Gênesis 50
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Den Josef kiss en papa for face kon kry well-well, bikos of am.
1 Então, José se lançou sobre o rosto de seu pai, e chorou sobre ele, e o beijou.
2 Josef kon tell di doctor sey make e dress di dead body, so di doctor kon dress Israel (wey bi Jakob).
2 E José ordenou aos seus servos, os médicos, que embalsamassem o seu pai; e os médicos embalsamaram Israel.
3 E dress am well, so dat di body go fit dey der for forty day, bikos dat na di normal time wey di body suppose last. Egypt pipol use seventy days take mourn for am.
3 E cumpriram-se-lhe quarenta dias, porque assim se cumprem os dias daqueles que se embalsamam; e os egípcios o choraram setenta dias.
4 Wen dem don mourn finish, Josef kon tell Fero ofisas, “If really sey una like mi, make una tell Fero sey,
4 Passados os dias de seu choro, falou José à casa de Faraó, dizendo: Se agora tenho achado graça aos vossos olhos, rogo-vos que faleis aos ouvidos de Faraó, dizendo:
5 ‘My papa make mi swear wen e sey, “I go soon die. Make yu beri mi for di grave wey I dig for mysef for Kanaan.” Naw make I go beri my papa; den I go kom back.’ ”
5 Meu pai me fez jurar, dizendo: Eis que eu morro; em meu sepulcro, que cavei para mim na terra de Canaã, ali me sepultarás. Agora, pois, te peço, que eu suba, para que sepulte o meu pai; então, voltarei.
6 So Fero sey, “Make yu go beri yor papa, just as e make yu swear sey yu go do.”
6 E Faraó disse: Sobe e sepulta o teu pai, como ele te fez jurar.
7 So Josef go beri en papa and all Fero ofisas follow am go; from di senior ofisas go rish di oda ones for di hold Egypt,
7 E José subiu para sepultar o seu pai; e subiram com ele todos os servos de Faraó, os anciãos da sua casa e todos os anciãos da terra do Egito,
8 Josef family, en brodas and en papa family. But dem leave di small-small shidren and dia animal for Goshen.
8 como também toda a casa de José, e seus irmãos, e a casa de seu pai; somente deixaram na terra de Gósen os seus meninos, e as suas ovelhas, e as suas vacas.
9 War horse and di driver still follow am go, so pipol wey follow am many well-well.
9 E subiram também com ele tanto carros como gente a cavalo; e o concurso foi grandíssimo.
10 Wen dem rish Atad aria for di oda side for Jordan River, dem mourn and kry for der well-well. Na for der Josef for mourn seven days for en papa.
10 Chegando eles, pois, à eira do espinhal, que está além do Jordão, fizeram um grande e gravíssimo pranto; e fez a seu pai um grande pranto por sete dias.
11 Wen Kanaan pipol wey dey stay di land si dem dey mourn for Atad, dem kon sey, “Wetin happen nor good at-all for Egypt pipol.” Dat na why dem dey koll di place Abel Mizraim and e dey afta Jordan River.
11 E, vendo os moradores da terra, os cananeus, o luto na eira do espinhal, disseram: É este o pranto grande dos egípcios. Por isso, chamou-se o seu nome Abel-Mizraim, que está além do Jordão.
12 So Jakob shidren do for am, just as e kommand dem before.
12 E fizeram-lhe os seus filhos assim como ele lhes ordenara,
13 En sons karry am go Kanaan kon beri am for di grave wey dey Makpelah field near Mamre. Dis na di field wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin.
13 pois os seus filhos o levaram à terra de Canaã e o sepultaram na cova do campo de Macpela, que Abraão tinha comprado com o campo, por herança de sepultura, a Efrom, o heteu, em frente de Manre.
14 Afta Josef don beri en papa, e kon go back to Egypt with en brodas and evribody wey follow am.
14 Depois, tornou José para o Egito, ele, e seus irmãos, e todos os que com ele subiram a sepultar o seu pai, depois de haver sepultado o seu pai.
15 Wen Josef brodas si sey dia papa don die, dem kon sey, “Wot of if Josef still dey vex and e kon sey e go ponish us for evritin wey wi do am?”
15 Vendo, então, os irmãos de José que o seu pai já estava morto, disseram: Porventura, nos aborrecerá José e nos pagará certamente todo o mal que lhe fizemos.
16 So dem kon go tell Josef sey, “Yor papa give dis kommand before e die sey:
16 Portanto, enviaram a José, dizendo: Teu pai mandou, antes da sua morte, dizendo:
17 ‘Make una tell Josef: “Make yu forgive yor brodas dia sins and di bad tins wey dem do yu.” ’ Naw make yu forgive di sins wey yor broda God savant, kommit.” Wen dem tell Josef di message, Josef kry well-well.
17 Assim direis a José: Perdoa, rogo-te, a transgressão de teus irmãos e o seu pecado, porque te fizeram mal; agora, pois, rogamos-te que perdoes a transgressão dos servos do Deus de teu pai. E José chorou quando eles lhe falavam.
18 Den en brodas kom fall for en front dey sey, “Na wi bi dis and wi bi yor savants.”Josef brodas bow down to am wen e dey tok to dem for Egypt|alt="Joseph talking to his brothers in Egypt" src="cn01917b.tif" size="col" loc="GEN 50:15-21" copy="Cook" ref="50:18"
18 Depois, vieram também seus irmãos, e prostraram-se diante dele, e disseram: Eis-nos aqui por teus servos.
19 But Josef ansa dem, “Make una nor fear. Na God know wetin E won do.
19 E José lhes disse: Não temais; porque, porventura, estou eu em lugar de Deus?
20 Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.
20 Vós bem intentastes mal contra mim, porém Deus o tornou em bem, para fazer como se vê neste dia, para conservar em vida a um povo grande.
21 So, make una nor fear. Evritin wey una wont, I go give una and una shidren and family.” Den e follow dem tok well.
21 Agora, pois, não temais; eu vos sustentarei a vós e a vossos meninos. Assim, os consolou e falou segundo o coração deles.
22 Josef stay for Egypt with en papa family. Josef stay for one hundred and ten years.
22 José, pois, habitou no Egito, ele e a casa de seu pai; e viveu José cento e dez anos.
23 Josef si Efraim shidren-shidren. E still si Manasseh pikin Makir and en shidren; Josef give dem betta land and propaty.
23 E viu José os filhos de Efraim, da terceira geração; também os filhos de Maquir, filho de Manassés, nasceram sobre os joelhos de José.
24 Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”
24 E disse José a seus irmãos: Eu morro, mas Deus certamente vos visitará e vos fará subir desta terra para a terra que jurou a Abraão, a Isaque e a Jacó.
25 Josef kon make Israel pipol swear. E tell dem, “God go really kom meet una. Den una must karry my bones follow body komot from dis place.”
25 E José fez jurar os filhos de Israel, dizendo: Certamente, vos visitará Deus, e fareis transportar os meus ossos daqui.
26 So Josef die wen e bi one hundred and ten years. Afta dem don dress en body dem kon put am for one koffin for Egypt.
26 E morreu José da idade de cento e dez anos; e o embalsamaram e o puseram num caixão no Egito.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 50, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.