Gênesis 47

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 Josef kon go tell Fero sey, “My papa, my brodas, dia animals and evritin wey dem get don kom from Kanaan. Dem dey for Goshen.”
1 Então, José veio e contou a Faraó, e disse: Meu pai e meus irmãos, e seus rebanhos, e seu gado, e tudo que eles possuem vieram da terra de Canaã; e eis que eles estão na terra de Gósen.
2 Josef take five among en brodas kon introduce dem to Fero.
2 E ele tomou alguns de seus irmãos, cinco homens, e os apresentou a Faraó.
3 Fero kon ask Josef brodas, “Na wetin una dey do.”
3 E Faraó disse a seus irmãos: Qual é a vossa ocupação? E eles disseram a Faraó: Teus servos são pastores, tanto nós como também nossos pais.
4 Den dem tell Fero, “Wi just won stay for dis land for sometaim. Wi nor get food for awa animals, bikos of di honga for di whole Kanaan. So wi beg, make yu let wi yor savant stay for Goshen.”
4 Disseram mais a Faraó: Viemos para peregrinar nesta terra, porque teus servos não têm pastagem para seus rebanhos. Porque a fome é dolorida na terra de Canaã, por isso, suplicamos-te agora, deixa que teus servos habitem na terra de Gósen.
5 So Fero tell Josef, “Na yu yor papa and brodas kom meet.
5 E Faraó falou a José, dizendo: Teu pai e teus irmãos vieram a ti.
6 Egypt dey yor hand, so make yu do as yu like to yor papa and brodas. Dem fit stay for Goshen and if yu know any strong one among dem, yu fit gi-am my animals make e guide dem.”
6 A terra do Egito está diante de ti; no melhor da terra faze teu pai e teus irmãos habitar; na terra de Gósen, deixa-os habitar. E se tu conheces algum homem de atividade entre eles, então faze-os responsáveis por meu gado.
7 Den Josef take en papa Jakob go meet Fero. Jakob kon bless Fero.
7 E José trouxe Jacó, seu pai, e o colocou diante de Faraó, e Jacó abençoou Faraó.
8 Fero ask Jakob, “How many years yu don spend for dis life?”
8 E Faraó disse a Jacó: Quantos anos tu tens?
9 Jakob ansa Fero, “I don stay for more dan one hundred and thirty years. And all di years wey I don spend for dis life nor many, but e nor dey eazy; di years wey I don stay, nor many rish di years wey my grand-grand papa dem stay.”
9 E Jacó disse a Faraó: Os dias da minha peregrinação são cento e trinta anos. Poucos e maus têm sido os dias dos anos da minha vida, e não alcançaram aos dias dos anos da vida de meus pais nos dias de suas peregrinações.
10 Den Jakob bless Fero kon komot from der.
10 E Jacó abençoou Faraó, e saiu da presença de Faraó.
11 So Josef make en papa and brodas setol down. E give dem one aria for Egypt, di best aria for di land; wey bi Rameses land, just as Fero tok.
11 E José estabeleceu seu pai e seus irmãos, e lhes deu posses na terra do Egito, no melhor da terra, na terra de Ramessés, como Faraó ordenara.
12 Josef still provide food for en papa, en brodas, all en papa pipol, akordin to di shidren wey dem get.
12 E José sustentou seu pai, e seus irmãos, e toda a casa de seu pai com pão, de acordo com suas famílias.
13 But food nor dey di land again, bikos di honga for evriwhere, strong well-well. So pipol kon die anyhow for Egypt and Kanaan land, bikos food nor dey.
13 E não havia pão em toda a terra, porque a fome era muito dolorida, de modo que a terra do Egito e toda a terra de Canaã desfaleciam por causa da fome.
14 Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, so Josef kollect and karry all di money go give Fero for en palis.
14 E José ajuntou todo o dinheiro que foi encontrado na terra do Egito, e na terra de Canaã, pelo trigo que eles compravam, e José levou o dinheiro para a casa de Faraó.
15 So wen Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, all di pipol for Egypt kon go meet Josef dey sey, “Make yu give us food! Abi yu wont make wi die for yor front, bikos awa money don finish?”
15 E quando o dinheiro acabou na terra do Egito, e na terra de Canaã, todos os egípcios vieram a José, e disseram: Dá-nos pão, por que morreremos na tua presença? Pois o dinheiro acabou.
16 Den Josef sey, “If una money don finish, make una bring una animals kon give mi and I go give una food.”
16 E José disse: Dai o vosso gado, e eu vos darei pelo vosso gado, se não há dinheiro.
17 So dem bring all dia animals kon give Josef and Josef give dem food afta dem don drop dia horse, sheep and kattle. E save dem dat year, bikos e still dey give dem food chop wen dem bring dia animals.
