Gênesis 44
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 Josef kon tell di savant wey dey kare for en house sey, “Make yu pak food full dia sak kon give evribody dia money back.
1 Então José deu a seguinte ordem ao administrador do palácio: “Coloque nos sacos que eles trouxeram todo o cereal que puderem carregar, e coloque o dinheiro de cada um de volta no saco.
2 Den make yu put my silva cup for di yonga one sak, plus en money.” So di man do as Josef tell am.
2 Depois, coloque meu copo de prata na boca do saco de mantimento do mais novo, junto com o dinheiro dele”. O administrador fez tudo conforme José ordenou.
3 Wen morning rish, di men and dia donkey kon go.
3 Assim que amanheceu, os irmãos se levantaram e partiram com os jumentos carregados.
4 Dem neva go far from di town wen Josef tell di savant wey dey kare for en house, “Make yu porshu dem at wons! Wen yu katch dem, tell dem sey, ‘Wetin make una repay bad for good?
4 Quando haviam percorrido apenas uma distância curta e mal haviam saído da cidade, José disse ao administrador do palácio: “Vá atrás deles e detenha-os. Quando os alcançar, diga-lhes: ‘Por que retribuíram o bem com o mal?
5 Wetin make una tif my oga silva cup wey e dey use drink and shek di future? Una don do bad!’ ”
5 Por que roubaram o copo de prata do meu senhor, que ele usa para prever o futuro? Vocês agiram muito mal!’”.
6 Wen di savant katch dem, e kon tell dem di word.
6 Quando o administrador do palácio alcançou os homens, repetiu para eles as palavras de José.
7 Dem ansa di savant, “Wetin make awa oga tok like dis? E nor dey possibol for yor savant to do dat kind tin!
7 “Do que o senhor está falando?”, disseram os irmãos. “Somos seus servos e jamais faríamos uma coisa dessas!
8 Si! Di money wey wi si for awa sak before, wi bring am kom back. So wetin go make us tif silva or gold from yor oga house?
8 Por acaso não devolvemos o dinheiro que encontramos nos sacos? Nós o trouxemos de volta da terra de Canaã. Por que roubaríamos ouro ou prata da casa do seu senhor?
9 If any of us tif am, e go die and di remainin of us go bi awa oga savant!”
9 Se encontrar o copo de prata com um de nós, que morra quem estiver com ele! E nós, os restantes, seremos seus escravos.”
10 Di savant ansa, “Una don choose una own ponishment! Di pesin wey tif am go bi my savant, but di rest of una go-go free.”
10 “Sua proposta é justa”, respondeu ele. “Mas apenas aquele que roubou o copo de prata se tornará meu escravo. Os outros estarão livres.”
11 So dem put dia sak for groun kon open am.
11 Sem demora, eles descarregaram os sacos e os abriram.
12 Den di man bigin shek. E start with di old one first till e rish di last one. Dem kon si di cup for Benjamin sak!
12 O administrador do palácio examinou a bagagem de cada um, começando pelo mais velho até o mais novo. E o copo foi encontrado no saco de mantimento de Benjamim.
13 Den all of dem kon tear dia klot! Den dem arrange dia donkey kon go back to di town.
13 Quando os irmãos viram isso, rasgaram as roupas. Depois, colocaram a carga de volta sobre os jumentos e retornaram à cidade.
14 So Judah and en brodas kon go back to Josef house. Josef still dey house, so dem kon fall dey beg am.
14 José ainda estava em seu palácio quando Judá e seus irmãos chegaram, e eles se curvaram até o chão diante dele.
15 Josef tell dem, “Wetin una tink sey una do so? So una nor know sey pesin like mi dey know tins before e happen?”
15 “O que vocês fizeram?”, exigiu ele. “Não sabem que um homem como eu é capaz de prever o que vai acontecer?”
16 Judah ansa, “My oga, wetin wi go fit tell yu? Wetin wi go fit tok? How wi go fit take free awasef? God don espose awa sin! My oga, wi don bi yor savant, wi and di pesin wey dem si di cup for en sak.”
16 Judá respondeu: “Meu senhor, o que podemos dizer? Que explicação podemos dar? Como podemos provar nossa inocência? Deus está nos castigando por causa de nossa maldade. Todos nós voltamos para ser seus escravos, todos nós, e não apenas nosso irmão com quem foi encontrado o copo de prata”.
17 But Josef tell dem, “I nor go fit do dat tin! Di man wey dem for si di cup for en hand go bi my savant and di rest of una fit go meet una papa with peace.”
17 José, no entanto, disse: “Eu jamais faria uma coisa dessas! Apenas o homem que roubou o copo será meu escravo. Os outros podem voltar em paz para a casa de seu pai”.
