Gênesis 43

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Naw di honga strong well-well.
1 A fome persistia gravíssima na terra.
2 So wen dem don chop di food wey dem buy from Egypt finish, dia papa kon tell dem, “Make una still go back go buy some food kom.”
2 Tendo eles acabado de consumir o cereal que trouxeram do Egito, disse-lhes seu pai: Voltai, comprai-nos um pouco de mantimento.
3 But Judah tell en papa sey, “Di oga for der really warn us sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda.’
3 Mas Judá lhe respondeu: Fortemente nos protestou o homem, dizendo: Não me vereis o rosto, se o vosso irmão não vier convosco.
4 But if yu allow awa broda follow us, den wi go-go buy food.
4 Se resolveres enviar conosco o nosso irmão, desceremos e te compraremos mantimento;
5 But if yu nor gri make e follow us, wi nor go-go, bikos di man sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda kom.’ ”
5 se, porém, não o enviares, não desceremos; pois o homem nos disse: Não me vereis o rosto, se o vosso irmão não vier convosco.
6 So Israel sey, “Wetin make una kause dis wahala wen una tell di man sey una get anoda broda?”
6 Disse-lhes Israel: Por que me fizestes esse mal, dando a saber àquele homem que tínheis outro irmão?
7 Dem ansa, “Di man ask us kweshon well-well about wi and awa family sey, ‘Una papa still dey alive? Una get anoda broda? So wi ansa am like dat.’ How wi won take know sey e go sey, ‘Make una bring una broda kom’?”
7 Responderam eles: O homem nos perguntou particularmente por nós e pela nossa parentela, dizendo: Vive ainda vosso pai? Tendes outro irmão? Respondemos-lhe segundo as suas palavras. Acaso, poderíamos adivinhar que haveria de dizer: Trazei vosso irmão?
8 Den Judah tell en papa Israel sey, “Make yu allow di boy follow mi and wi go-go togeda. Den wi go dey alive and wi nor go die, both wi, yu and awa shidren.
8 Com isto disse Judá a Israel, seu pai: Envia o jovem comigo, e nos levantaremos e iremos; para que vivamos e não morramos, nem nós, nem tu, nem os nossos filhinhos.
9 Mi mysef dey swear sey e go dey save; make yu hold mi if e nor kom back.
9 Eu serei responsável por ele, da minha mão o requererás; se eu to não trouxer e não to puser à presença, serei culpado para contigo para sempre.
10 And if nor bi all dis story, wi for don go der kom back like two times naw!”
10 Se não nos tivéssemos demorado já estaríamos, com certeza, de volta segunda vez.
11 Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.
11 Respondeu-lhes Israel, seu pai: Se é tal, fazei, pois, isto: tomai do mais precioso desta terra nos sacos para o mantimento e levai de presente a esse homem: um pouco de bálsamo e um pouco de mel, arômatas e mirra, nozes de pistácia e amêndoas;
12 Make una take many money follow body; una must return dat money wey una si for una bag, bikos e if bi sey dem dey try una.
12 levai também dinheiro em dobro; e o dinheiro restituído na boca dos sacos de cereal, tornai a levá-lo convosco; pode bem ser que fosse engano.
13 Naw, make una karry Benjamin una broda and make una dey go.
13 Levai também vosso irmão, levantai-vos e voltai àquele homem.
14 Make di God wey get pawa give una mesi for di man front, so dat e go release Simeon and Benjamin! But for mi, if I luz my shidren, I luz dem bi dat.”
14 Deus Todo-Poderoso vos dê misericórdia perante o homem, para que vos restitua o vosso outro irmão e deixe vir Benjamim. Quanto a mim, se eu perder os filhos, sem filhos ficarei.
15 So dem take di gift, karry doubol money kon take Benjamin follow body. Den dem rush go Egypt kon stand for Josef front.
15 Tomaram, pois, os homens os presentes, o dinheiro em dobro e a Benjamim; levantaram-se, desceram ao Egito e se apresentaram perante José.
16 Wen Josef si Benjamin with dem, e kon tell en savant wey dey kare for en house, “Make yu take dis men go my house, den make yu kill one animal kon kook am, bikos dis men go chop with mi dis aftanoon.”
16 Vendo José a Benjamim com eles, disse ao despenseiro de sua casa: Leva estes homens para casa, mata reses e prepara tudo; pois estes homens comerão comigo ao meio-dia.
17 Di man do just as Josef tell am; e take di men go Josef house.
17 Fez ele como José lhe ordenara e levou os homens para a casa de José.
18 But di men kon dey fear wen dem take dem enter Josef house. Dem kon sey, “Dem bring us kom here, bikos of dat money wey wi si for awa sak dat time. E won katch us, turn us to en slave kon take awa donkey!”
