Gênesis 45

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Josef nor fit kontrol ensef again so e kon sey, “Make evribody komot for my front naw!” Nobody dey der with Josef wen e tell en brodas who e bi.
1 Então, José, não se podendo conter diante de todos os que estavam com ele, bradou: Fazei sair a todos da minha presença! E ninguém ficou com ele, quando José se deu a conhecer a seus irmãos.
2 E kry well-well; Egypt pipol and evribody plus Fero sef, hear about wetin happen.
2 E levantou a voz em choro, de maneira que os egípcios o ouviam e também a casa de Faraó.
3 Josef kon tell en brodas, “I bi Josef! My papa still dey alive?” En brodas nor fit ansa am, bikos dem sopraiz well-well with fear as dem stand for en front.
3 E disse a seus irmãos: Eu sou José; vive ainda meu pai? E seus irmãos não lhe puderam responder, porque ficaram atemorizados perante ele.
4 Josef kon tell dem, “Make una waka near mi,” so dem waka near am. Den e sey, “I bi Josef una broda wey una sell give pipol wey dey kom Egypt.
4 Disse José a seus irmãos: Agora, chegai-vos a mim. E chegaram-se. Então, disse: Eu sou José, vosso irmão, a quem vendestes para o Egito.
5 Naw, make una nor fear or dey vex with unasef, bikos even doh una sell mi kom here, na God send mi go for una front, so dat pipol life go dey save!
5 Agora, pois, não vos entristeçais, nem vos irriteis contra vós mesmos por me haverdes vendido para aqui; porque, para conservação da vida, Deus me enviou adiante de vós.
6 Bikos for dis two years wey honga dey so, na so honga go still dey for di next five years.
6 Porque já houve dois anos de fome na terra, e ainda restam cinco anos em que não haverá lavoura nem colheita.
7 So God send mi kom for una front, so dat una go dey di eart and una nor go die.
7 Deus me enviou adiante de vós, para conservar vossa sucessão na terra e para vos preservar a vida por um grande livramento.
8 So naw, nor bi una send mi kom here, but na God. E don turn mi to Fero adviser, di oga ova all en propaty and di ruler for Egypt land.
8 Assim, não fostes vós que me enviastes para cá, e sim Deus, que me pôs por pai de Faraó, e senhor de toda a sua casa, e como governador em toda a terra do Egito.
9 “Naw, make una kwik-kwik go tell my papa sey, ‘Dis na wetin Josef yor pikin tok: “God don make mi oga ova all di land for Egypt. So make yu kwik-kwik kom meet mi!
9 Apressai-vos, subi a meu pai e dizei-lhe: Assim manda dizer teu filho José: Deus me pôs por senhor em toda terra do Egito; desce a mim, não te demores.
10 Una go dey for Goshen land and una go dey near mi; both una, una shidren, una grand-shidren, una animals and plants and evritin wey una get.
10 Habitarás na terra de Gósen e estarás perto de mim, tu, teus filhos, os filhos de teus filhos, os teus rebanhos, o teu gado e tudo quanto tens.
11 I go provide food for una for here, bikos dis honga go still last for five years. If not, una go soon dey poor; both una and una family and evribody and tins wey bilong to una.” ’
11 Aí te sustentarei, porque ainda haverá cinco anos de fome; para que não te empobreças, tu e tua casa e tudo o que tens.
12 “Una with my broda Benjamin don si sey na mi, Josef, dey follow una dey tok.
12 Eis que vedes por vós mesmos, e meu irmão Benjamim vê também, que sou eu mesmo quem vos fala.
13 So make una tell my papa about all my honor for Egypt and about evritin wey una dey si so. But make una kwik bring my papa kom meet mi for here!”
13 Anunciai a meu pai toda a minha glória no Egito e tudo o que tendes visto; apressai-vos e fazei descer meu pai para aqui.