18 Den Judah ansa Josef, “My oga, abeg make yu let yor savant tok to yu. Abeg make yu nor vex with yor savant, bikos yu just bi like Fero.
18 Então Judá deu um passo à frente e disse: “Por favor, meu senhor, permita que seu servo lhe diga apenas uma palavra. Peço que não perca a paciência comigo, embora o senhor seja tão poderoso quanto o próprio faraó.
19 My oga ask en savants sey, ‘Una still get papa or broda?’
19 “Meu senhor perguntou a nós, seus servos: ‘Vocês têm pai ou irmão?’.
20 Wi ansa sey, ‘Awa papa don old and wi get one small broda wey dem born for awa papa wen e don old. Di boy broda don die. Na only en bi en mama pikin wey remain and en papa love am well-well.’
20 E nós respondemos: ‘Sim, meu senhor, nosso pai é idoso e tem um filho mais novo, nascido em sua velhice. O irmão desse filho, por parte de pai e mãe, morreu. Ele é o único filho de sua mãe, e nosso pai o ama muito’.
21 Den yu tell us yor savants sey, ‘Make una go bring am kom make I si am.’
21 “O senhor nos disse: ‘Tragam-no aqui para que eu possa vê-lo com os próprios olhos’.
22 Wi tell awa oga sey, ‘Di boy nor go fit leave en papa. If e leave en papa, di papa go die.’
22 E nós respondemos: ‘Meu senhor, o rapaz não pode deixar o pai, pois, se o fizesse, o pai morreria’.
23 But yu tell yor savants sey, ‘If una yonga broda nor follow una kom, una nor go si my face again.’
23 Mas o senhor nos disse: ‘Vocês não me verão novamente se não trouxerem seu irmão’.
24 Wen wi go meet awa papa, wi tell am evritin wey awa oga tok.
24 “Assim, voltamos para seu servo, nosso pai, e contamos a ele o que o senhor tinha dito.
25 Den awa papa sey, ‘Make una go buy some food kom.’
25 Passado algum tempo, quando ele disse: ‘Voltem e comprem mais mantimentos’,
26 But wi tell am, ‘Wi nor go fit go, unless awa yonga broda go follow us, bikos wi nor go fit si di man if e nor follow us.’
26 nós respondemos: ‘Só poderemos voltar se nosso irmão mais novo nos acompanhar. Não temos como ver o homem outra vez, a menos que nosso irmão mais novo esteja conosco’.
27 Den yor savant, awa papa kon sey, ‘Una know sey my wife born two boys for mi.
27 “Então meu pai nos disse: ‘Como vocês sabem, minha mulher teve dois filhos,
28 Di first boy disappear and I kon sey, “Wiked animal go don chop am to pieces.” I neva si am since den.
28 e um deles foi embora e nunca mais voltou. Sem dúvida, foi despedaçado por algum animal selvagem, e eu nunca mais o vi.
29 If una take dis one from mi too and sometin happen to am, den una go make mi die for pain and shame.’
29 Se agora vocês levarem de mim o irmão dele e lhe acontecer algum mal, vocês me mandarão velho e infeliz para a sepultura’.
30 “So naw, how wi won take go back to yor savant, awa papa and di boy nor dey with us; bikos en life dey inside dis en pikin life.
30 “E agora, meu senhor, não posso voltar para a casa de meu pai sem o rapaz. A vida de nosso pai está ligada à vida do rapaz.
31 Wen e si sey di boy nor dey with us, e go die and yor savant go let awa papa yor savant die inside pain and shame.
31 Quando ele vir que o rapaz não está conosco, morrerá. Nós, seus servos, seremos, de fato, responsáveis por mandar para a sepultura seu servo, nosso pai, em profunda tristeza.
32 True-true, yor savant kon tell en papa sey, ‘If I nor bring di boy kom back, den for di rest of my life, I go dey bear di blame.’
32 Meu senhor, garanti a meu pai que levaria o rapaz de volta. Disse-lhe: ‘Se não o trouxer de volta, carregarei a culpa para sempre’.
33 So naw, make yu allow mi bi yor slave instead of dis boy. But for di boy, make e follow my brodas go back.
33 “Por isso, peço ao senhor que me permita ficar aqui como escravo no lugar do rapaz e que o deixe voltar com os irmãos dele.
34 How I won take go back go tell my papa, if di boy nor dey with mi? I nor go fit bear to si my papa sofa for pain.”
34 Pois, como poderei voltar a meu pai sem o rapaz? Não suportaria ver a angústia que isso lhe causaria!”.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 44, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.