18 Os homens tiveram medo, porque foram levados à casa de José; e diziam: É por causa do dinheiro que da outra vez voltou nos sacos de cereal, para nos acusar e arremeter contra nós, escravizar-nos e tomar nossos jumentos.
19 So dem go meet di man wey dey kare for Josef house kon follow am tok for di door-mot.
19 E se chegaram ao mordomo da casa de José, e lhe falaram à porta,
20 Dem tell am, “My oga, wi really kon buy food di first time.
20 e disseram: Ai! Senhor meu, já uma vez descemos a comprar mantimento;
21 But wen wi rish where wi won for sleep dat nite, wi open awa sak and all of us si awa money; dat is di whole money for inside di sak. So wi don riton am.
21 quando chegamos à estalagem, abrindo os sacos de cereal, eis que o dinheiro de cada um estava na boca do saco de cereal, nosso dinheiro intacto; tornamos a trazê-lo conosco.
22 Wi still bring xtra money wey wi go take buy food. Wi nor know who put di money dem for awa sak!”
22 Trouxemos também outro dinheiro conosco, para comprar mantimento; não sabemos quem tenha posto o nosso dinheiro nos sacos de cereal.
23 Di man kon tell Josef brodas sey, “Make una nor fear, evritin dey okay. Una God and una papa God don give una gift for una sak. Na mi put di money.” Den e bring Simeon kom out from prison.
23 Ele disse: Paz seja convosco, não temais; o vosso Deus, e o Deus de vosso pai, vos deu tesouro nos sacos de cereal; o vosso dinheiro me chegou a mim. E lhes trouxe fora a Simeão.
24 Di man kon take dem enter Josef house. E give dem wota and dem kon wosh dia legs. Den e give dia donkey food chop.
24 Depois, levou o mordomo aqueles homens à casa de José e lhes deu água, e eles lavaram os pés; também deu ração aos seus jumentos.
25 Josef brodas kon keep dia gifts dey wait make Josef kom for aftanoon, bikos dem don tell dem sey dem won chop with am.
25 Então, prepararam o presente, para quando José viesse ao meio-dia; pois ouviram que ali haviam de comer.
26 Wen Josef enter di house, dem kon gi-am dia gift and dem bow face groun for en front.
26 Chegando José a casa, trouxeram-lhe para dentro o presente que tinham em mãos; e prostraram-se perante ele até à terra.
27 E ask dem how dem dey. Den e sey, “Una papa dey okay, di one wey una tok about? E still dey alive?”
27 Ele lhes perguntou pelo seu bem-estar e disse: Vosso pai, o ancião de quem me falastes, vai bem? Ainda vive?
28 Dem kon ansa, “Yor savant wey bi awa papa dey okay and e still dey alive.” Den dem bow to show respet.
28 Responderam: Vai bem o teu servo, nosso pai vive ainda; e abaixaram a cabeça e prostraram-se.
29 Wen Josef look up kon si en broda Benjamin, en mama pikin, e kon sey, “Na dis boy bi una yonga broda wey una tell mi about?” Den e sey, “My son, make God always dey good to yu.”
29 Levantando José os olhos, viu a Benjamim, seu irmão, filho de sua mãe, e disse: É este o vosso irmão mais novo, de quem me falastes? E acrescentou: Deus te conceda graça, meu filho.
30 Josef rush go outside, bikos e nor fit bear as e dey si en brodas and e don nearly won kry. So e go en room kon kry well-well for der.
30 José se apressou e procurou onde chorar, porque se movera no seu íntimo, para com seu irmão; entrou na câmara e chorou ali.
31 Den e wosh en face kon kom out. With strong mind, e kon sey, “Make una arrange di food.”
31 Depois, lavou o rosto e saiu; conteve-se e disse: Servi a refeição.
32 Dem arrange one place for am, anoda place for en brodas and anoda place for di Egypt pipol wey won chop with am. (Dis na bikos, Egypt pipol nor dey chop with Hibru pipol, bikos Egypt pipol bilive sey e nor good to chop with Hibru pipol.)
32 Serviram-lhe a ele à parte, e a eles também à parte, e à parte aos egípcios que comiam com ele; porque aos egípcios não lhes era lícito comer pão com os hebreus, porquanto é isso abominação para os egípcios.
33 Dem sidan for en front as dem take born dem; from di first-born go rish di last born. Di men kon dey sopraiz dey look demsef.
33 E assentaram-se diante dele, o primogênito segundo a sua primogenitura e o mais novo segundo a sua menoridade; disto os homens se maravilhavam entre si.
34 E give dem part for di food wey dem gi-am, but di one wey e give Benjamin, big pass dia own five times. Dem chop and drink with Josef until drink kon katch dem.
34 Então, lhes apresentou as porções que estavam diante dele; a porção de Benjamim era cinco vezes mais do que a de qualquer deles. E eles beberam e se regalaram com ele.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 43, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.