14 Den Josef hold en broda Benjamin near body kon kry well-well and Benjamin kon dey kry too.
14 E, lançando-se ao pescoço de Benjamim, seu irmão, chorou; e, abraçado com ele, chorou também Benjamim.
15 Josef kiss all en brodas as e dey kry. Afta, en brodas kon follow am tok.
15 José beijou a todos os seus irmãos e chorou sobre eles; depois, seus irmãos falaram com ele.
16 Naw dem kon go tell Fero for en house sey, “Josef brodas don kom.” Di news sweet Fero and en savants.
16 Fez-se ouvir na casa de Faraó esta notícia: São vindos os irmãos de José; e isto foi agradável a Faraó e a seus oficiais.
17 Fero kon tell Josef, “Make yu go tell yor brodas sey, ‘Make una do like dis: Make una load una animal kon go Kanaan land!
17 Disse Faraó a José: Dize a teus irmãos: Fazei isto: carregai os vossos animais e parti; tornai à terra de Canaã,
18 Den make una karry una papa and family kom stay here! Den I go give una di best land for Egypt and una go dey chop di best food for dis land.’
18 tomai a vosso pai e a vossas famílias e vinde para mim; dar-vos-ei o melhor da terra do Egito, e comereis a fartura da terra.
19 Make yu still tell dem sey, ‘Make una do like dis: Una go karry horse wey dey karry load from dis land kon go karry una family kom from Kanaan; both una wifes and shidren. Make una bring una papa kom too.
19 Ordena-lhes também: Fazei isto: levai da terra do Egito carros para vossos filhinhos e para vossas mulheres, trazei vosso pai e vinde.
20 Make una nor worry about una propaty, bikos di best tins wey dey Egypt go bi una own.’ ”
20 Não vos preocupeis com coisa alguma dos vossos haveres, porque o melhor de toda a terra do Egito será vosso.
21 So Israel sons kon do as Josef tell dem. Josef give dem horse wey dey karry load, just as Fero tok kon give dem tins wey dem go nid for dia journey.
21 E os filhos de Israel fizeram assim. José lhes deu carros, conforme o mandado de Faraó; também lhes deu provisão para o caminho.
22 E still give all of dem many klot, but e give Benjamin three hundred silva and five klot.
22 A cada um de todos eles deu vestes festivais, mas a Benjamim deu trezentas moedas de prata e cinco vestes festivais.
23 E send dis tins go meet en papa: ten donkey wey karry di best goods for Egypt and ten woman donkey wey karry korn, food and di tins wey en papa go nid for en journey.
23 Também enviou a seu pai dez jumentos carregados do melhor do Egito, e dez jumentos carregados de cereais e pão, e provisão para o seu pai, para o caminho.
24 Den e send en brodas go and dem kon komot from en present. E tell dem, “As una dey travel, make una nor let fear worry una.”
24 E despediu os seus irmãos. Ao partirem, disse-lhes: Não contendais pelo caminho.
25 So dem komot from Egypt go meet dia papa, Jakob for Kanaan.
25 Então, subiram do Egito, e vieram à terra de Canaã, a Jacó, seu pai,
26 Dem tell dia papa, “Josef neva die and na en dey rule Egypt!” Jakob kon sopraiz, bikos e nor bilive dem.
26 e lhe disseram: José ainda vive e é governador de toda a terra do Egito. Com isto, o coração lhe ficou como sem palpitar, porque não lhes deu crédito.
27 But wen dem tell Jakob evritin wey Josef tell dem and wen e si di horse wey Josef send kom karry am, e kon bilive sey na trut.
27 Porém, havendo-lhe eles contado todas as palavras que José lhes falara, e vendo Jacó, seu pai, os carros que José enviara para levá-lo, reviveu-se-lhe o espírito.
28 Den Israel sey, “E don do! My pikin Josef still dey alive! I go-go si am before I die.”
28 E disse Israel: Basta; ainda vive meu filho José; irei e o verei antes que eu morra.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 45, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.