wen dem dey koll am dia God, bikos E don build big town for dem.
16 Mas agora desejam uma melhor, isto é, a celestial. Por isso também Deus não se envergonha deles, de se chamar seu Deus, porque já lhes preparou uma cidade.
17 Na faith make Abraham offa Isaak wen God dey test am. Even doh na God gi-am di pikin, e still ready to give di only pikin wey e get, back to God.
17 Pela fé ofereceu Abraão a Isaque, quando foi provado; sim, aquele que recebera as promessas ofereceu o seu unigênito.
18 God tell am before sey, “True Isaak, yor family go many well-well.”
18 Sendo-lhe dito: Em Isaque será chamada a tua descendência, considerou que Deus era poderoso para até dentre os mortos o ressuscitar;
19 Dis na bikos Abraham bilive sey, even if Isaak die, God go raiz am from deat and true-true Abraham really kollect Isaak back from deat.
19 E daí também em figura ele o recobrou.
20 Na faith make Isaak bless Jakob and Esau about dia future.
20 Pela fé Isaque abençoou Jacó e Esaú, no tocante às coisas futuras.
21 Before Jakob die, na faith e take bless Josef shidren and woship God as e rest on-top en walkin stik.
21 Pela fé Jacó, próximo da morte, abençoou cada um dos filhos de José, e adorou encostado à ponta do seu bordão.
22 Wen Josef life don dey end, na faith e take tok about di long travel wey Israel pipol go-go and e tell dem wetin dem go do with en bones.
22 Pela fé José, próximo da morte, fez menção da saída dos filhos de Israel, e deu ordem acerca de seus ossos.
23 Na faith make Moses papa and mama hide am wen dem born am, bikos dem si sey di pikin fine and dem nor fear to disobey wetin di king kommand.
23 Pela fé Moisés, já nascido, foi escondido três meses por seus pais, porque viram que era um menino formoso; e não temeram o mandamento do rei.
24 Wen Moses kon grow up, na faith make am nor gri make dem koll am Fero dota pikin.
24 Pela fé Moisés, sendo já grande, recusou ser chamado filho da filha de Faraó,
25 Instead of am to enjoy tins wey go make am sin, e kon choose to sofa with God shidren.
25 Escolhendo antes ser maltratado com o povo de Deus, do que por um pouco de tempo ter o gozo do pecado;
26 E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward.
26 Tendo por maiores riquezas o vitupério de Cristo do que os tesouros do Egito; porque tinha em vista a recompensa.
27 Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si.
27 Pela fé deixou o Egito, não temendo a ira do rei; porque ficou firme, como vendo o invisível.
28 Na faith make Moses do di Passova and pour blood for pipol door-mot, so dat God angel wey dey kill all di first-born for Egypt, nor go tosh dem.
28 Pela fé celebrou a páscoa e a aspersão do sangue, para que o destruidor dos primogênitos lhes não tocasse.
29 Na faith make Israel pipol cross di Red Sea like sey na dry land, but wen Egypt pipol try am, di wota swallow all of dem.
29 Pela fé passaram o Mar Vermelho, como por terra seca; o que intentando os egípcios, se afogaram.
30 Na faith make Jeriko wall fall afta Israel pipol don mash round am for seven days.
30 Pela fé caíram os muros de Jericó, sendo rodeados durante sete dias.
31 Na faith make Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroy pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.
31 Pela fé Raabe, a meretriz, não pereceu com os incrédulos, acolhendo em paz os espias.
32 Wetin I go tok again? I nor get time to tok about Gideon, Barak, Samson, Jeftah, David, Samuel and di profets,
32 E que mais direi? Faltar-me-ia o tempo contando de Gideão, e de Baraque, e de Sansão, e de Jefté, e de Davi, e de Samuel e dos profetas,
33 na faith dem take win kingdoms; do wetin good for God eye; kon get di tins wey God promise dem; klose lion mout;
33 Os quais pela fé venceram reinos, praticaram a justiça, alcançaram promessas, fecharam as bocas dos leões,
34 kwensh fire wey dey burn well-well and eskape wen dem won kill dem with swod. God turn dia weakness to pawa. Dem strong well-well for war front and sojas from oda kountries, dey run from dem.
34 Apagaram a força do fogo, escaparam do fio da espada, da fraqueza tiraram forças, na batalha se esforçaram, puseram em fuga os exércitos dos estranhos.
35 Some wimen wey dia pipol don die, na faith make dem receive dem back, alive. Some pipol rijet freedom kon die for sofa, so dat dem go fit wake-up from deat and enter life wey betta pass dis one.
35 As mulheres receberam pela ressurreição os seus mortos; uns foram torturados, não aceitando o seu livramento, para alcançarem uma melhor ressurreição;
36 Pipol laf some; flog some; shain some and put odas for prison.
36 E outros experimentaram escárnios e açoites, e até cadeias e prisões.
37 Dem stone some; use saw kut some into two; take swod kill some; some wear goat and sheep skin dey hide waka and dem nor get anytin; dem sofa some and trit odas anyhow.
37 Foram apedrejados, serrados, tentados, mortos ao fio da espada; andaram vestidos de peles de ovelhas e de cabras, desamparados, aflitos e maltratados
38 (Dis world nor good rish for dem); dem just dey waka about for wildaness, on-top mountins, inside rock and holes.
38 (Dos quais o mundo não era digno), errantes pelos desertos, e montes, e pelas covas e cavernas da terra.
39 God praiz all of dem for dia faith, yet dem nor still get wetin God promise.
39 E todos estes, tendo tido testemunho pela fé, não alcançaram a promessa,
40 Bikos God plan sey, without us, dem nor go fit get di tins wey E promise dem.
40 Provendo Deus alguma coisa melhor a nosso respeito, para que eles sem nós não fossem aperfeiçoados.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Hebreus 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.