17 E eles levaram seu gado a José, e José lhes deu pão em troca pelos cavalos, e pelos rebanhos, e pelo gado dos rebanhos, e pelos jumentos. E durante aquele ano ele os alimentou em troca de todo o seu gado.
18 Wen dat year don finish, dem kon meet am di next year dey sey, “Wi nor fit hide am from awa oga sey di money and all awa animals don finish.
18 Quando aquele ano terminou, vieram a ele no segundo ano, e lhe disseram: Não ocultaremos a meu senhor que o nosso dinheiro acabou. Meu senhor também tem nossos rebanhos de gado. Nada nos sobrou diante da vista do meu senhor, exceto nossos corpos e nossas terras.
19 Wetin go make us die for yor eye; both wi and awa land. Make yu buy wi and awa land and wi and awa land go bi Fero own. Just give us food, so dat wi nor go die. Den di land nor go dey empty.”
19 Por que morreremos diante dos teus olhos, tanto nós, como a nossa terra? Compra a nós e a nossa terra por pão, e nós e nossa terra seremos servos de Faraó, e dá-nos semente, para que possamos viver, e não morrer, para que a terra não seja desolada.
20 So Josef buy all di land for Egypt kon gi-am to Fero. Evribody for Egypt sell dia field, bikos di honga dey strong evriday. So all di land for Egypt kon bi Fero own.
20 E José comprou toda a terra do Egito para Faraó, porque os egípcios venderam, cada homem, o seu campo, porque a fome prevalecia sobre eles. Assim, a terra passou a ser de Faraó.
21 So Josef kon make evribody for Egypt turn slave.
21 E quanto ao povo, ele os removeu para as cidades, desde uma extremidade das fronteiras do Egito até a outra extremidade.
22 But e nor buy di priests land, bikos di priests get favor from Fero eye, so dem dey chop from di share wey Fero give dem. Dat na why dem nor sell dia land.
22 Somente a terra dos sacerdotes ele não comprou, pois os sacerdotes possuíam uma porção atribuída por Faraó, e comiam a sua porção que Faraó lhes dava; por isso, eles não venderam suas terras.
23 Josef kon tell di pipol, “Since I don buy una and una land for Fero, make una take seed kon go plant for di land.
23 Então José disse a seu povo: Eis que neste dia comprei a vós e a vossa terra para Faraó. Vede, aqui há semente para vós, e semeareis a terra.
24 Wen una don harvest wetin una plant, make una divide am into ten kon give five part to Fero and una with una family fit chop di rest.”
24 E acontecerá que, das colheitas, dareis uma quinta parte a Faraó, e quatro partes serão vossas, para semear o campo, e para vosso alimento, e para os da vossa família, e para alimento para os vossos pequenos.
25 Dem ansa, “Yu don save awa life! Yu don show us favor and wi go bi Fero savants.”
25 E eles disseram: Tu salvaste as nossas vidas. Que encontremos graça à vista de meu senhor, e nós seremos servos de Faraó.
26 So wetin Josef tok kon bi law for Egypt and dem dey obey am kon rish today: wen dem divide evritin, five part na Fero own. Na only di priests land nor bi Fero own.
26 E José fez esta lei sobre a terra do Egito até este dia, que Faraó deveria ter a quinta parte, exceto a terra dos sacerdotes, que não se tornou de Faraó.
27 Israel stay for Egypt, for Goshen and dem kon get land for der.
27 E Israel habitou na terra do Egito, na região de Gósen; e eles tinham posses ali, e cresceram, e se multiplicaram grandemente.
28 Jakob stay seventeen years for Egypt; so all di years wey Jakob stay, na one hundred and forty-seven years.
28 E Jacó viveu na terra do Egito por dezessete anos. Assim, toda a idade de Jacó foi cento e quarenta e sete anos.
29 Di time wey Israel won die kon rish, so e koll en pikin Josef kon tell am, “If really sey yu love mi, make yu put yor hand under my lap kon show mi kindness and faithfulnes. Make yu nor beri mi for Egypt,
29 E chegando-se o tempo que Israel devia morrer. Ele chamou seu filho José, e lhe disse: Se agora eu encontrei graça à tua vista, rogo-te que ponhas tua mão debaixo da minha coxa, e age com bondade e verdade para comigo: Não me enterres, rogo-te, no Egito,
30 but wen I die, karry mi komot from Egypt go beri for my papa burial groun.” So Josef sey, “Papa! I go do as yu tok.”
30 mas quando eu descansar com meus pais, tu me levarás para fora do Egito, e me enterrarás no lugar de sepultamento deles. E ele disse: Eu farei como tu disseste.
31 Israel sey, “Make yu promise mi sey yu go do as I tok.” So Josef promise. Den Israel bow face groun for en bed korna.
31 E ele disse: Jura-me. E ele lhe jurou. E Israel se curvou sobre a cabeceira da cama.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 47, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.