Gênesis 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Wen human being don plenty for di world and dem kon dey born girls,
1 Como se foram multiplicando os homens na terra, e lhes nasceram filhas,
2 some among God sons kon si as woman fine rish. So dem kon dey marry dem as wife.
2 vendo os filhos de Deus que as filhas dos homens eram formosas, tomaram para si mulheres, as que, entre todas, mais lhes agradaram.
3 So Oga God kon sey, “My Spirit nor go fit stay with man again pass one hundred and twenty years, bikos dem bi ordinary human being.”
3 Então, disse o Senhor : O meu Espírito não agirá para sempre no homem, pois este é carnal; e os seus dias serão cento e vinte anos.
4 Before-before and even leta, Nefilim pipol (giant pipol) dey for di eart and na God sons born dem wen dem dey sleep with ordinary wimen. Na dem bi di wariors wey pipol bin know for evriwhere.
4 Ora, naquele tempo havia gigantes na terra; e também depois, quando os filhos de Deus possuíram as filhas dos homens, as quais lhes deram filhos; estes foram valentes, varões de renome, na antiguidade.
5 But di Oga God si as human being wikedness don strong for di eart. Evritin wey dem dey tink for dia mind, na how to do evil tins.
5 Viu o Senhor que a maldade do homem se havia multiplicado na terra e que era continuamente mau todo desígnio do seu coração;
6 Oga God regret sey E make human being for dis eart and E kon dey vex.
6 então, se arrependeu o Senhor de ter feito o homem na terra, e isso lhe pesou no coração.
7 So Oga God sey, “I go distroy human being wey I kreate komot for dis eart; plus evritin, from human being go rish animals, join di ones wey dey creep for groun and di birds for di sky, bikos I dey vex sey I kreate dem.”
7 Disse o Senhor : Farei desaparecer da face da terra o homem que criei, o homem e o animal, os répteis e as aves dos céus; porque me arrependo de os haver feito.
8 But di Oga God like Noah well-well, bikos e dey good for God eye.
8 Porém Noé achou graça diante do Senhor .
9 Dis na Noah story. Noah na pesin wey dey fear God; e nor get fault for body among evry oda human being. E dey waka with di Oga God.
9 Eis a história de Noé. Noé era homem justo e íntegro entre os seus contemporâneos; Noé andava com Deus.
10 Noah get three boys and dia name na: Shem, Ham and Jafet.
10 Gerou três filhos: Sem, Cam e Jafé.
11 But evry oda pesin dey bad for di Oga God eye.
11 A terra estava corrompida à vista de Deus e cheia de violência.
12 God look di eart kon si sey e dey bad well-well, bikos all di pipol dey live wiked life.
12 Viu Deus a terra, e eis que estava corrompida; porque todo ser vivente havia corrompido o seu caminho na terra.
13 So God kon tell Noah, “I don sey I go kill evritin wey dey dis eart, bikos bad tins full di eart bikos of dem. Naw I won distroy dem and di eart.
13 Então, disse Deus a Noé: Resolvi dar cabo de toda carne, porque a terra está cheia da violência dos homens; eis que os farei perecer juntamente com a terra.
14 “Make yu go make one boat kon kover am for inside and outside.
14 Faze uma arca de tábuas de cipreste; nela farás compartimentos e a calafetarás com betume por dentro e por fora.
15 Dis na how yu go make am: Di boat go long rish 400 fit, e go wide rish seventy-five fit and e go high rish forty-five fit.
15 Deste modo a farás: de trezentos côvados será o comprimento; de cinquenta, a largura; e a altura, de trinta.
16 Yu go make roof for di boat, finish am kon leave space wey rish eight inches from di top. Put one door for di boat and yu go divide am into three: di lowa one, di middle and di uppa one.
16 Farás ao seu redor uma abertura de um côvado de altura; a porta da arca colocarás lateralmente; farás pavimentos na arca: um em baixo, um segundo e um terceiro.
17 “I go make rain fall for di eart wey go distroy evritin wey get life under di sky. Evritin wey dey di eart go die,
17 Porque estou para derramar águas em dilúvio sobre a terra para consumir toda carne em que há fôlego de vida debaixo dos céus; tudo o que há na terra perecerá.
18 but I go keep my kovenant with yu. Yu go enter di boat: yu, yor sons, yor wife and yor shidren dem wife.
18 Contigo, porém, estabelecerei a minha aliança; entrarás na arca, tu e teus filhos, e tua mulher, e as mulheres de teus filhos.
19 Yu must take two-two of evry kind animals enter di boat, make dem bi man and woman, so dat dem go fit born and dey alive with yu.
19 De tudo o que vive, de toda carne, dois de cada espécie, macho e fêmea, farás entrar na arca, para os conservares vivos contigo.
20 For evry kind bird, yu go take two and for evry kind kattle, doz animal wey dey creep for groun, yu go take two-two, so dat yu go keep dem.
20 Das aves segundo as suas espécies, do gado segundo as suas espécies, de todo réptil da terra segundo as suas espécies, dois de cada espécie virão a ti, para os conservares em vida.
21 And yu go take and gada evry kind food enter inside di boat, so dat una go dey si food chop.”
21 Leva contigo de tudo o que se come, ajunta-o contigo; ser-te-á para alimento, a ti e a eles.
22 So Noah do as God kommand am.
22 Assim fez Noé, consoante a tudo o que Deus lhe ordenara.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.